₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,064 members, 8,429,208 topics. Date: Thursday, 18 June 2026 at 03:04 PM

Toggle theme

Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi - Literature (43) - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentLiteratureSex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi (336085 Views)

1 2 3 ... 40 41 42 43 44 45 46 ... 51 Reply (Go Down)

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op):
sex na FOOD written by youngzubi

Episode...........51 written by youngzubi


Nobi the End,life Must Turn Around
-------------------- --------------------




Two police officer match inside immediately big mama waka comot,the two police dress in nigerian police uniform,for wia i lay down i fit see the keys wey one of them hold for hand,from no wia better smile just enter my face,nobi sey i dey happy but as nah only two policemen dem send come release me from the bed,i turn look the window,then i relax as those police men bend Down begin unlock the chains wey bin dey hold me since,maybe nah prison dem won carry me go,i begin wonder,


i just hate my sef onto sey i underestimate the two policemen,becos as i won jab up wen dem free my hand,the kind slap wey jam me eh!,i begin blink my eye as i nor fit see even the window again,dem expertically seize me up as dem handcuff my hand and legs,the handcuffs wey den put for my leg limited my pace,so i nor fit stretch my leg go far talkless of running,infact as i stand with the small pain wey i dey feel for my legs nah still the policemen support me as we begin match go outside 


i tear mouth open in surprise immediately we step outside,the kind police wey surround the whole hospital,i look outside the gate from the hospital entrance wia i stand,nah three police van park outside,then for my front nah cameras,different tv stations,dem begin drag dey struggle to come forward meet me wit dia microphones,like sey i be president police people begin pursue dem, they begin clear road for me as i just dey turn from one direction to another trying to hide from dia stupid camera,i begin thank God as oga frank bounce outside nahim all the journalist rush go meet him,im begin yan wit dem as plenty microphones and mobile phone full im front


"move!!,the police yan

as nah hospital clothe i wear,i begin wonder if i still wear boxer sef,i nor fit touch any part of my body as the handcuffs just seize me up from making some certain movements,we pass the gate nahim four young police officer salute the two wey bin dey drag me as dem open one van,dem force me inside as the two police wey bin dey drag me sidon for my two sides

"una forget to chain my mouth o!,i yan looking the police officer,but dem just bone face dey look front,e just be as if nah tree i dey follow yan as dem just focus

one van wey police people full first move before,the one wey carry me follow am as another one follow us for back nahim we begin go wia i nor know

"bros!,i yan looking at the one wey sidon for my right hand side

"bros!!, bros! bro

"shut up!,the police yan

"at least answer me nah,i be ya fellow nigerian,abeg nah wia we dey go?,sheh nah una station abi una office wich one eh! bros?

"bros, i for continue dey shout "bros"but the idiot bros shuk hand inside im back pocket comot pliers

"if i hear peem! you go hear weee!,try me!!,the police guy yan holding a pliers 


nobi peson yan me sey make i kukuma be a good guy,i silent die!,person fit hear my heart beat sef,each minute i go turn look whether the bros don drop the pliers but lie lie!, the guy turn am into handkerchief sef as nah the pliers im dey use comot sweat wey dey gather for im forehead 


hours later we arrive for front of one long station like that,the place long die,as fence surround the whole place,police people stand for all the road till we reach the gate,nah still police people stand for the gate,sharpaly dem open the gate as we drive enter the compound,the moto park as those police people jump down from dia moto carry gun come surround our own moto, then the two police wey dey sidon wit me open door comot,jejely i shuk head outside and waka go down


"why una still dey point me that rubbish after una done chain all my body,

"move!!!

"i swallow spit as i begin follow dia lead



i begin look the environment, omo i no need make peson tell me sey nah prison i dey so,i begin see different small and long building every wia,some small building get ties for im front maybe nah office,but all the long building nah grass full im side with small small hole wey dey serve as window ontop the walls,no window at all


i sight some guys with rough hairs,some get bushy beads as all of dem wear yellow overall,i just dey survey the whole compound,till we enter one room abi hall,the place dey smell die nahim those police men yan me sey make i standstill 

dem begin comot all my clothes then one man carry scissors step forward,i begin pray ontop my spana head,i begin pray sey e no go be my preek dem won chop comot so,the man near me but nobi my preek im grab instead nah my afro hair im begin chop off with the scissors,i breath come down,afterall my hair fit grow back but spana lie lie!!

