Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,484 members, 7,801,228 topics. Date: Thursday, 18 April 2024 at 12:41 PM

Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) - Literature (9) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) (61653 Views)

Water Strike- A Comedy (18+) / FRESH Toto(adventure Of Prick Master And Miss Young Toto? / Innocent Ilo Wins 2020 Commonwealth Short-story For African Region (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) ... (22) (Reply) (Go Down)

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:41am On Jan 15, 2019
Abeg all my fans dem,
i don decide to start posting again my funny story baba olowo d long prick,
this na for everyone here to laugh out the days stress after work,
but i dey wonder say some people here dey like read am before dem go work self,
abeg i recommend reading at night when your prick don stand,
looks like the group is losing strenght again because some people now dey complain.

I will come back from retirement probably this week or so,

naso one bros tell me,
see come baba olowo,
let the dead bury the dead,
abeg forget that your manager make don die and move on

i for answer the bros here but maybe i go add this stuff for my next episode of baba olowo

please do watch out, coming soon live on Hd

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Nobody: 11:27am On Jan 15, 2019
INTERESTING

read more cool,and interesting story on
www.emperorblog.com.ng
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Rosemary33: 4:00pm On Jan 15, 2019
Baba Olowo, how far na, I don't teh o.
Chain, I gbadu you die
Ride on my brother
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:23pm On Jan 15, 2019
Rosemary33:
Baba Olowo, how far na, I don't teh o.
Chain, I gbadu you die
Ride on my brother

its been a long road but we are here now,
thanks my sister in the lord for this great words now i know i got fans here,

happy new year to you my baby rosemary33,
will drop more funny updates here

baba olowo

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:56pm On Jan 15, 2019
Episode 52
(let the dead bury the dead)

ahhh i don die,
wetin be this?

See come all this my fans dem make want make me baba olowo continue to dey drop new updates for here so,

una weldone o,
shey be una know say am still mourning my manager the man am working for who died january 7th 2019 at the cold hands of death?

Abeg make una give me sometime to recover the loss na,

As i still dey talk on top stage,
naso one bros shout,

see come baba olowo
let the dead bury the dead
abeg try update us more episodes everyday abeg,
forget that your manager make don kick bucket and move on,

naso everybody burst laugh,
hahhahahahahahhaha

abeg which one again be my manager don kick bucket?

Naso people shout
na true say baba olowo manager don kick bucket die?

Hahahhahahahaaahaa
chaii i don suffer

naso one other babe stand up shout,
see come baba olowo you think its easy staying for days without your latest new story updates as you normally do post here?

you think its easy?
oboy we no believe the babe start to dey cry o,

ahhhh people run go compensate the babe,

see come baba olowo,
as you do face like drenched pig so,
for your life no ever try this rubbish delay again o,

naso i tell dem,
abeg make una no vex but make una remember say na me be baba olowo,
me too na human like everyone here,
i get feelings and i get emotions,
and una know say na only when am happy i dey get inspirations to dey compose stuffs for una here,

abeg accept my apologies all my fans dem,

naso one guy stand up shout,
see come baba olowo as you take resemble usman dan fodio so,

that your stupid apology is not accepted,
imagine say even all my household don dey expect you to post since,
but you never even start,
oboy the bros burst cry again o,

ahhhh wetin dey happen here?

Naso i shout,
see come as all of una do neck like kola nut so,

abeg make una take heart as me baba olowo don come back again to dey post here,

naso people shout abeg baba olowo entertain us o,
or else we no go ever forgive you for life,

even the guy make shout am pass people turn look am,
see come you normal so?
If you no forgive baba olowo for life how him won take dey give us new update na?

Naso i tell dem,
abeg i won tell una something first,

e been get one group i post something there,
oboy the next thing make i see na one guy just drop comment,

see come you this fully fledged fool,
your post is as stupid as your dumb ass,
you aint gonna touch me because am in my house bitch,

hahahahahhahahahahaha
hahahahahhaaahahahaaa

i don die,
come o, na you baba olowo person yab like this?

Hahahaahhahahahahaha
hahhahahahahaha

Ahhh the thing vex me die,
naso i reply the guy make comment

see come you this british fool make come here to comment rubbish,
na this type of thing your grandfather sir alex the great fool do,may make people gather kill am

now you won follow the same footstep abi?
Well i no blame you since you are senseless enough,

as you do yansh like catapot make person dey use fire to kill lizard so,

na your type dey go hang for the back of dangote trailer dey go work,

selfish he goat like you make no won waist transport money,

hahahahhahahahahahhaa
hahahahahhahhahaha

everybody burst laugh

hahhahahahahahahaa
abeg baba olowo don come back again to dey yab people o,

please sit tight and enjoy the fun,

naso i tell dem,
me and the guy yab ourselves for hours none stop,
when baba don see say my mouth no just good,

naso baba comment,
but even till today i still dey wonder which kind comment be this?
O yea!!! O yea!!!

Hahhahahahahahahahhaha
everybody burst laugh

abeg wetin the guy talk so?
Which one be
O yea!!! O yea!!!

To tell una as i don take yab the guy reach, sotey the guy no just believe say nahim type that rubbish so,

come o baba olowo,
your yabbing no just good,
abeg you go yabbing school?

Hahhahahahahhahahaha
i yab the guy sotey the guy type rubbish,

all this guys online make dey like use english yab person,
una no know say me baba olowo good die to dey type also with english?
Abi una think say na pidgin english i go school go learn?

Please note, na private school i go not public school so am fully english learned guy,

na because of this my funny story baba olowo nahim make i dey type pidgin like this if not i be english gentleman,

naso i continue,
e been get one thing make happen for our area here so,

naso one guy go near bush go piss,
oboy we no believe say the guy dey even piss un top one small calabash,

and i been warn the guy say na juju pot be that o.

