Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,957 members, 7,821,361 topics. Date: Wednesday, 08 May 2024 at 11:57 AM

Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi - Literature (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi (9314 Views)

I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi / Bottle Warriors(beer Parlour Night Tale)story By Youngzubi / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:48pm On Dec 21, 2018
Arhyohme:
Boss
I dey hia I dey follow line by Line
Word fr word...

I sight u wink smiley
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:49pm On Dec 21, 2018
EmmyCC:
Zubilicious Zubi

See u come dey halla my name like food grin
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:51pm On Dec 21, 2018
Abdulreheem:
abeg hu u bi sift mak ar sidion well


Sit for him head area!!
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:53pm On Dec 21, 2018
MrsEvakinqz:
So YoungZubi I nor be your man abi??


No wahala nd better feature me for the story o

Baba i dey hail, you suppose know sey after u na still u...

If dis thread na for wedding ceremony u go dey high table na so no para wink
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Ann2012(f): 2:16pm On Dec 21, 2018
Thanks for the update

I dey follow grin
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by MrsEvakinqz(m): 2:25pm On Dec 21, 2018
Youngzubi:


Baba i dey hail, you suppose know sey after u na still u...

If dis thread na for wedding ceremony u go dey high table na so no para wink
You just know how to calm me down sha...

Kontinue we dey your back like hunch..
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Nobody: 3:03pm On Dec 21, 2018
Nice one Youngzubi
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by do4luv14(m): 9:38pm On Dec 21, 2018
Youngzubi:

Evold

amos1999

John944

vidamia

pinkberry5

Elohobaby

ifemism02

Tbuk

genius43

Holywizard

Izaray

IAmkingoludav

WHOcarex

Sensitivity1254

afolabiwunmi

Maymac

bekinyaro

do4luv14

Uniqueteco

oya present sir,
ah don land , keep it coming , make we dry reciv am as e dey hot
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:43pm On Dec 21, 2018
Naija Yahoo Life

Episode 2 by youngzubi

Oya make we enter the correct yan now wink

Igboo na loyal highness


Gbez! Gbez!! Gbez!!! Na wetin the matter dey nack for him mind,man nobi pikin very soon him mama go begin para for am ontop grandpikin mattar,all he needed was to make up him mind then make the correct move and waa! Money go surface that's if e no go suffocate am. He thought to himself.

With correct smile as small confidence don manage penetrate through him mind Mike stood up and walk to a blue Jerry-can na there he use cup take collect water wey him use wash teeth, chai that morning cool die as na Christmas season so correct hammarttan breez dey blow everywhere him sef no baff yesterday onto sey cold too dey so e better make man pikin sleep with dirty than to wake next morning with Catarina abi nobi so oyinbo pipo dey call am.
Satisfied with everything wey him don do that morning he pick up one red cardigan,black trousers and yellow socks after which he wore them

Bros you fine o!. Ebuka his younger brother tell am as he match outside.

Abi na,mike tear better smile and said i nor dey dress like pikin i be celebrity.

I swear broda u resemble rainbow. Ebuka shout and dash inside laughing hard.

Ebuka! Ebuka!! Chinekee! Nmua rainbow (me rainbow) no petos i go still catch you when i return in the evening ewu!. He said and match out bouncing like pregnant balloon.

Normal he first branch enter aunty nkechi cabar na there he go chop aunty thank you, nkechi na him mama senior sister so onto bloodline connection he normally go there go chop correct food anytime he feel like not eating at home. Erm! Aunty i don dey go thank you very much ma, he said and stood after he don successfully dismounted one plate of rice.

Mike e get something wey i go like make we discuss. Aunty Nkechi said abandoning what she was sweeping.

Aunty no vex, biko e get business we dey my neck now and i need rush go handle am now, no worry i go branch in the evening eh. He said and hastened his steps out of the compound onto sey he knew wetin the woman won present, nothing but make him go learn handwork.


Area! Which dimension na?"Gaffa asked Mike immediately he sight him passing.


Bobo na York tins o!." mike replied.

You mean holy mountain!? Gaffa asked again to be sure.

Yes bro man need highness in his holiness!

Tem! My guy, oya wait make i enter clothe . Gaffa yan and dash inside.


He tip-toe to him papa room jejely he kidnapped one innocent trouser with a long sleeve shirt, 2 mins later he surface outside with better smile as he thought of how York go take be that morning.the due shaked hand and walked down to No.8 Matthew balogun a lonely street filled with abounded buildings in isolated part of the town. Balogun street known as york or holy mountain by smokers who used the place as comfort zone for their smoking activities.

