Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,659 members, 7,955,377 topics. Date: Sunday, 22 September 2024 at 01:18 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi (9687 Views)
I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi / Bottle Warriors(beer Parlour Night Tale)story By Youngzubi / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (Reply) (Go Down)
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:48pm On Dec 21, 2018 |
Arhyohme: I sight u |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:49pm On Dec 21, 2018 |
EmmyCC: See u come dey halla my name like food |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:51pm On Dec 21, 2018 |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:53pm On Dec 21, 2018 |
MrsEvakinqz: Baba i dey hail, you suppose know sey after u na still u... If dis thread na for wedding ceremony u go dey high table na so no para |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Ann2012(f): 2:16pm On Dec 21, 2018 |
Thanks for the update I dey follow |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by MrsEvakinqz(m): 2:25pm On Dec 21, 2018 |
Youngzubi:You just know how to calm me down sha... Kontinue we dey your back like hunch.. |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Nobody: 3:03pm On Dec 21, 2018 |
Nice one Youngzubi |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by do4luv14(m): 9:38pm On Dec 21, 2018 |
Youngzubi: oya present sir, ah don land , keep it coming , make we dry reciv am as e dey hot |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:43pm On Dec 21, 2018 |
Naija Yahoo Life Episode 2 by youngzubi Oya make we enter the correct yan now Igboo na loyal highness Gbez! Gbez!! Gbez!!! Na wetin the matter dey nack for him mind,man nobi pikin very soon him mama go begin para for am ontop grandpikin mattar,all he needed was to make up him mind then make the correct move and waa! Money go surface that's if e no go suffocate am. He thought to himself. With correct smile as small confidence don manage penetrate through him mind Mike stood up and walk to a blue Jerry-can na there he use cup take collect water wey him use wash teeth, chai that morning cool die as na Christmas season so correct hammarttan breez dey blow everywhere him sef no baff yesterday onto sey cold too dey so e better make man pikin sleep with dirty than to wake next morning with Catarina abi nobi so oyinbo pipo dey call am. Satisfied with everything wey him don do that morning he pick up one red cardigan,black trousers and yellow socks after which he wore them Bros you fine o!. Ebuka his younger brother tell am as he match outside. Abi na,mike tear better smile and said i nor dey dress like pikin i be celebrity. I swear broda u resemble rainbow. Ebuka shout and dash inside laughing hard. Ebuka! Ebuka!! Chinekee! Nmua rainbow (me rainbow) no petos i go still catch you when i return in the evening ewu!. He said and match out bouncing like pregnant balloon. Normal he first branch enter aunty nkechi cabar na there he go chop aunty thank you, nkechi na him mama senior sister so onto bloodline connection he normally go there go chop correct food anytime he feel like not eating at home. Erm! Aunty i don dey go thank you very much ma, he said and stood after he don successfully dismounted one plate of rice. Mike e get something wey i go like make we discuss. Aunty Nkechi said abandoning what she was sweeping. Aunty no vex, biko e get business we dey my neck now and i need rush go handle am now, no worry i go branch in the evening eh. He said and hastened his steps out of the compound onto sey he knew wetin the woman won present, nothing but make him go learn handwork. Area! Which dimension na?"Gaffa asked Mike immediately he sight him passing. Bobo na York tins o!." mike replied. You mean holy mountain!? Gaffa asked again to be sure. Yes bro man need highness in his holiness! Tem! My guy, oya wait make i enter clothe . Gaffa yan and dash inside. He tip-toe to him papa room jejely he kidnapped one innocent trouser with a long sleeve shirt, 2 mins later he surface outside with better smile as he thought of how York go take be that morning.the due shaked hand and walked down to No.8 Matthew balogun a lonely street filled with abounded buildings in isolated part of the town. Balogun street known as york or holy mountain by smokers who used the place as