Baba no just answer me,
baba tell me say my guy forget that thing nothing dey happen abeg,

naso i go front go wait for am,

oboy we no believe say baba still dey there dey piss for 3 hours plus,
hahahhahahaahahhahah
hahahhahahahahhahaha
everybody burst laugh

ahhhh wetin happen?
Come o,the juju don catch baba?
Abeg na like this normal person dey use piss?
Even if na mad dog self no go piss reach 3 hours,
hahahaha

wetin happen next you no go believe,
Watch out for episode 53
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 9:01am On Jan 16, 2019
Good update, keep the fire burning
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:19pm On Jan 16, 2019
Tonyspecial:
Good update, keep the fire burning

thanks bro, i really appreciate this,

baba olowo

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:20pm On Jan 16, 2019
Episode 53
(happy birthday to john arigu baba)

hahahhhahahahahahaa
everybody burst laugh

chaiii baba olowo abeg wetin con happen to that guy make go piss on top juju pot so?

Naso i tell dem,
i tell una say till today that guy still stand there dey piss,

hahhahahahahaaaahaaha
hahahhahahahahahahaha

i don die,
come o,baba olowo you mean say the guy still dey there dey piss since that time?

Oboy this thing make i just tell una so na since last year the thing happen so,

ahhhh abeg make una beware of any strange juju pot o,

as i dey talk on top stage,
naso people shout,

happy birthday to you john arigu,
we love you and many more years to come!!!

woooooooowwooooooow
oboy we no believe say today na john arigu birthday,

naso we see john arigu come outside dey shine teeth,

see as guys dey happy dey pop more bottles,

as i see as here dey hot naso me baba olowo drop comot from stage,
but as i won comot

naso everybody stand up give me baba olowo standing ovation,
oboy see clapping for rumours hotel here,

dem dey shout baba olowo you too much abeg,
you don dey drop us new funny episodes dem since back to back on top stage so,

you funny die,
abeg take some sweet hugs,
naso people rush dey hug me baba olowo,

please take heart for your loss and move on,

all hail king baba olowo the proffessional yabber of our time,

hahahahahhaaaaa
we love you baba olowo d long prick!!!

Naso people start to dey clap for me baba olowo,

sharp sharp dem give me one VIP seat,

oboy before we know we see one guy make dem dey call sekpe timothy run climb stage like mad man,

baba shout,
abeg i won sing happy birthday song to john arigu baba,

happy birthday to you!!!
Happy birthday to you!!!
Happy birthday,
happy birthday,
happy birthday to you!!!
Hip hip hip hurray!!!
Hip hip hip hurray!!!

Everybody shine teeth dey laugh,
hahahhahahahahahhaa

ahhh the thing vex me baba olowo,
naso i stand up won yab sekpe timothy,

see come sekpe timothy,
as you do face like,

oboy naso people rush dey beg me baba olowo,
abeg no yab am o,
na john arigu birthday be this abeg lets catch some fun please

naso sekpe timothy continue again,
abeg my birthday wishes to you john arigu na,
happy birthday to you,
more money in your account,
more bitches to your life,
and long life and prosperity to your boss,unlike baba olowo boss make don kick bucket die so,

hahahhahahahhahaaaaa
everybody burst laugh

chaiii so na me baba olowo this great fool dey talk to so?

Anyways i no blame you,
naso i stand up vex climb stage again,

see come sekpe timothy,
as you do face like kitchen utensils so,

na your type boys dem dey burst bottle dey fight for their birthday,

as you carry eye like person make dey sell kwili kwili for bustop,

na your type teacher go dey tell for class write a letter to your uncle who lives in london,

una know fully well say sekpe timothy uncle no dey outside country, na kogi state baba dey,
dey claim boko haram,

even the teacher self no just get anybody for outside country,
abeg who is fooling who?

Poverty teacher with him broke ass student sekpe timothy,

hahahahahahhahahahha
hahahhahahaha

i don die na sekpe timothy be this?

Hahhahahahahahaha
everybody burst laugh

baba olowo abeg leave am na,
no yab am again o,

naso i continue,
see come john arigu baba na today be your birthday so be happy,

flex your life and have fun because wetin my eye don see pass me,

imagine say me baba olowo forget my birthday last year,
some people here go think say na joke and na lie,

but i dey tell una the truth from my heart,

i still dey wonder if na too much of work cause am abi na poverty cause am,

hahahahahhahahahahaaa
see as people dey laugh me

hahahhahahahahhahaa
chaiii what a crazy world,

naso i bounce go sidon for my seat,

oboy i no believe one bouncer carry one small paper give me,

appreciations from 2face baba,
abeg go bank go catch your cash check

ahhhh the thing sweet me die,
naso john arigu come outside dey happy,
am really happy you guys remembered me here,

its all i ever wanted to be celebrated,
i wish you all too a happy and fulfilling life, expecially to you my bro baba olowo for dedicating this episode 53 all just for me john arigu,

i really appreciate this, thank you all
oboy people stand up dey clap for john arigu baba,

naso one guy stand up shout,
abeg john arigu how many years you dey now abeg?

Oboy we no believe one other guy stand up shout say john arigu dey just 4 years of age,

hahahhhahahahahahhahah
hahhahahahahhahahhahha
i don die wetin be this?

So una mean say john arigu na 4 years old boy?

Chaiii so na even small boy him be self?

Hahahhahahaaahahhahahaa
abeg all na for the joke o,

naso i look the bros make say john arigu baba dey 4 years,

the bros head even resemble all those ogun state their wicked masquarade dem make do teeth like fashionla B,R,T bus,

as i won yab am,
the bros turn look me bone face,
cut one eye give me, abeg no yab me abeg baba olowo,

hahahhaahhahahha
haha

watch out for episode 54
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:50pm On Jan 16, 2019
Dem say dem bad but i swear dem do noting o ehh,
dem say dem go trow me punch but i swear dem no reach o ehh,
twenty man shall fall that day if you cross my lane o ehh,
all your man shall fall that day if you cross my lane o,
oya back to the matter

see come all my fans dem make dey gbadu baba olowo funny story dem,
i hail o,
its been a long road but we are here now,
some people now dey send me friend request everyday for facebook,
baba olowo i love your commedy stories keep it up,
please tag me in your next episode,
na all this things i dey face now,
anyways i go ask one question here,
abeg which place or websites,blogs, facebook groups,forums or anything at all una go fit help me see any story make sweet like my own,
i mean for the yabbing levels o,
where the writer go dey make us laugh to dey yab people like baba olowo d long prick funny story,
i don check tire but i never even see one online,

na all those kind place i dey like go show dem who baba olowo really be,

abeg any suggestions?

Baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 7:45pm On Jan 16, 2019
okafor200:
Episode 53
(happy birthday to john arigu baba)

hahahhhahahahahahaa
everybody burst laugh

chaiii baba olowo abeg wetin con happen to that guy make go piss on top juju pot so?

Naso i tell dem,
i tell una say till today that guy still stand there dey piss,

hahhahahahahaaaahaaha
hahahhahahahahahahaha

i don die,
come o,baba olowo you mean say the guy still dey there dey piss since that time?

Oboy this thing make i just tell una so na since last year the thing happen so,

ahhhh abeg make una beware of any strange juju pot o,

as i dey talk on top stage,
naso people shout,

happy birthday to you john arigu,
we love you and many more years to come!!!

woooooooowwooooooow
oboy we no believe say today na john arigu birthday,

naso we see john arigu come outside dey shine teeth,

see as guys dey happy dey pop more bottles,

as i see as here dey hot naso me baba olowo drop comot from stage,
but as i won comot

naso everybody stand up give me baba olowo standing ovation,
oboy see clapping for rumours hotel here,

dem dey shout baba olowo you too much abeg,
you don dey drop us new funny episodes dem since back to back on top stage so,

you funny die,
abeg take some sweet hugs,
naso people rush dey hug me baba olowo,

please take heart for your loss and move on,

all hail king baba olowo the proffessional yabber of our time,

hahahahahhaaaaa
we love you baba olowo d long prick!!!

Naso people start to dey clap for me baba olowo,

sharp sharp dem give me one VIP seat,

oboy before we know we see one guy make dem dey call sekpe timothy run climb stage like mad man,

baba shout,
abeg i won sing happy birthday song to john arigu baba,

happy birthday to you!!!
Happy birthday to you!!!
Happy birthday,
happy birthday,
happy birthday to you!!!
Hip hip hip hurray!!!
Hip hip hip hurray!!!

Everybody shine teeth dey laugh,
hahahhahahahahahhaa

ahhh the thing vex me baba olowo,
naso i stand up won yab sekpe timothy,

see come sekpe timothy,
as you do face like,

oboy naso people rush dey beg me baba olowo,
abeg no yab am o,
na john arigu birthday be this abeg lets catch some fun please

naso sekpe timothy continue again,
abeg my birthday wishes to you john arigu na,
happy birthday to you,
more money in your account,
more bitches to your life,
and long life and prosperity to your boss,unlike baba olowo boss make don kick bucket die so,

hahahhahahahhahaaaaa
everybody burst laugh

chaiii so na me baba olowo this great fool dey talk to so?

Anyways i no blame you,
naso i stand up vex climb stage again,

see come sekpe timothy,
as you do face like kitchen utensils so,

na your type boys dem dey burst bottle dey fight for their birthday,

as you carry eye like person make dey sell kwili kwili for bustop,

na your type teacher go dey tell for class write a letter to your uncle who lives in london,

una know fully well say sekpe timothy uncle no dey outside country, na kogi state baba dey,
dey claim boko haram,

even the teacher self no just get anybody for outside country,
abeg who is fooling who?

Poverty teacher with him broke ass student sekpe timothy,

hahahahahahhahahahha
hahahhahahaha

i don die na sekpe timothy be this?

Hahhahahahahahaha
everybody burst laugh

baba olowo abeg leave am na,
no yab am again o,

naso i continue,
see come john arigu baba na today be your birthday so be happy,

flex your life and have fun because wetin my eye don see pass me,

imagine say me baba olowo forget my birthday last year,
some people here go think say na joke and na lie,

but i dey tell una the truth from my heart,

i still dey wonder if na too much of work cause am abi na poverty cause am,

hahahahahhahahahahaaa
see as people dey laugh me

hahahhahahahahhahaa
chaiii what a crazy world,

naso i bounce go sidon for my seat,

oboy i no believe one bouncer carry one small paper give me,

appreciations from 2face baba,
abeg go bank go catch your cash check

ahhhh the thing sweet me die,
naso john arigu come outside dey happy,
am really happy you guys remembered me here,

its all i ever wanted to be celebrated,
i wish you all too a happy and fulfilling life, expecially to you my bro baba olowo for dedicating this episode 53 all just for me john arigu,

i really appreciate this, thank you all
oboy people stand up dey clap for john arigu baba,

naso one guy stand up shout,
abeg john arigu how many years you dey now abeg?

Oboy we no believe one other guy stand up shout say john arigu dey just 4 years of age,

hahahhhahahahahahhahah
hahhahahahahhahahhahha
i don die wetin be this?

So una mean say john arigu na 4 years old boy?

Chaiii so na even small boy him be self?

Hahahhahahaaahahhahahaa
abeg all na for the joke o,

naso i look the bros make say john arigu baba dey 4 years,

the bros head even resemble all those ogun state their wicked masquarade dem make do teeth like fashionla B,R,T bus,

as i won yab am,
the bros turn look me bone face,
cut one eye give me, abeg no yab me abeg baba olowo,

hahahhaahhahahha
haha

watch out for episode 54
nice one Baba
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:48am On Jan 17, 2019
Tonyspecial:
nice one Baba

thanks bro,
you are welcome
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:49am On Jan 17, 2019
Episode 54
(come o, na true say john arigu dey just 4 years of age? )

hahahahahahhhhahha
hahahahhahhahahaaaa

chaii i don die,
na true say john arigu dey 4 years?

Na small boy him go be na,
everybody burst laugh

hahhahahhahahaaaaaha
hahahahaaaahahhahaaaa

naso i shout,
see come sekpe timothy,
you make dey open mouth talk like pregnant cow so,
how many years you yourself go dey self?