Base on base on as the matter take be, ifako na small town wey locate inside ogun state people of this town eh! Dem nor take ear hear pim! For English as na correct yan wey be pidgin be their lingua franca, reason be sey all those John bull boys wey nor get future don hustle enter their town come use belleh bless all their girls and as pikin must resemble dem papa those children grew up come dey chop pidgin like yam, if you na person wey too like phonetics then ifako area no bi him place at all, children here too sharp before you look dem.... Dem don already look you finish...Naso life be for this arena but ona go know more about dem as the tori proceed.

Just like two important idiots Gaffa and Mike shuk head enter balogun street as boys begin hail dem from different angles, some hang ontop window while the unfortunate ones lay down for ground as they couldn't differentiate between wall and ground base on highness level... Jombo at work

Piom! Piom!. Mike hail as him sight Nona for where he relax dey puff early mo mo tins...


O bob!... Nona hail

Broski!

Oya make ona land matter dey hand. Mike yan and beckoned dem to come over.


Yes o! I surprise sef as you take first us land york dis morning, i bin feel am sey something must be wrong either with your head or your clock.. Gaffa yan as dem carry yansh Sidon join Nona.


Hmm! Bros eh!, Nona yan as he puff him jombo.


O bob! Yan matter na, make men know where to start from maybe by selling your papa house.. "Mike yan, now lighting his first jombo.

If person tell me sey na dream i bin dream walahi i for nor believe infact i still dey doubt my existence."Nona yan as him friends now paid more attention.


Bia! This man how many round of jombo you don kiss so far, make i sure if na smoke dey yan abi you still correct.. Gaffa yan.


I dey for dream where i help one man o, for the dream again the man dash me golden chain but the matter come be sey after i wear am my life turn around as i come begin see tins so tey i still sleep inside the sleep come dream one kind yeye dream

Wait!! Match am for dia abegii, eeh you sleep ontop sleep come dey dream inside dream again and erm

Relax Mike. The confusing part be sey i wake up for inside the dream hot wee catch me na him i rush enter toilet only to see blood stains for my lips omo i begin shit for clothe, na when blessing enter my room wake me na him e come dawn on me pkosa! Sey na still dream be the whole tin.."Nona yan...

you don go pharmacy? Mike asked.

Pharmacy? Nona ask in return.

Yes.

For wetin na?

For malaria medicine...

But i nor get malaria i nor dey sick.

But i dey see the symptoms for your body you nor well. Mike still yan.

Wo! Guy if na to discourage person about the G level wey everybody don agree to join, count me out because my 100k don dey complete,Gaffa yan.

Na true o!, e fit be sey na to come preach man pikin this one dey gather mind so o!. "Mike yan.

Sbebi na all of us agreed, we don rob mind together come conclude sey na yahoo be our destiny but that dream fit be sign of bad omen." Nona said.

Taaa! Amen ko hallelujah ni oga no..

Mike still dey yan when guys scatter as dem begin race dey enter bush from different dimension..

Police don show o!. The last guy shout as he enter ben jonson mode. on hearing police the three friends dispersed instanta.... As the matter is now O. Y. O (on your own}...

Guys dey run enter bush but for this guy snoop him own matter different, snoop onto highness level tear race go hide inside the black hilus wey police people park for roadside, for him eye na beside tree he hide but on reality na beside two police men wey stay back inside the hilus moto wey dem use come he dey so.... Weed nor good.

The two police men confuse as dem begin look snoop wey just squeeze himself beside them. One of the police man decided to confirm their curiosity so he tap snoop and said, "oga wetin you dey find?"

Shiiiii!!! No make noise police dey around.snoop replied the police man placing his hand on him lips to shun dem from making noise because the igboo never allow him see tins for himself.

To be continued.. Abeg make una help me mention and invite ona friends and pipo make dem come join us ontop this gbedu!!

Still your guy youngzubi..

To be continued.

2 Likes

Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Gaston22(m): 11:22pm On Dec 21, 2018
emperorblog21:
if i,no follow this torry bumber to,bumber wettinv i gain


Like Seriously
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Gaston22(m): 11:25pm On Dec 21, 2018
Youngzubi Pis Try And Mention Me On The Next Update
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by germaphobe(m): 11:36pm On Dec 21, 2018
youngzubi your runaway fan reader don come back ooo, come update sharp sharp
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 7:29am On Dec 22, 2018
Souloho19

Silver1996

oga nla ( centino)

Swiz123

honorable359

rowdymind

Pradoic bros show face
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 7:32am On Dec 22, 2018
Episode 2 don land since but i chop ban instantly, i just tank God sey dem hear me out after i text their super mod so the episode is released now.

