Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,026 members, 7,799,510 topics. Date: Tuesday, 16 April 2024 at 11:01 PM

Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi - Literature (50) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi (314964 Views)

Life Of A Rugged Guy +21 / Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi / I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (47) (48) (49) (50) (51) (Reply) (Go Down)

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by samuel19222(m): 11:36am On Sep 20, 2018
UpdatesiOS147:
Spana forget matter you na solid material you go fight for your freedom one thing must kill a man at a time you don know your enemies moreover keep your friends close and your enemies closer I know say you b wise you will scale through cry for one is cry for all I dey feel your yarninsh bros nothing shake your mental


Bros, couple ya yarnish na, 17 dey background, color Jew sef dey background.

1 Like

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 11:53am On Sep 23, 2018
wink cool
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by lakkyflow(m): 4:57pm On Oct 09, 2018
Not only you are a writer but also a good comedian...I remembered reading your story and was laughing seriously that people was looking how could a man be laughing like this ... At your age ,few of us here have achieved what you did .... kudos Bro ..
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 5:57pm On Oct 09, 2018
lakkyflow:
Not only you are a writer but also a good comedian...I remembered reading your story and was laughing seriously that people was looking how could a man be laughing like this ... At your age ,few of us here have achieved what you did .... kudos Bro ..

Thanks my man
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Estellar: 10:02am On Oct 11, 2018
Youngzubi:
ATTENTION!! PLEASE

I need everybody to make his or her choice here


SHOULD I WRITE SEASON 2 IN ENGLISH OR I SHOULD CONTINUE WITH THE PIDGIN


DROP YOUR CHOICE BELOW,YOUR CHOICE DETERMINE WHETHER IT WILL BE WRITTEN IN ENGLISH OR PIDGEN


thank you all for your encouraging comments so far,and for those who are impatiently waiting for season 2 without dropping any comment,just go fin stone touch it to see how strong your heart is!.....

still your guy youngzubi
Biko, pidgin o!
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Tgold1(m): 10:32am On Oct 12, 2018
Youngzubi


You too bambella....

BTW, the tori neva finish p, coz no sinner go unpunished, make e no be like say u dey promote crime and violence.... U need to update the concluding part

1 Like

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Tgold1(m): 10:33am On Oct 12, 2018
Youngzubi


You too bambella....

BTW, the tori neva finish p, coz no sinner go unpunished, make e no be like say u dey promote crime and violence.... U need to update the concluding part...
Rgd you
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pradoic(m): 8:48am On Oct 16, 2018
grin gee
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by jawarareloaded(m): 10:52am On Oct 17, 2018
email : youngzubi@gmail.com

I av already mail on the � mail address about the remaining episodes but am yet to receive your message. here is my mail adebaredauda@gmail.com
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:42pm On Oct 19, 2018
Ok,i already reinstall all the episodes
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:42pm On Oct 19, 2018
jawarareloaded:
email : youngzubi@gmail.com

I av already mail on the � mail address about the remaining episodes but am yet to receive your message. here is my mail adebaredauda@gmail.com


I have reinstall all the episodes
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by beborena: 12:50pm On Oct 25, 2018
swiz123:



swiz123 i use this medium to thank u for the mistakes which u pointed out,i worked on this update with reference to those mistakes u pointed out,as a writer i totally understood ur point thank u once again for the love,please do read the update and give me a feedback also point out any other area u felt i should work on thank u






jah bless!!!!!!!!
@ youngzubi

Your narrative is getting better and more realistic. However, you must improve your descriptive ability.

Starting from your characters, your readers can't even tell what they look like. You've never given any detailed description of any of them. I think big mama needs one.

Buying that duplex is your biggest achievement so far; yet, you couldn't even spare a paragraph to describe what the duplex looks like.

A writer's ability to give detailed description makes him stand out. I sincerely hope you improve on that.

Lastly, if you want to contract the words 'you are ', the correct way to write it is : 'you're'. As a writer, using "u'er' undermines your ability. Never make such 'cheap' mistake again.





LMAO, swiz I pray you become great,. Obviously you're just hating on youngzubi. We both know being descriptive in a narrative twists the plot... Youngzubi is a genius, admit it .
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 6:08pm On Oct 25, 2018
beborena:






LMAO, swiz I pray you become great,. Obviously you're just hating on youngzubi. We both know being descriptive in a narrative twists the plot... Youngzubi is a genius, admit it .


Lol, he was only trying to point out what he felt is not in place, no hating bro


Thanks man, it seems you'er new in this thread
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by beborena: 7:41am On Oct 26, 2018
Youngzubi:



Lol, he was only trying to point out what he felt is not in place, no hating bro


Thanks man, it seems you'er new in this thread


I was a ghost reader but here ghosts don't drop comments
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 8:50am On Oct 26, 2018
Ok, also join the other thread for season 2
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by manuelzz(m): 11:08am On Oct 26, 2018
Youngzubi:
Ok, also join the other thread for season 2

Which other thread ?
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 1:42pm On Oct 26, 2018
manuelzz:


Which other thread ?