I dey very sure say you never even reach 7 years,
as you do face like long term investment make never mature so,

na your type people dey use as excuse no gree go work,

as you carry yansh like mad man secondary school report card, when the mad man never start to dey mad like this so,

hahahahahahahahhaha
see as people stand up dey laugh,

abeg baba olowo leave sekpe timothy alone na,

oboy na one babe make dem dey call rachel job stand up shout o,

naso i look the babe,
see come you this babe make do eye like catfish make don spoil so,

i no know wether na because of say jobs no just dey for nigeria here so nahim make you dey answer rachel job so,

abeg just mind your self o,
i no know if you and sekpe timothy na brother and sister,
or maybe sekpe timothy dey plan to toast you,

when i go check sekpe timothy timeline for facebook here na only your pics i just dey see here up and down,

today is a good day for me,
tomorrow is not a good day for me nahim be the only thing i dey see you dey post,

well i no blame you because you never see suffer,

when suffer catch your yansh, even your bad day you go post am for facebook here say today is a good day for me,

as you do teeth like shark make dey recover from strange illness so,

even the shark self confuse ask himself ,
abeg wetin una talk make dey do me so?

Hahhahhaaahaahahahahahahaha
hahahahahhahahahahhah
everybody burst laugh

abeg baba olowo leave this babe rachel job abeg o,

looks like she dey follow read this your baba olowo funny episodes dem everyday here self,

baba olowo abeg you be boss just leave sekpe timothy with him concubine abeg,

naso i sidon for my sit bone face dey eat milk and egg,

as i dey eat troway face dey blow whistle,
oboy one guy just dey use one eye dey skemp my food o,

naso the guy look me shout,
see come baba olowo which kind strange food be this one self?

Which one be this milk and egg you dey chop here so?

Abi you think say here na italian restuarant you dey?

Naso i look the bros from head to toe,

see come you this good for nothing useless bros so,

just tell me say you no just know how you go take beg me make i remain small for you,

as you carry neck like old handkerchief make mad man spread hang on top rope so,

na your type phillipians for bible dey put for their warfront so their enemies fit see you kill sharp sharp troway,

as you do face like john arigu old school bag so,

na your type dey stand for assembly ground no dey ever gree sing their school national antem so,

as you carry head like pilot make run fly come down from plane excape, leave all the whole passengers for air when the plane won crash land,

haahhahahhahahahahhaha
hahhaha

everybody burst laugh
chaiiii wetin be this?

Baba olowo you too funny abeg,
why your yabbing dey give people hiccups like this?

Hahahahahahahahahaaha
we no believe person shout,

i don die o, baba olowo don kill me o,
i don laugh sotey my pant don tear with hot shit,

hahhahahahahaaahaaaaha
see as people just dey laugh dey catch fun,

naso one guy ask me abeg baba olowo which time you go ever stop to dey yab people?
Why you too funny like this?

Even d blacc make too serious dey bone face, love this your funny story so,

naso i tell people,
e been get one funny show make d blacc baba go, make dem dey call laugh out your bones,

you go laugh tire sotey all your bones go come outside,
you go see am with you own eyes no be joke,

naso the mc there dey crack jokes,
see as everybody dey fall for groud dey laugh,

hahahahahahhahahhaha
oh my gosh you are too funny mr mc,

i tell una say the show we dey watch am live for dstv,

oboy as the video camera dey show as people dey burst laugh some dey even cry join am self,

naso the camera show d blacc,
baba bone face no gree laugh one bit,

oboy people stop to dey laugh o,

the next thing make we see na person make people gather dey beat like mad man,

oboy na d blacc baba be that o,
a whole funny commedy show baba no gree laugh,

naso people dey shout,
beat am well well,
this guy get spiritual problem,

oboy dem beat d blacc craze fling am go outside enter swamp gbosa!!

hahahahahahhaahahaaa
everybody burst laugh,

i tell una say d blacc baba really get laughing problem,
oboy since that day d blacc baba no dey gree go any funny show again,

hahhahahahahaaahaaaa
chaii so baba olowo you mean say d blacc get laughing problem?

Hahhahahahahahhahaa

naso one guy stand up shout,
abeg baba olowo i really love this your slogan,
its been a long road but we are here now,

naso i look the guy,

chaii wetin happen next you no go believe

watch out for episode 55

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by eastTKBorn: 3:38pm On Jan 17, 2019
Baba olowo na me iambees AKA eastTKBorn no fail to mention thee because thou would be available ride on okafor200
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 8:21am On Jan 18, 2019
Baba u too much i beg
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:22pm On Jan 18, 2019
eastTKBorn:
Baba olowo na me iambees AKA
eastTKBorn no fail to mention thee
because thou would be available
ride on okafor200

no wahala baba,
its been a while o, you are welcome back

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:25pm On Jan 18, 2019
Tonyspecial:
Baba u too much i beg

nice one bro,
i funny pass like this self,
anyways will still be droping more episodes here na me dem dey call baba olowo the online funny yabber

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:26pm On Jan 18, 2019
Episode 55
( a dedication to my new nigga Foremaster Flex Obizlove )

hahahahahahahaha
see as everybody dey burst laugh for rumours hotel here,

naso i look the bros make talk say him love my slogan its been a long road but we are here now,

see come you this bros make do head like aboliki balm so,
na your type dey go thief person fowl one leg chop,

as you do neck like coaster bus make don spoil,

hahahhahhaaahaha
everybody burst laugh

chaiii i don die o,
see come baba olowo no go kill us here o,

as everywhere take be for here naso i tell people,

e get one time make one white china man show when we dey field dey play ball,

oboy naso guys start to dey play serious o,

see as the play play ball make we been dey use fun play before serious like say na world cup final we dey play,

wetin vex me pass na one of my men make dey play rubbish,
baba name na Foremaster Flex Obizlove,

even to control ball baba no just fit control,
naso Foremaster Flex Obizlove catch keeper one on one shoot ball troway enter bush,

ahhh i don die,

the next thing make we see,
naso my guy half kilo dribble finish enter box 18,

ahh naso one wicked guy clear baba troway,
the guy shout see come you this half kilo make do face like pourage beans so,
na you won come score goal for here abi?