Scroll up to read wink
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 7:36am On Dec 22, 2018
Area!! Chai see gedu ooo

Rowdymind i sight you tanks for the inviii

Wait lemme go an gather we pipo come oo
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Deyoungne: 8:38am On Dec 22, 2018
Youngzubi zubilaija i dey hail bros more ink to your pen
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:14am On Dec 22, 2018
time don reach my people!!!!! oya @youngimporter ann2012 pradoic nasytnic purity247 pacifust058 Bigsarah ceecane2 Theloser germaphobe saraphina habundanz multikolour eazykolobo malaymoney odafiz Shlkhmuniru Decapo Neofingerz donroxyll sunrisemed07 Dayvdblake Revolva samkpanam Danchoco Therealev Biggybogo7 emperorblog senrino Abdulgafar86 Popoolataiwo sikells astute28 Dameldammie khd95 jozee8 Bemby69 Harlaan007 MrsEvakinqz Lenybee kingin55 Oliver Damibiz swiz123deniguy01 Timk122 tomgab tunjilomo 007Nonny olacarz Gspotlicker kelvinjeremiah dahvido hakeem4 brunxy tojahh chieheywhy Toyosih jixnation

1 Like

Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:15am On Dec 22, 2018
muminimutiyat Omokoladele Oscarnoble cooloustyne Estatesinlagos bonkoINC emazy10 Ebony07 zeezeegal KidoiLL badoxil bdauran Harrypolter13 Biggaboi speakout03 obakiaz ayamalexander77Runaway Yinks89 tomgab JOGICE johnsown7 rufdan

1 Like

Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:15am On Dec 22, 2018
emperordachris jeggychi paulek4eva stevodot22 ritababe Danyflamez honourable356 Holywizard fabianiweka pathneluti donaldphilipizu rowdymind

1 Like

Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:15am On Dec 22, 2018
pathneluti donaldphilipizu rowdymind wizsolzy Oscarnoble psybuk blazebaba iambees preciousbouy PopoolatTiawo momoh7 pgodson7 izaray jerryolumide Tobsonlove tpetos
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:17am On Dec 22, 2018
Oya!! Everyone should grab seat tori don show from our main man youngzubi
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 9:33am On Dec 22, 2018
Wadewaltz:
D day u see me impressed wit Youngzubi den know its all over,I read his story once and it made me depressed.So much for comedy

sad

grin cheesy grin grin cheesy

God bless, thanks for the encouragement grin cheesy wink
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Wadewaltz(m): 9:37am On Dec 22, 2018
Youngzubi by d tym u see dis I hv reported
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Divepen1(m): 9:45am On Dec 22, 2018
Wadewaltz:
Youngzubi by d tym u see dis I hv reported
Dear Readers, Youngzubi will be unavailable for a day for the threat to Wadewaltz. While Wadewaltz will be off for 5 days because of numerous reports from the users of the board. Let's be civil.
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:58am On Dec 22, 2018
Divepen1:
Dear Readers, Youngzubi will be unavailable for a day for the threat to Wadewaltz. While Wadewaltz will be off for 5 days because of numerous reports from the users of the board. Let's be civil.

Hello Divepen1 we all know youngzubi very well he's not the type that threatens or insult people, so for him to say that it means the dude must have crossed his boundary.

I know that guy Wadewaltz, he should be banned from replying cos all he does is to say trash.

Take a look at the screen shot below

Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 11:54am On Dec 22, 2018
AnikulapoPutin:

Chief Sleuth of the federation.I see some less-busy men everywhere sad

so u went to login with another account u dis Wadewaltz, another 45 years ban will soon land on this one too if you you're not careful. Just pray Divepen1 don't notice you're accessing nairaland with another account
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by blazebaba(m): 2:44pm On Dec 22, 2018
Oyaa youngzubi baami, I dey with you naa, just say make I sharply mole this last SK before I bin dey start nii grin..

(1) (2) (3) (4) (Reply)

10 Tips On How To Write A Lot (and Get That Novel Written) / The Diary Of A Terrorist (True Life Story Of Unimaid Student Turned BH Member) / Some Nigerian-mangled English Words

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 51
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.