Click on the link to read the season 2 although its still ongoing

https://www.nairaland.com/4723666/fit-second-jesus-sex-na
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 1:44pm On Oct 26, 2018
Hello incase you haven't seen the thread for season 2 of sex na food, here is the link to the story

Click on the link to join us for the better gbedu

https://www.nairaland.com/4723666/fit-second-jesus-sex-na
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by frankfab(m): 1:18pm On Nov 04, 2018
Youngzubi:
Episode……………..3
GBEDU!!!!!!
___________________
E SURE FOR ME
_____________________________
MEET MY NEIGHBOR
___________________________________





As I hear 150k, e come be like say na my account balance spata dey tell me,nahim I grab the bill comot for him hand, as I look am my drunkness clear fiaa for my eye
I come carry table water use wash my face wella dat one na to be sure say watin I dey see for the bill na true



Spata nah how much you talk say dem write inside this bill??…….na me ask



Na 150k nah……….spata yan


I swear to tear you slap jus dey hungry my hand,infact your village people don succed in geting you o!,dem jus dey use your brain dey test their new winchcraft……na watin I tell spata be dat

Because na 15k dem write for the bill, wia him go carry extra zero come join I no nor,mtcheew I don already tell una say na goat spata be ,dont worry I go yan una about him later nobi now,make I quickly go settle our bill becos night don land already



I waka go meet one attendant,nah dia I pay the 15000 naira,I for like make i carry one better babe dey go house o! But onto say I don tire for the day nahim make me reason that one as later things




Omo na drag I drag spata go house o!,the idiot don dey sleep naso him just dey talk rubbish as we dey go



We manage reach house naso I drop spata for ground comot my shoe and climb my fine new bed chai the bed soft well well ….no go think rubbish oo


PIifffff!!!!!! naso I sleep till next morning…





#########################


Saturday morning





I wake up for the following morning,look every wia but I no see spata,so I just do my normal morning exercise na watin I dey always do to keep fit.


I enter bathing room na dia I brush teeth and baff
The whole compound don already busy with children noise every wia onto say na Saturday no work no school



Ko! Ko! Ko!!!!


Peson knok for my door…….



Na only for naija peson go dey knok your door with hand and go still use him mouth dey shout ko ko ko join


Who dey diaa!!……I ask

Its me your neighbor……na man voice


Chai fvck up I been dey pray say make my neighbor be woman…


I near door as I open am…..


Goodmorning bro,I guess you are the new tenant right….the peson ask



Na who be this one wey come dey use grama to dey spoil my better morning eh??..na for my mind I dey reason dat one o!


The guy na very handsome guy too just my stature…….


Yes na, nah me how things na?….I ask am as we shake hand


Am good bro,Am sentino by name,a banker but I wont be going to work this morning becos am in the afternoon shift…….


Ehen! Ha you be rich guy na……na me be spana the letest rugged guy in town,tho I never get work onto say I just land but with time I go engage na!


Did you just say spana,hey dude thats a funny name you gat there……


Yes you free to begin laff if e funny
But guy I no dey like people wey dey speak too much English oo!


Oh oh! I see ,ok na I go see u leta in the day nah.i just say make I come greet you …..sentino said as him waka go


Me sef I waka go back enter kitchen,na that time I come remember say I never buy any food stuff put for house,chai I quickly carry my ATM card,lock my door naso i waka straight to bank


As I enter compound omo come see fine fine girls,me I nor dey look man na woman I dey always look….
Some of them dey greet me onto say I be new tenant while me I dey greet some onto say I go like introduce them to spana



i later waka enter street thank gawd sey bank no far from my house as e dey just across the road


i don almost reach main road o! Nahim I come see three aboki wey dey shine shoe chai una need to see argument


Aboki 1: walahyii I go schooo kwo na fur primly sikiss me I finish am….


Aboki 2 : furgate tha one I no say I no go zukul but me I zabi buuk pass you walayii


The third one just stand dey nack him box kpoi ! Kpoi ! Kpoi!! ,e be like say that one no dey speak broken at all becos him just. stand dial dey shine teeth…..


Aboki 1 : oya if u sabi book pass me wey go schoo watin dem dey kwall monkey for English


Aboki 2 : hahaha!!!! Hayii hayiii!!!! Walayi you dey maky me laff well well kwoo!!
monkey fur English na chimpiezy nah who no no dat one….


Aboki 1 :kai wo mana ...na gawd safe you say you get am , I fur laff you tire!!!!