Oboy naso dem give the penalty to this mad guy Foremaster Flex Obizlove,

oboy baba shoot the ball enter person compound o,

i don die when this guy go score goal for us na?

naso we run go peep for the compound gate,
so make we fit collect our ball,

oboy we no believe say we see one old man run come outside carry our ball run enter inside house run close door gbosa!!

Chaiii which kind mad old man be this one na?

Ahhh the thing pain guys,
see come Foremaster Flex Obizlove, you dey very stupid for playing this ball inside this compound so,

see as your leg bend like crayfish make never see morning food chop,

na your type dey go enter motor pay conductor money forget to collect change,

idiot like you nothing you ever sabi do for this your life so,

hahahahahahhhahaha
everybody burst laugh
chaiii this Foremaster Flex Obizlove no just good at all,

naso guys sharp sharp contribute money go buy another ball again,

oboy naso ball start o,
see as guys dem serious die,

before we know naso i give one better through pass to Foremaster Flex Obizlove,

as him trap the ball the next thing make we see na one strange skills make we never see before for our life nahim we see o,

ahhhh people shout,
come o, wetin be this?

Even the strange skills self confuse dem the defenders o,

naso baba use take dribble dem comot,

but the thing make vex me pass na as him catch the keeper again one on one, baba shoot the keeper one eye gbosa!
The keeper faint,

Hahahahahahahahhahahaa
everybody burst laugh
chaiii which kind mad man this guy Foremaster Flex Obizlove be self?

why you no just sabi play ball self?
See come as you resemble custom men make dey work for seme border so, make dey find wetin dem go see thief,

na people like you dey offer their girlfriend to arm robbers dem, at least make dem pity you no rob,

as you carry face like police man make dem never pay salary so,

hahahahahahahhahahaha
everybody burst laugh

naso dem our oponents take change their keeper o,

chaiii we need goals na all this our useless attackers dem,

naso ball start again,
my guy half kilo dribble one guy trow better pass go wing side for this guy Foremaster Flex Obizlove,

naso baba carry the ball dey run,
baba run reach corner kick side,

like so we con dey for box 18 dey wait make this mad man cross the ball enter,

oboy we no believe this guy carry the ball run pass corner flag still dey run dey enter bush,

hahahhahaahahahhhahaaa
chaiii i don die o,
this guy Foremaster Flex Obizlove na big otu,

baba is just too worst for this pitch,

even my grand mama play ball pass am,

as you do face like opiorobo mango so,
you carry teeth like brush make mad man dey use clean yansh after him shit finish,

hahahahahahahahhahaaaa
everybody burst laugh

chaiii abeg baba olowo you too funny o,

i tell una say comon to cross ball this guy no just fit,
na to dey carry big yansh go Bleep,
but to score goal now na wahala for you idiot,

as people still dey laugh,

naso dem ask me abeg baba olowo so you mean say Foremaster Flex Obizlove no see one ball cross enter for once?

Naso i tell dem,
the only time make baba manage cross one ball enter,

oboy we no believe say na baba one leg of boot be that o,

hahahahhaahahahahhaha

see as all of us rush won go nod the boot thinking say na the ball be that,

as the boot fly enter,
even the white china man burst laugh

hahahahhahahahaaaaa
oh my gosh this guy is just too stupid,

hahahahahahaaaaaaaaa

wetin surprise us pass na the white china man say make one guy comot him won play small,

naso dem trow pass to the white china man,

oboy na hand baba use take catch the ball o,
come o na basketball we dey play here so?
hahahahahahahahaha

watch out for episode 56

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Rosemary33: 12:59pm On Jan 18, 2019
Baba the Baba
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:08am On Jan 19, 2019
Rosemary33:
Baba the Baba

my lovely stargirl rosemary you are welcome o,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:10am On Jan 19, 2019
Episode 56
( chaii this white china man no just good )

hahahahaahahahha
everybody for rumours hotel burst laugh,
we even think say the white china man go even good self not
knowing say the idiot worst pass Foremaster Flex Obizlove,

chaiii i don die, and na my team this fool come dey play for self,

naso i dribble finish pass give dem our attackers dem for front,
the next thing make we see na the white china man and Foremaster Flex Obizlove dey drag for the ball o,

naso dem jam head together fall for ground like bunch of idiots,
ahhh the thing vex me die,
i don die today,

oboy naso our oponents dem start to dey play us half field,
oboy we mark ball tire sotey all our boots start to dey hot dey comot fire,

chaiii una don see wetin this mad people cause abi?
all this our useless attackers dem make no just good,

like so we do substitution,
oboy we no believe dem comot my guy half kilo make dey play well put one guy make dem dey call rude king,

ahhh i don die o,
see this overall second otu nahim dem put inside field here so,

naso i yab am,
see come rude king as you do face like medicine after death so,
no come enter here dey trow all those your useless rude passes for
here, make no dey ever go accurate
passes make dey break your own player waist,

as i still dey talk,
naso rude king don collect ball sharp sharp trow one stupid pass to Foremaster Flex Obizlove,

oboy see this kind useless pass make i never see before for my life,
instead make the idiot go pass the ball normal for Foremaster Flex Obizlove,
na him back the fool trow the pass go, naso the ball go meet our oponents dem,

na like so dem use am take attack us go score goal,

ahhh which kind thing be this?

