Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,015 members, 7,817,992 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 02:24 AM

Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? - Culture (7) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? (20426 Views)

Some Interesting Nigerian Proverbs With Pictures / Proverbs From The Streets Of Warri / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (Reply) (Go Down)

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by brightleave(m): 5:17pm On Jun 22, 2023
E no get as hungry go beat melu reach when e go resemble goat.

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by uwuana: 5:19pm On Jun 22, 2023
Na pocket wey no get money, hand dey stay inside Tay.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by hizmail(m): 5:21pm On Jun 22, 2023
No food for lazy man but no be the one wey him mama get canteen

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by uwuana: 5:23pm On Jun 22, 2023
No be by size of Head dem take dey rate wisdom

2 Likes 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Emeskhalifa(m): 5:23pm On Jun 22, 2023
Wahala for those ajebortta wey no sabi pidgin cheesy

3 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by uwuana: 5:25pm On Jun 22, 2023
No be everybody wey get big chest dey gym, some dey carry pesin put for mind

5 Likes 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by KvngDavidIV(m): 5:30pm On Jun 22, 2023
Breeze blow Fowl yansh open 😂




Waka wey you waka for night, We go see the result for morning

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by dayleke: 5:36pm On Jun 22, 2023
b0rn2fuck:
Prick dey argue, toto dey argue, na bed go settle their matter

Okoh n leri, oboh n leri, ipade dori beedi lale. 😁😜

2 Likes 2 Shares

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by oluwoleife: 5:48pm On Jun 22, 2023
First to do no dey pain

4 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Apili: 5:55pm On Jun 22, 2023
Na small small t*t* take dey wide

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by LatentEnergy007: 6:12pm On Jun 22, 2023
Pikin wey no know the value of Toto na dey pack sand inside am.

Man wey get one eye no dey play with sand.

Rice wey dey under pot go dey top for inside cooler

Na because fence fall make goat fit climb am.

If no be waist pain, wetin be dance

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Rumobaba: 6:21pm On Jun 22, 2023
No be the way Dem they drink water, Dem they drink peper soup.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by shonepa(m): 6:28pm On Jun 22, 2023
If u use ur candle light my own, no mean say ur candle go off.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Aklee4994(m): 6:43pm On Jun 22, 2023
This man no get money that man no get money Na him make Sandra still Dey him papa house

2 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Bahamas95(m): 6:50pm On Jun 22, 2023
* Dem nor dey use pr!ck threaten a$hawo.

* No matter how agama lizard 🦎 do press up e nor go get big chest like alligator 🐊.

* Man wey marry woman with big breasts nor suppose buy pillow.

2 Likes 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Businesssence01(m): 6:54pm On Jun 22, 2023
Sun hot, sun hot; no mean say fowl go lay boiled egg

1 Like 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Inicharles: 7:12pm On Jun 22, 2023
Olowoshako:
Dem no they slim fit borrowed clothes?
pikin wet dey look for waiting kill him father,las las na that same thing go kill am

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by stampo: 7:12pm On Jun 22, 2023
1. No be mouth wey them take borrow money Dem dey take pay back.

2. Wetin happen for fowl house go happen for goat house.

3. Them no dey tell blind man say war don start.
4. Na for everybody zinc rain dey fall put o.

5. I don see 99, 100 na nothing.

6. Life na per Head.

7. Every hot water must cool down.

8. Na cooperation make rice full pot.

9. E no get as e go be, stamara must call him papa name.

10. Them dey count meat for pot, kpomo dey raise hand up.

11. Person wey them pray for, e never still better for am, e come be who Dem swear for ?


Them plenty..... make una just hold these ones

3 Likes

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Thatsammie(m): 7:17pm On Jun 22, 2023
Monkey sabi jump na because tree near each other.

1 Like 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by olamilekan9(m): 7:24pm On Jun 22, 2023
ashawo no suppose fear big preek,shebi na her hustle 😎
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Inzaghi44(m): 7:25pm On Jun 22, 2023
I Waka well no be restaurant.

No be every bus wey de go mile 2 u de enter.

U no fit shit with out pissing.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by noyd911(m): 7:34pm On Jun 22, 2023
Tinububalls:
And I didn't see the famous quote of them all
Na condition make carryfish bend.


I think the famous of it all is " e no good e no good e dey help"
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Toscobebo2: 7:36pm On Jun 22, 2023
Person wey borrow shirt no dey follow separate fight.
Na only okada man fit carry him girl friend pass front of hin house wey hin children and wife go dey tell am daddy daddy bye bye.
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by daddy001: 7:43pm On Jun 22, 2023
No matter the amount of press up wey agama lizard do, e no fit get chest pass crocodile.

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Snakedoctor1: 7:54pm On Jun 22, 2023
Olowoshako:
Dem no they slim fit borrowed clothes?

Man wey open eye dey take teeth draw shaki for pepper soup, that man no get fear

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by ufuosman(m): 8:09pm On Jun 22, 2023
Zonefree:
Woman wey dey look for pikin no dey wear pant sleep for night.
👍🏽👍🏽👍🏽👍🏽
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by Raymeskey: 8:14pm On Jun 22, 2023
👉Book wey no gree enter head go enter
exam hall
👉 Person wey dem carry no dey carry person
👉 Ground wey soft na im fowl dey dig
👉 Kettle dey call pot black
👉 One day one day monkey go go market e
no go come back
👉 Snake hand and leg dey inside am
👉 Pikin wey no gree serve him parent go serve government
👉 Na once dem dey hit sturbon goat
👉 Goat were dey eat maize no dey shout
👉 This one fine, this one fine na em make mad man load dey plenty
👉 Pikin dey insult iroko dey look back
👉 House wey collapse no dey kii one person
👉 No matter how tall okro tree be, e no fit tall pass the owner
👉 No be to follow who know road you get the power?
👉 Use your sense before them use you.
👉 Hand wey enter hole na em snake dey bite

1 Like 1 Share

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by ufuosman(m): 8:18pm On Jun 22, 2023
E go better na poor man prayer

1 Like

Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by phemmyfour: 8:26pm On Jun 22, 2023
Olowoshako:
Dem no they slim fit borrowed clothes?
pesin wey don die no dey chop breakfast

Celebrate me.....now wey I dey alive
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by ashawopikin(m): 8:27pm On Jun 22, 2023
Toto water no plenty, but e reach prick take baff
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by NACE13: 8:39pm On Jun 22, 2023
I saw these on my colleague's status;

"Stone wey you hold for hand naim be your friend but once you throw am up, e go deny you".

"You no fit wish for wetin you get for house already".

"No matter your societal status and power, rain go still beat you, if e catch you".

"Na too much skills dey make monkey fall from tree".

"Dem no dey use power kill mosquito wey land ontop blockos" grin

This just popped into my head when I was narrating an experience to my colleague :
"Woman wey wear short skirt no dey jump gutter/ride bicycle".

smiley
Re: Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? by VicM6: 8:49pm On Jun 22, 2023
person no dey put hand for tortoise yansh to know if the yansh dey smell or not.

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (Reply)

Why Do Nigerians Think White People Are Ugly? / Lets Know The Full Oriki Of Your Home Town.. / We, Not Ajimobi Govt, Suspended Your Salary – Ibadan High Chiefs Tell Olubadan

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 24
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.