comfort zone for their smoking activities. Base on base on as the matter take be, ifako na small town wey locate inside ogun state people of this town eh! Dem nor take ear hear pim! For English as na correct yan wey be pidgin be their lingua franca, reason be sey all those John bull boys wey nor get future don hustle enter their town come use belleh bless all their girls and as pikin must resemble dem papa those children grew up come dey chop pidgin like yam, if you na person wey too like phonetics then ifako area no bi him place at all, children here too sharp before you look dem.... Dem don already look you finish...Naso life be for this arena but ona go know more about dem as the tori proceed. Just like two important idiots Gaffa and Mike shuk head enter balogun street as boys begin hail dem from different angles, some hang ontop window while the unfortunate ones lay down for ground as they couldn't differentiate between wall and ground base on highness level... Jombo at work Piom! Piom!. Mike hail as him sight Nona for where he relax dey puff early mo mo tins... O bob!... Nona hail Broski! Oya make ona land matter dey hand. Mike yan and beckoned dem to come over. Yes o! I surprise sef as you take first us land york dis morning, i bin feel am sey something must be wrong either with your head or your clock.. Gaffa yan as dem carry yansh Sidon join Nona. Hmm! Bros eh!, Nona yan as he puff him jombo. O bob! Yan matter na, make men know where to start from maybe by selling your papa house.. "Mike yan, now lighting his first jombo. If person tell me sey na dream i bin dream walahi i for nor believe infact i still dey doubt my existence."Nona yan as him friends now paid more attention. Bia! This man how many round of jombo you don kiss so far, make i sure if na smoke dey yan abi you still correct.. Gaffa yan. I dey for dream where i help one man o, for the dream again the man dash me golden chain but the matter come be sey after i wear am my life turn around as i come begin see tins so tey i still sleep inside the sleep come dream one kind yeye dream Wait!! Match am for dia abegii, eeh you sleep ontop sleep come dey dream inside dream again and erm Relax Mike. The confusing part be sey i wake up for inside the dream hot wee catch me na him i rush enter toilet only to see blood stains for my lips omo i begin shit for clothe, na when blessing enter my room wake me na him e come dawn on me pkosa! Sey na still dream be the whole tin.."Nona yan... you don go pharmacy? Mike asked. Pharmacy? Nona ask in return. Yes. For wetin na? For malaria medicine... But i nor get malaria i nor dey sick. But i dey see the symptoms for your body you nor well. Mike still yan. Wo! Guy if na to discourage person about the G level wey everybody don agree to join, count me out because my 100k don dey complete,Gaffa yan. Na true o!, e fit be sey na to come preach man pikin this one dey gather mind so o!. "Mike yan. Sbebi na all of us agreed, we don rob mind together come conclude sey na yahoo be our destiny but that dream fit be sign of bad omen." Nona said. Taaa! Amen ko hallelujah ni oga no.. Mike still dey yan when guys scatter as dem begin race dey enter bush from different dimension.. Police don show o!. The last guy shout as he enter ben jonson mode. on hearing police the three friends dispersed instanta.... As the matter is now O. Y. O (on your own}... Guys dey run enter bush but for this guy snoop him own matter different, snoop onto highness level tear race go hide inside the black hilus wey police people park for roadside, for him eye na beside tree he hide but on reality na beside two police men wey stay back inside the hilus moto wey dem use come he dey so.... Weed nor good. The two police men confuse as dem begin look snoop wey just squeeze himself beside them. One of the police man decided to confirm their curiosity so he tap snoop and said, "oga wetin you dey find?" Shiiiii!!! No make noise police dey around.snoop replied the police man placing his hand on him lips to shun dem from making noise because the igboo never allow him see tins for himself. To be continued.. Abeg make una help me mention and invite ona friends and pipo make dem come join us ontop this gbedu!! Still your guy youngzubi.. To be continued. 2 Likes |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Gaston22(m): 11:22pm On Dec 21, 2018 |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Gaston22(m): 11:25pm On Dec 21, 2018 |