See come rude king,
as you take resemble gbomor gbomor make dey kidnap small children so,
with that your long neck make be like banana mad man chop remain,
na people like you dem dey use exchange collect lighter make all this smokers dem dey use take light their cigar smoke,
as you carry face like toyota old model,
idiot like you,

nothing you sabi do, you and this coward of a guy Foremaster Flex Obizlove,

as una two do head like person memory card make don spoil so,

na thunder make wear short nicker nahim go help us fire una butthole there,

hahahahahahhahahaa
everybody burst laugh,
chaiii why dem no change dem this fools na?
I don die o,

Oboy naso ball start again o,
naso one of my guy trow better pass give that white china man,

oboy we stand for box 18 going to almost 30 minutes dey wait for the white china man make him cross the ball,
chaii the white china man still dey pursue the ball o,

come o,
naso this white china man be self?
See come as you do face like cloth make dem no iron well so,
na your type dem dey use go rent this galagala make dem dey use take comot rubber fetcher make go don fall inside well so,

as you carry yansh dey run like mad man make dey run go togo so,

hahahahahahahahahahhaaa
everybody burst laugh

i tell una say i go buy morning food chop come back the white china man still dey pursue the ball o,
even the defenders dem sidon for ground carry their phones dey chat
with their babes,
the idiot white china man never still catch the ball,

hahahhahahahahaahahaha
everybody burst laugh

chaii which kind bad luck be this?
This white china man no just good,
hahahhahahahahahhaha
people laugh tire,
come o,
this white china man worst o,
na like this dem dey use play for china?
Hahahahahahhahahaha

one bros laugh sotey baba fall for ground,
i tell una say as the white china man finnally catch the ball,
oboy our coach sharp sharp alert referee,
naso dem use take change am sharp sharp o,
before the idiot go help us score own goal for here,
hahahahaahahhahahaaa

we even think say this idiot na football scout self,
why this guy con worst like this?

Na like so ball start again,
oboy we no believe as one of our oponent catch rude king for defence,
even till today i still dey wonder the kind dribble the guy use
dribble the idiot,
oboy naso rude king dive the guy for prick draw him boxers come down o,
sharp sharp dem blow penalty once,

hahahahahahhahha
everybody burst laugh

chaiii rude king no just good,
see come as your name take be rude king so,
na people like you dey go do teacher work make dem dey pay 5000 naira a whole month,
upon the whole shout make you go dey shout to your students dem,
as you do face like gateman make dey work for motuary so,
as you carry chest like mechanic make never see work do since morning,
hahahhahahahahahahhaha

see as people burst laugh for here,
ahhh i don die today o,
i tell una say na like so dem use take loss our keeper score their second goal,
chaiii this our keeper self make short like devil walking stick so,
you no fit ever save us for once?
For my life i never see goal keeper make carry hunch back before,

just imagine all my team mates dem,
no one make no get better problem for body,
hahahahahahhaha
chaiii i don suffer,

wetin happen next you no go believe,

Watch out for episode 57
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 4:54pm On Jan 19, 2019
See as i dey laff like mad man.... Baba u too mush
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:35am On Jan 20, 2019
Tonyspecial:
See as i dey laff like mad man.... Baba u too mush

you go laugh tire baba,
na me dem dey call baba olowo the online funny yabber,

all for the fun baba

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:36am On Jan 20, 2019
Episode 57
( chaii baba olowo don suffer)

hahaahahahhahaha
wetin be all this?
Why all my players dem no just good?

Chaii we don dey two goals down,

naso our coach vex do substitution put Obanla Joseph Oluwatomisin,

as baba enter we no just know the kind wing dem put the idiot,

sometimes we go see am for back of our keeper inside goal post,

sometime again we go see am for attack,

see come you this fool make no know him position so,
as your name take be Obanla Joseph Oluwatomisin so,
no make me swear for you o,
which kind yoruba player be this one self?

You just dey this field na only you dey run left left like peacork so,

hahaahhahhahahahaha
everybody burst laugh
chaiii our team don suffer today,

naso our coach put one other guy make dem dey call Mhista Vickytan Aloyamhe,

as baba enter the only thing make we just see am dey do na to just dey follow the referee for back dey run go anywhere him go,

even the referee confuse ask am,
see come you this guy make do face like jeep old model so,

which one be your own na?
Why you dey follow me up and down like fowl make don mad so?

Oboy i tell una say na sharp sharp our coach take change am put another person,

hahahhahahahahhaha
i don laugh tire for here oooo,
come o, baba olowo naso all this your team mates self be?
no one even good?

Naso our coach put one other mad guy make dem dey call Colbey Alex Xander,

chaii i don die o,
before baba enter naso him ask our coach, please sir i did not get you clearly sir,
you said i should play from the right and at the same time you said i should also come back to defend,please am confused i dont understand sir?

The thing vex me die,
e be like say our coach no hear the guy well naso him tell am abeg go inside and go and play,

naso the idiot Colbey Alex Xander enter field come dey ask me baba olowo please where can i play from?

Naso i shock look the fool,
see come you this premature goat make enter field here dey speak english so,

you think say here na lekki abi na victoria island?

see come you better go mark ball attack go score goal so make we fit win this match,

as you do neck like filling station make never sell since morning so,

na people like you dey go thief person jeans make dem hang outside for rope go sell,

hahahhahahahhahahahha
everybody burst laugh

oboy wetin surprise us pass na anytime make we pass the ball give Colbey Alex Xander,

baba go pass the ball give our oponents dem,
him go tell our oponent please pass the ball back to me please,

hahahahhahahahahahaha
i don die o,
chaii this idiot Colbey Alex Xander no just good,

the worst thing be say our coach no won gree change am comot,

ahhh i don die,
how we won take win na?

As first half won end nahim dem put eddie ola abi na rex v eddie be him name self,

see come you this guy make resemble bush baby pikin so,

you better go front go score goal for us idiot,

hahahhahahahahahaha
see as everybody dey laugh,

naso me i collect ball trow one sweet up pass to eddie ola,

oboy we no believe wetin we see,
naso baba carry the ball dey run,
defenders dem dey pursue am seriously,

the next thing make we see na the idiot don forget ball run enter post,

we even think say the guy don even score self,

na when we see our oponents dem carry the ball dey attack us with full force na that time we know say this guy na big fool,

so this coward eddie ola forget ball run enter post,

chaiii i don suffer,
baba olowo don suffer,
wetin be this?