Chai laugh no gree me laff wia I stand,I just kukuma cross road waka dey go bank…….


i don almost reach bank before I sight one fine Lexus like that wey park for front,one woman about 46+ waka come down as she carry her purse enter bank,but no be she i dey look,No e get one beautiful damsel wey seat down for passenger front seat omo the girl fine diee!!!



I just stand dey reason how I go take approach her befor her ma’le go come back

tho she suppose don reach 25 yrs old the way I take see her

but As a smart rugged guy wey I be,I nor say this one go sure for me so I gather mind waka go meet am


As I reach her side omo her beauty come increase no artificial makeup at all,but the problem come be how I go fit get her attention becos she put ear piece for ear close her eyes come dey sing you are my African queen by tuface idibia


Chai come see sweet voice ,infact I go make this one my girlfriend becos she complete pa!!


I try everything wey I fit do ,but this babe no gree open eyes e be like say the song dey enter her brain


I just vex tap am………
She shock as she quickly open eyes comot the ear piece sharpaly


Wow see beauty my heart mealt instanta,so I just smile ,my smile na electric shock to girls oo


Omo the way I take hear her accent she be ajebuta oo ,abeg una go permite me make I speak English small


Me: hi

She:hello….


Me: with my Charmin smile still on my face,it seems you love that song so much cos I been greeting you for a while now,am beginning to imagine what sort of song would make such a pretty girl like you to be soo carried away


Oh!! My gawd please forgive my mannars,I was actually practicing,I have a show to perform in this evening,so i was actually practicing ….she said giggling



Comfirm comfirm comfirm!, since e be say she like music and she dey perform too...e don settle na,the thing na to just apply law 919 coded,it mean say mesef I go pretend and lie for am say I be musician too so e go dey easier for me to toast her


Na so I come gather all the better lie from east north west and south tell am say me sef I be multinational instrumentalist,sey I fit play any kind of musical instrument………..

una need to see as the girl just happy she come open door com outside full

Wow you mean you can play music instruments very.well…..she ask


not just very well am a professional an expert for that……….I sweet mouth join


Wowwwww!!!!! Please can i have your contact please I would like you to come to my show this evening,even the state governor will be there,its a very big show please promise me you will be there…..she pleaded


Oh! Boy I tell una say I go make am for Lagos I tell una say I be baba for the girls chai if I fit make this one my babe e mean say I don turn rich man be that……

So we exchanged contact after I promised her that I will come to her show


Chai I rush enter bank go cash 30k nahim I use go buy food items put for house

Later in the day after I don chop sleep,watch TV sotey I come tire nahim I go carry wall clock hold for hand dey look time ……
Ooooo!!! make four nack nah




3;30 pkam I rush enter bathing room go baff after that nahim I come remember say I nor get any suit at all
Better idea enter my head so I quickly run go sentino house since him be banker e mean say suit go full every wia…
But as I nok na one fine babe like that wey wear bom short open door I guess na sentino girlfriend

chai the girl over make sense i Iook am sotey I come forget watin carry me come
She just close door as I no talk anything na look I just dey look am

Sentino later tie rapper come outside na den I comfirm say my bros dey do assignment


Bros thank gawd say you neffa go work oo….I greet


Abi na I for won go but my babe Maya just land from her mupsi side from katakata , so I decided to waya small nah!!


baddoo I dey feel you bros abeg you fit borrow me any of your well ironed suit
abeg e get one interview like that wey just surface

Chai sentino na sure guy as him carry one better suit gimme……

3:45 I don already dey road,e no tey before I reach the big gigantic hall wia the show hold omo no be small show be that oooo
Come see big big men car full every wia Chia to buy car come dey hungry me but na keke I take come sha
I enter hall after the bouncer grant me entrance when I show them the iv card wey the babe don gimme earlier
Every wia don full gbimm as I enter,every wia just dey smell rich rich

I stand dey look befor I sight her coming to wia I dey stand with better smile for her face…
She hug me as she reach wia I stand omo this babe too make sense pass Maya sef ..Chai e go sure for me oooo

She carry me go wia her Parents seat down
Nahim she come introduce me as her very good friend say I be multinational instrumentalist
Chai my head come dey swell as I shake hand with both him ma’le and pa'le dem

Him papa na rich man oo because na two bouncer and two soldier dey stand for him back as body guard…

The girl later carry me go another sit na for dia we sit down dey gist before the stupid MC come call her up for stage say make she come perform
She excuse her self as she waka go stage omo come see clapping

She carry microphone,,,,thank u thank u everybody am glad you all came this show ...this evenin i wont be perfoming alone ,there is a very good friend of mine who is an instrumentalist ,both of us will be doing it together to night I will do the singing while he would be playing the keyboard


