Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,073 members, 7,814,710 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 06:00 PM

Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? - Culture (6) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? (20403 Views)

Some Interesting Nigerian Proverbs With Pictures / Proverbs From The Streets Of Warri / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (Reply) (Go Down)

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Lookingback: 3:20pm On Jun 22, 2023
Greattha:
As e dey sweet us, e dey pain dem.Now na all of una e dey pain

Dorime no be for salary earner.

See as e be like fawo wey rain beat.

When breeze blow, fawo yansh go open

Chop alone, die alone.

Hu get head no get cap, hu get cap no get head

At all at all na winsh

Bro this one enter wella.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Bigseven(m): 3:26pm On Jun 22, 2023
No matter how preeq strong e no fit be bone

3 Likes 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by lieutenantprime(m): 3:26pm On Jun 22, 2023
ElValiente:
Widow wey get big yarsh, elders no dey waste time bury her husband.

This one hold water o ElValiente
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by tunchi014(m): 3:30pm On Jun 22, 2023
No be eye wey dem take chop eba them take dey share meat.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Lookingback: 3:31pm On Jun 22, 2023
TheEndless:

Toto wey nor sweet na him dem dey use condom fvck🙄

I heard this at a bar in Asaba , the DJ was rapping it.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by lieutenantprime(m): 3:34pm On Jun 22, 2023
Ogunleti01:
A wise man wey die for the backyard of a foolish man; e get as e be



Orlando Owoh: E Get As E Be
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Exceed15: 3:36pm On Jun 22, 2023
Person wey naked no dey put hand for pocket

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Kendrick80(m): 3:36pm On Jun 22, 2023
Naked person no dey put hand for pocket.

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by gibsonwales(m): 3:37pm On Jun 22, 2023
Dem no deh use blokoss (scrotum) test cutlass medicine grin

4 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Cas1741: 3:38pm On Jun 22, 2023
A head hunter no dey allow person touch him head.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Exceed15: 3:40pm On Jun 22, 2023
PerfectStranger:


Otilo

Looool... Dis guy , u no go mak heaven walahi.. lol

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Exceed15: 3:42pm On Jun 22, 2023
Borrow borrow mak me fine
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by ibawon(m): 3:46pm On Jun 22, 2023
Na man wey dey reason dey scratch bear bear
I no fit fear Toto F**k Yansh
Damini Ogulu

3 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Peacecore: 3:49pm On Jun 22, 2023
No bi who fess call police dey win case
Na I too sabi make monkey break leg
Son wey talk say e fess him papa get son na who burn am?
No bi who fess mad be Senior mad man na who mad pass

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by KennyLenz(m): 3:51pm On Jun 22, 2023
grin grin grin
donbachi:
Pikin wey dey suck breast,no know sey milk cost.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Justme2911(m): 3:57pm On Jun 22, 2023
Na who pass exam know book!

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Nmezor(f): 4:02pm On Jun 22, 2023
Na condition make Crayfish bend

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by dadabryth: 4:03pm On Jun 22, 2023
Pikin wey say im mama no go sleep, him self no go see eye with sleep.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by son4century(m): 4:06pm On Jun 22, 2023
This one fine, this one fine, na hin dey make madman carry plenty trash

4 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by simonfynboi(m): 4:09pm On Jun 22, 2023
- This one fine, that one fine naim make Nkechi carry belle grin

- If Amaka no disappoint na belle she for don carry cheesy

- Make i taste, make i taste naim cause podging cheesy

- Person wey sleep for raining season na dry season go wake am cry

- Person wey quite na for him mind him de talk.. sad

- Nothing concern fulani concern shop rite, naim cow be domino pizza cheesy

- Person wey de bleach no need take coke n fanta... grin

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Emdebby2: 4:17pm On Jun 22, 2023
Pikin wey say im mama no go sleep, he too no go sleep.

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by CirocBoi(m): 4:28pm On Jun 22, 2023
This one good that one good na so craze man take pack dirty full house

3 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by SayNo2SmallPrik: 4:33pm On Jun 22, 2023
who never sit down no Dey lap person

1 Like 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by SayNo2SmallPrik: 4:35pm On Jun 22, 2023
Do me this, do me that, na so 5million take remain 200k

3 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by jevic(m): 4:50pm On Jun 22, 2023
No be today nyash begin dey for back.

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Theo89(m): 4:58pm On Jun 22, 2023
Wahala be like Bicycle, e no dey hard to start.

Fowl dey sweat na feather dey cover am.

Breeze blow fowl yarnsh open.

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by hohafrank(m): 5:01pm On Jun 22, 2023
Lizard wen fall down from iroko tree say if nobody praise am he go praise himself.

3 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by uwuana: 5:04pm On Jun 22, 2023
Sun too hot no mean say e fit boil beans

1 Like 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by uwuana: 5:11pm On Jun 22, 2023
Toad like water, but no be wen the water dey boil.

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by brightleave(m): 5:14pm On Jun 22, 2023
Mirror don break, eye go rest

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by uwuana: 5:15pm On Jun 22, 2023
No matter how long stone dey for inside water,e no fit turn to crocodile

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by brightleave(m): 5:15pm On Jun 22, 2023
Who naked no dey put hand for pocket

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (Reply)

Lets Know The Full Oriki Of Your Home Town.. / Why Do Nigerians Think White People Are Ugly? / Shocking Village That Eat Human Meat **pictures**

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.