(note! this story is written by youngzubi,join his fb group..youngzubi stories For more interesting stories,add him up on fb:young zubi Desmond)


after dem don cut my hair finish,i begin imagine how my head go take be,i begin imagine the shape wey my head go dey now,nahim i begin look around maybe i go fit see mirror but nah one man wey carry yellow overall i see,the man carry the cloth give me naso i wear am,i happy sey nothing hook me again,but i dey 100% sure sey i no fit run abi escape from here lie lie!,police full every corner 


dem drag me enter one office like that,the fat man wey sidon inside dia carry one file come out,im begin write things down dem carry my picture,thumprint wit all the questions and information wey dem gather before another officer finally come drag me begin go the long hall


Chai naso i take enter prison,i just dey wonder as we shuk head inside the place,nah long passage tear the long hall into two half,cells dey the both sides as prisoners full every wia,i begin see different kind of apko-bi,i sight guys wey get muscle die,while some be like thread,all of dem begin make noise as dem sight me,some begin jam dia hand for the iron protector wey dem use close the place

we continue walking inside the passage till we reach the middle,i look inside the place but e be like sey nah only that one empty,so dem push me inside and luck am tight,


i stand begin watch as the police men turn begin go,i just rest my chest for the iron dey look till peson tap me for back,i jab up instanta turn as my head jam one tall giant for chest 

i think sey nah only me dey inside that particular cell,i carry head up look the huge guy,the guy nah tall giant as nah for chest i dey reach am,the whole prison turn silent as everybody begin watch us from dia own cell,

"i move back and face the guy as im too face me dey look me face to face


bow for the boss! you this bushitt!!!!,im macho voice echo for the whole prison as every body begin hail am dey shout

"boss!! boss!! boss!!

"shut up and bow!!!,the guy yan

i look as most of the prisoners dem keep qa-yet begin bow dia head one by one


i still dey try understand watin dey happen but i sight my sef flying up nahim i jam wall gboo!! then land for ground gbosaa!!!! "ahhh!!! i scream


hhheeeeeeeyyy!!!!! boss!! boss!!! boss!! the prisoners begin hail the giant guy again


i try stand up but better pain waya me for leg"ahhh!!! i shout and kneel down as vex full my body tears begin blind me as my eye turn reddish 


"stand back!!!! i shout as the giant begin waka come meet me again


(note! this story is written by youngzubi,join his fb group..youngzubi stories For more interesting stories,add him up on fb:young zubi Desmond)

to be continued.......
5 Likes 1 Share
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Freeman50(m):
Young man, have been following you up from onset. To be frank your story line is of standard.

Am impressed.

keep it up youngzubi.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 2:06pm On Sep 03, 2018
Olivers2J:
Beautiful write-up Youngzubi
thank you dearest....
1 Like
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pradoic(m): 2:14pm On Sep 03, 2018
wow! wow! wow!!
this is the only story that really got me glued in nl literature section
well don my man youngzubi
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Ann2012(f): 2:27pm On Sep 03, 2018
Thanks for the update Bro
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Enny2013(f): 2:38pm On Sep 03, 2018
Spats is such a bad frnd o....chai!!! Ride on Youngzubi
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pgodson7(m): 3:06pm On Sep 03, 2018
nice twist to the story
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Deyoungne: 3:07pm On Sep 03, 2018
na wow hmmmm
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by christheair(m): 3:12pm On Sep 03, 2018
I think say Spana fit change to im devil Syd sometimes when the story been de begin Oga YoungZubi undecided undecided. Baba wetin come do that side of him nah cry cry.

Nyc story shaa. We die here grin
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Iamicekid(m): 3:58pm On Sep 03, 2018
Damn man, you are just too good... Kudos
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Kelblaq(m): 5:18pm On Sep 03, 2018
Spana in Jailhuh

Wahala for problem undecided
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by legendspeakout: 6:58pm On Sep 03, 2018
christheair:
I think say Spana fit change to im devil Syd sometimes when the story been de begin Oga YoungZubi undecided undecided. Baba wetin come do that side of him nah cry cry.

Nyc story shaa. We die here grin
We live here, admin when is the red mode going to active...well done bro , i dey feel ya detailed explanation.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Jacqueline22(f): 7:27pm On Sep 03, 2018
Wow I love this keep it up bro
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Nobody: 9:52pm On Sep 03, 2018
I feel for Spana right now cry
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 10:58pm On Sep 03, 2018
Freeman50:
Young man, have been following you up from onset. To be frank your story line is of standard.