The thing make surprise me pass na as our oponents dem dey attack us with full force,

i no believe i see all my players dem dey run dey go outside,

ahhh wetin happen?
Abi all this once don mad ni?
Referee never blow half time whistle na,
where dem all this once dem dey run dey go?

Oboy i tell una say na only me baba olowo and our goal keeper nahim still remain for the pitch o,

i don die,
naso i go mark the guy make hold the ball,
naso him pass the ball go meet another person,

na like so dem use passes take turn my eye,
na small thing i for nearly faint,

i still dey wonder my players dem make run go outside,
naso dem shout,
baba olowo comot for field na referee don blow half time na,

naso the referee shout,
see come all of una make do face like crocodile so,
abeg which time i take blow half time whistle now?
Abeg tell me which time?

Hahahahahahahahhaha
everybody burst laugh

and the thing be say dem the fools all of dem still dey outside leaving only me baba olowo with our keeper inside field,

even our coach confuse o,
naso dem our openent won use pass take brake my waist o,

but i still endure dey mark all of dem for inside our own box 18,

i tell una say no other person dey make go follow me mark the ball,

naso dem use me play tire,
but i still dey mark,
both the once make dribble me i see star,
and the once make height me join,

oboy naso referee see say dem no won score baba vex blow half time whistle sharp sharp,

hahhahahahahahhahahha

wetin happen next you no go believe

watch out for episode 58
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 3:23pm On Jan 21, 2019
Episode 58 (na me dem dey call baba olowo)

hahhahahahahahahhahaha
everybody burst laugh
chaiii wetin be this?

why dem all my players run comot from the pitch when the referee never even blow half time whistle self?

as i dey waka dey come outside dey vex,

naso one of my player con shout,
see come baba olowo,
this one way you dey waka like ostrich make dey see menstration so?
Wetin happen na?

Naso i vex answer the guy,
see come as you carry face like person make dey train cow so,

na your type dey sell orange for bustop,

i no blame you,
your people for use you do sacrifice when you small take cleanse the evil of the land,

as you carry hunch back like kick and start motor so,

hahahahahahahhahahaa
everybody burst laugh

naso one other of my player talk,
abeg but we think say we hear the referee blow half time whistle na?
Wetin come happen?
Thats why we run come outside na,

chaiii the thing vex me baba olowo,

see come you this guy make resemble wetin dem use stone devil so,

na people like you dey go hang for back of big man jeep dey go work,

as you do teeth like fowl yansh heavy breeze blow open anyhow so,

na your type dey go deposit money for bank forget to collect teller dey go house,

hahahahahahhahahahaha
everybody burst laugh,
chaiii i don die for here,

naso our coach shout,
see come as all of una take do face like panel beater so,

na people like una dey go do brick layer work dem go pay 500 naira for the whole day,

as una do teeth like goat make just dey recover from strange illness so,

hahahahahahahahahaha
everybody burst laugh,

naso our coach talk say him go put 3 players dem,
youngzubi,centino and sokodobo,

naso i look dem troway face,
see come all this three wise men make dey for bible so,

as una do face like people make never chop food since morning so,

make una no enter this field dey play rubbish oooo,

expecially you make dem dey call sokodobo,

as you take do face like antelop make dem won play him retirement match for so,

na your type dey go Bleep babe under person motor,

as you carry eye like table for 5 for rumours hotel here so,

as this your name sokodobo take resemble all those names white man dem dey give all those their slaves for olden days,

as you do face like cotonue visa,

no go embarrass your self inside field with this your thin leg make be like wetin dem dey use hang cloth for outside,

as you do teeth like chewing stick old woman chew remain,

na your type dey go do bakery work make dem dey pay salary with bread,
the manager go say abeg make we dey give am bread if him work finish won go house,

shey be na you go write one story book make dem dey call beneath my heart?

I tell you say the next one make you go write the name go be beneath my yansh,

hahhahahahahahhahahahaha
hahahahahhhahahhah
everybody burst laugh,
chaii baba olowo your mouth no just good,

naso i face centino,
see come as you take do face like person make dey sell mosquito insectiside so,

na your type dey go do confession for church, confess only half of their sins,

as you carry chest like rat medicine make no dey work,

na still your type dey go do soldier work for 10 years dem no go won gree promote give you any rank,

as you carry eye like plastic chair make don break,

no go enter field go play like person make get kwashoko abi na warakpa oooo,

hahahahahahahahhhhahahahaa
everybody burst laugh
chaiii i don die o,

naso i face youngzubi,
see come as you take do face like palm kernel so,

na people like you dey go thief all this aboki beggers their money pick race run,

as you carry teeth like generator make dem never service since 8 years now,

na your type dey go work for company dem make dem dey ricycle dust bin,

as you carry yansh like singlet make mad man wear finish troway,

na your type dem go post as soldier go boko haram sambisa forest,
na for road you go pick race run go house say you no do again,

as you carry teeth like all those olden days gun make person go first crack before him shoot only one bullet,

no go enter field dey go jump like antelop make just go do traditional marriage for village oooo,

as you do face like ikemefuna story book so,

hahahhahahahhhahahaha
everybody burst laugh,
naso one bros laugh finish turn deaf and dumb,

umumumuuummmuumhhyu
umuumuhnmuuuuumuuiuiou

hahhahahahhahahahaa
everybody laugh tire
chaiii baba olowo you too funny abeg,

see come you this bros make do head like old antenna make dem won change buy new one so,

abeg laugh responsibly oooo,
no go laugh go troway dog make hungry won kill food oooo,

and una know say the dog never chop for 3 days,

hahhahahahahahhahahaha
chaiii baba olowo you too funny,
abeg you go school of yabbing?