Please ladies and gentle men help me to welcome YOUNGZUBI !!!!!!!!!!!!!

chai shiit catch me wia I sit down omo I don enter am today

I tell the girl say my name na youngzubi earlier base on say spana go dey local

People begin clap mesef I follow them dey clap infact na my own loud pass

She wait wait and wait for wia I nor even stand up
Nahim she come use her hand come drag me go stage

Omo I go seatdown for wia the key board dey nahim the girl come whisper for my ear say her voice dey for F key

Chai cold sweat catch me as I sitdown dey look the keyboard dey wonder why the white keys come long pass the black keys,how i won take see F keys for this plenty keys wey full every wia i wonder oo

Zubi start now …..she shout

Chai I don die oo!!for my life I never touch keyboard before but I gather mind press one key

Piaaaa!!!!!!!!,the whole speaker shout chai hot we we catch me instanta

I press black one

Poowwwww!!!!!!!!



Zubi be serious now stop playing with the key board….she talk


I come gather mind us all strength take press the whole keys both white and black together..
Chai una no go like hear the sound wey the thing make as my village people shout issa awa work oo!! for my head

the girl vex trowey mic and run go down the stage
Omo fear catch me infact I begin dey drop we we for sentino trouser as I sight the girl papa soldier as them dey climb stage come meet me with vex……


Na watin I go do oooo!!!!! Gbese le oo!



Hahahahahahahahahab guy I dey enjoy this Tori I swear
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by odaniel1(m): 5:53pm On Nov 04, 2018
Youngzubi:
na only one thing go make this story end like this for this una trend abi thread i nor no

but if una no fit comment after reading ....then make una forget am becos me sef get plenty work for hand,i no go find time write finish una go read without saying kpeekim ... no e dey vex me reach bone
Today, you are mentioned on FP as one of the best writers on Nairaland.
Message to all upcoming writers:
Keep writing. forget the comments or accolades. write because in due time like op, they will come to pass.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 6:25pm On Nov 04, 2018
odaniel1:

Today, you are mentioned on FP as one of the best writers on Nairaland.
Message to all upcoming writers:
Keep writing. forget the comments or accolades. write because in due time like op, they will come to pass.

Yea bro, not only that i was mentioned, i also won the writers award the following month that i started the story, it's kinda motivation to me and others, i almost gave up due to the problem i encountered trying to pass the massages in pidgin and still keep my readers glued, but all thanks to God, my boss centino and TheBlessedman who gave me the courage i needed at that point in time..

3 Likes

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by cherrybrown(f): 7:46am On Dec 11, 2018
Youngzubi:
mekonglobal Cherrybrown ritababe hfinest1 Johnsown1 yinks89 I


oya make una land. smiley
Thank you
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Johnsown1(m): 11:10am On Dec 11, 2018
Youngzubi:
mekonglobal
Cherrybrown
ritababe
hfinest1
Johnsown1
yinks89




oya make una land. smiley

Its a goal,
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by cherrybrown(f): 5:37pm On Dec 11, 2018
Johnsown1:

Its a goal,
Thank you but how sweet is the story
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Johnsown1(m): 7:50pm On Dec 11, 2018
cherrybrown:
Thank you but how sweet is the story
The part 1 make sense die
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 9:44am On Dec 12, 2018
Wadewaltz:
Youngzubi,put stone for pocket wen u won waka make breeze no blow u go,incompetent writer,failed comedian or shud I say Comedianne since he cant tink well lyk a man.Feminist nor try ur ancestors dis night.Reply and kee ur helper


Free mb no just good for some people
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by cherrybrown(f): 1:54pm On Dec 22, 2018
Johnsown1:
The part 1 make sense die
OK oooo
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by boookworm: 3:06am On Jan 25, 2019
Momoh7:
Your update made my day keep it coming
Boookworm come see
I can't believe I just saw this post grin cheesy
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Uniqueteco(m): 7:40pm On Feb 17, 2019
From the beginning to the end of this story, I really enjoyed and appreciate the story. More brain to your head... A mention is enough for me at the start of part 2 o. Youngzubi you're mouthed.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 5:49pm On Feb 18, 2019
Uniqueteco:
From the beginning to the end of this story, I really enjoyed and appreciate the story. More brain to your head... A mention is enough for me at the start of part 2 o. Youngzubi you're mouthed.

Thank you.. The part 2 had been written and posted out already. You can check my profile to get it.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by stivie(m): 9:27am On Mar 04, 2019
fire on bro

(1) (2) (3) ... (47) (48) (49) (50) (51) (Reply)

1985.... 1987.... 2014--[a Crime Story] / "Ocean Of Secrets" A Story By Millieademi / An Evening With Eva (2013 Triple Award Winner in Crime. Thriller. Action.)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 77
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.