Am impressed.

keep it up youngzubi.
thank you smiley
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 11:01pm On Sep 03, 2018
christheair:
I think say Spana fit change to im devil Syd sometimes when the story been de begin Oga YoungZubi undecided undecided. Baba wetin come do that side of him nah cry cry.

Nyc story shaa. We die here grin
read the last part well,i have finally decided to showcase that his talent small

we die here! grin


still ur guy youngzubi
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 11:03pm On Sep 03, 2018
Ann2012:
Thanks for the update Bro
welcome back Ann....
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 11:04pm On Sep 03, 2018
Iamicekid:
Damn man, you are just too good... Kudos
thank u my man....
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 11:05pm On Sep 03, 2018
pradoic:
wow! wow! wow!!
this is the only story that really got me glued in nl literature section
well don my man youngzubi
brother from another mother.....
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by donaldphilipizu(m): 11:11pm On Sep 03, 2018
weldne,,,, spana. more ink brotherly
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by christheair(m): 9:36am On Sep 04, 2018
Youngzubi:
read the last part well,i have finally decided to showcase that his talent small

we die here! grin


still ur guy youngzubi
Correct bro. I know say u no fit fall hand nah... Ride de go jare, no go slow grin embarassed
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by efeteb: 10:39am On Sep 04, 2018
Anybody wey read dis your story and no gree comment nor get conscience. Oga you be Don. I carry my left yansh for you.


Thanks for the frequency of your update
Signed
Oliver Twist
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by okafor200(m): 11:56am On Sep 04, 2018
efeteb:
Anybody wey read dis your story and no gree comment nor get conscience. Oga you be Don. I carry my left yansh for you.


Thanks for the frequency of your update
Signed
Oliver Twist
hahaahahahaa
baba left yansh
efeteb u for sweet for yabbing o
but i go respect my self here

just won hail my baba yougzubi
august 5k winnercheesy

e no really easy o
keep up the good work
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by paprika212(f): 12:34pm On Sep 04, 2018
I wish I can give you a recognised trophy, you are too much
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by okafor200(m): 12:39pm On Sep 04, 2018
paprika212:
I wish I can give you a recognised trophy, you are too much
the only trophy i know my guy will accept is just to give him
paprika

baba go grab am shine teethcheesy

baba olowo the long prick
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by dannytech2uni: 3:59pm On Sep 04, 2018
Youngzubi come upload Na... Iv been reloading my page since... I go cry ooo
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by okafor200(m): 4:10pm On Sep 04, 2018
dannytech2uni:
Youngzubi come upload Na... Iv been reloading my page since... I go cry ooo
see come o
no cry here o

na devilmaycry u be?cheesy

abeg just focus go buy me bread come make we chop
because me i carry beans 2000 naira come here con chopcheesy

baba olowo the long prick
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by ejerukeuzezi(m): 4:42pm On Sep 04, 2018
baba youngzubi u are good and loaded my bro
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 6:12pm On Sep 04, 2018
............
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 6:13pm On Sep 04, 2018
sorry i wont be dropping update today

i was kinda stressed today in my place of work,as my boss didnt wonna leave,so i was just peeping here and there in nairaland,update will drop hopefully by tomorrow

but for the meantime you can just take a minute of your time to quickly go and vote for me on Facebook ,thanks for your understanding "STILL YOUR GUY YOUNGZUBI "YAGI!!!!"



kindly click on the link to vote for me on facebook by commenting..and like my own short story,remember the writer with the highest likes andcomments wins the award so brothers and sisters support youngzubi,help me win the award by clicking on the link below,mention your Facebook friends to mention their own friends,together we can do it!!!!,,ghost readers you can also participate just click on the link,or you search "boldscholar" on ur fb search scroll down to the one of Desmond nona,like,comment and mention your friendsGod bless u as u do do,happy new month
click here!
https://mobile.facebook.com/story.php?story_fbid=498512433955386&id=3
1 Like
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by paprika212(f): 6:23pm On Sep 04, 2018
okafor200:
the only trophy i know my guy will accept is just to give him paprika
baba go grab am shine teethcheesy
baba olowo the long prick
hahahahaha May God forgive u
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by paprika212(f): 6:34pm On Sep 04, 2018
okafor200:
the only trophy i know my guy will accept is just to give him paprika
baba go grab am shine teethcheesy
baba olowo the long prick
bad shild (in jenifa's voice)
1 2 3 ... 40 41 42 43 44 45 46 ... 51 Reply

Life Of A Rugged Guy +21Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By YoungzubiI Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi234

[story] My Life As A Yahoo Boy1985.... 1987.... 2014--[a Crime Story]Twine (A Drama Series)