Youngzubi Pis Try And Mention Me On The Next Update |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by germaphobe(m): 11:36pm On Dec 21, 2018 |
youngzubi your runaway fan reader don come back ooo, come update sharp sharp |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 7:29am On Dec 22, 2018 |
Souloho19 Silver1996 oga nla ( centino) Swiz123 honorable359 rowdymind Pradoic bros show face |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 7:32am On Dec 22, 2018 |
Episode 2 don land since but i chop ban instantly, i just tank God sey dem hear me out after i text their super mod so the episode is released now. Scroll up to read |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 7:36am On Dec 22, 2018 |
Area!! Chai see gedu ooo Rowdymind i sight you tanks for the inviii Wait lemme go an gather we pipo come oo |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Deyoungne: 8:38am On Dec 22, 2018 |
Youngzubi zubilaija i dey hail bros more ink to your pen |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:14am On Dec 22, 2018 |
time don reach my people!!!!! oya @youngimporter ann2012 pradoic nasytnic purity247 pacifust058 Bigsarah ceecane2 Theloser germaphobe saraphina habundanz multikolour eazykolobo malaymoney odafiz Shlkhmuniru Decapo Neofingerz donroxyll sunrisemed07 Dayvdblake Revolva samkpanam Danchoco Therealev Biggybogo7 emperorblog senrino Abdulgafar86 Popoolataiwo sikells astute28 Dameldammie khd95 jozee8 Bemby69 Harlaan007 MrsEvakinqz Lenybee kingin55 Oliver Damibiz swiz123deniguy01 Timk122 tomgab tunjilomo 007Nonny olacarz Gspotlicker kelvinjeremiah dahvido hakeem4 brunxy tojahh chieheywhy Toyosih jixnation 1 Like |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:15am On Dec 22, 2018 |
muminimutiyat Omokoladele Oscarnoble cooloustyne Estatesinlagos bonkoINC emazy10 Ebony07 zeezeegal KidoiLL badoxil bdauran Harrypolter13 Biggaboi speakout03 obakiaz ayamalexander77Runaway Yinks89 tomgab JOGICE johnsown7 rufdan 1 Like |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:15am On Dec 22, 2018 |
emperordachris jeggychi paulek4eva stevodot22 ritababe Danyflamez honourable356 Holywizard fabianiweka pathneluti donaldphilipizu rowdymind 1 Like |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:15am On Dec 22, 2018 |
pathneluti donaldphilipizu rowdymind wizsolzy Oscarnoble psybuk blazebaba iambees preciousbouy PopoolatTiawo momoh7 pgodson7 izaray jerryolumide Tobsonlove tpetos |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:17am On Dec 22, 2018 |
Oya!! Everyone should grab seat tori don show from our main man youngzubi |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Youngzubi(m): 9:33am On Dec 22, 2018 |
Wadewaltz: God bless, thanks for the encouragement |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Wadewaltz(m): 9:37am On Dec 22, 2018 |
Youngzubi by d tym u see dis I hv reported |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by Divepen1(m): 9:45am On Dec 22, 2018 |
Wadewaltz:Dear Readers, Youngzubi will be unavailable for a day for the threat to Wadewaltz. While Wadewaltz will be off for 5 days because of numerous reports from the users of the board. Let's be civil. |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 9:58am On Dec 22, 2018 |
Divepen1: Hello Divepen1 we all know youngzubi very well he's not the type that threatens or insult people, so for him to say that it means the dude must have crossed his boundary. I know that guy Wadewaltz, he should be banned from replying cos all he does is to say trash. Take a look at the screen shot below
|
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by pradoic(m): 11:54am On Dec 22, 2018 |
AnikulapoPutin: so u went to login with another account u dis Wadewaltz, another 45 years ban will soon land on this one too if you you're not careful. Just pray Divepen1 don't notice you're accessing nairaland with another account |
Re: Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi by blazebaba(m): 2:44pm On Dec 22, 2018 |
Oyaa youngzubi baami, I dey with you naa, just say make I sharply mole this last SK before I bin dey start nii .. |
The Way You Make Your Bed Is The Way You Lie On It. / Winds Of Fate / I Wish I Never Meet Him A Regret Story By Mary Temitope
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 51 |