Naso the referee blow whistle,
say make the both teams dem enter pitch,
second half won start

naso all of us enter pitch,
my coach come shout,
abeg baba olowo go play attack for me,
see come you this fool Colbey Alex Xander go play defence,

ahh wetin happen next you no go believe,

Watch out for episode 59
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by SokoDobo: 4:19pm On Jan 21, 2019

Well done
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 9:16am On Jan 22, 2019

good update
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:07am On Jan 22, 2019
Well done

thanks sokodobo baba,
really appreciate your understanding here

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:08am On Jan 22, 2019
Tonyspecial:
good update

nice one brother,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:10am On Jan 22, 2019
Episode 59
(come o,baba olowo don score hattrick o)

hahahahahahahahhahhaa
everybody burst laugh,

chaiii so na baba olowo now won go attack for dem the fools,

hahahahhahahahahahahaha
see as people dey laugh,

oboy like so the game start again o,

naso centino make do neck like person make dey find brick layer work since 2 years so,

him trow one sweet pass to me baba olowo,

sharp sharp i control the ball dribble 2 defenders shoot the ball enter post,

its a goooooooaaaaaaaallllllllllllll
chaiii baba olowo don score ooooooo,

see celebration for everywhere,
you too good

naso dem pass for middle,
sharp sharp dem attack us won go score goal,

oboy we no believe dem our defenders dem collect the ball trow long pass to me baba olowo for attack so,

as a bad striker i be na,
like so i control the ball come down carry the ball dey run with full speed paste their only one defender,

as i catch the keeper one on one naso i give am all those lionel messi small chiping highting dem,

the keeper see only butterfly catch,

hahahhahahhhahahaha everybody burst laugh,

its a gooooooaaaaaaalllllllllllll
baba olowo don score again,
baba you too good,
we love you baba,

ahh baba olowo don kill us,
under 5 minutes into the second half baba olowo don score 2 goals already,

chaiii is this for real abi na joke?
i tell una say this thing happen for my area live,

oboy life tire our oponents dem,
see as i just dey dribble all of dem comot for road anyhow so,

comot for there you dey smell beans beans,
comot for there you dey smell akara,
comot for there you dey smell fish roll,

ahhhh see as i dey dribble dem like fully grown fools dem be,

as i catch their keeper one on one again i no just believe my eyes,

chaii na my own men make dey play our defence,

all the way from our own post run come clear me craze fall for our oponents their own box 18,

hahahahahaaaahahhahahaha
everybody burst laugh,

naso the referee blow penalty sharp sharp ooooo,

hahahhhaahhahahahahah
i don die o,

oboy dem our oponents dem rush the referee dey shout o,

see come referee na him own men come clear am na,
no be our player be that o,

oboy the referee eye shine o,
ahhhh i don die, and i don already blow penalty na,
chaii nothing fit make me cancel am na,

i tell una say that our stupid defender make run all the way from our post come clear me down so,

him name na rude king,
as the idiot take rude die like letter make mad man write put inside envelop so,

baba come ask me,
abeg baba olowo na our own post be this abi na our oponents their own?

As i dey here so i confuse o,

naso i look the idiot laugh,
see come as you do face like lamp holder so,

na your type dem dey use take fire prayer point,
immidiately the pastor just sight you baba shout please church lets pray for any demonic setback in this our church,

as you do eye like cat make no dey see clear for night,

naso one bros ask me abeg baba olowo who tell you say cat no dey see well for night?
Na lie joor all cats dey see well for night,

hahhahahahahahahahahahahha
thats why i yab the fool the oposite na,
because i know say all cats dem dey see clear for night,

hahhahahahahahahahhaahaaha
everybody burst laugh,

chaiii baba olowo you too much abeg,

naso i set the ball well because na me go take the penalty,

as i won play the penalty,
naso sokodobo my own player yab me,

see come baba olowo,
as you take do face like plastic plate so,
you better score this goal oo,
if not just follow from here dey go your father house,

as you set yansh so,
like person make all this gay men dem hang for bush dey Bleep,

as you do teeth like arjen rubben left boot for bayern munich football club so,

haahhahahahahahaha
see as everybody burst laugh,

but the thing be say i no just hear the idiot well o,

because all my mind just dey just to score that penalty,

sharp sharp the referee blow him whistle,
naso i close my eyes come breath in and out,

open my eyes with full speed run play the penalty loss the keeper,

i tell una say as the keeper dive go left we no see am again o,

baba dive comot from the pitch,
till today we still dey find the keeper we no see,

ahhhhh wetin happen na?

Oboy naso the whole crowd shout dey rush me,

its a goooooooaaaaaaaallllllllllllll
baba olowo don score the winning goal o,

see celebrations for inside pitch,
baba olowo don score hattrick o,

oboy i tell una say till today i never still imagine the kind ball this people give me go house so,

i tell una dem patch patch this ball sotey dem write am for the body please bear with us abeg na for dust bin we see pick this ball o,

hahahhaahahhaahahhahaa
hahahahahahahahahahah
everybody burst laugh,

abeg see ball dem dash person make score hattrick,

chaiii baba olowo don suffer,
oboy na like so i take turn celebrity even till today for my area here so,

abeg my fans dem to reach episiode 60 no easy o,
abeg make una try send me baba olowo even if na recharge card o,
its not easy,

watch out for episode 60 titled (baba olowo @60 )
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:32pm On Jan 22, 2019
Will be droping my next episode titled (baba olowo @60) it might probably be my last episode,

abeg if i don yab you before for this my story please forgive me,
am on my kneels abeg,

its been a long road but we are here now,
but if una still want me to continue again to dey post the story then i fit consider,

una know say this story is strictly to make everybody to dey happy dey shine teeth so we can get to forget the days stress after work,

seems the comments here is too dull for my liking,
i get life to live,

anyways peace out

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:01pm On Jan 23, 2019
Episode 60
(baba olowo @60)

hahahahahahha
see as everybody dey laugh for rumours hotel here,

naso person shout,
so baba olowo you won tell us say na you score the hattrick goals may make your team win una match abi?

Naso i answer the guy,
see come as you take do mouth like bottle water so,

you no know say me baba olowo i good die for football?

Well i no blame you,
as you do face like balb wire all this big men dem dey use fence their house,

hahahahahhhahahaha
everybody burst laugh,
chaii baba olowo your mouth no just good,

naso one other guy make dem dey call Nwankwo Greenbon shout,

see come baba olowo as you take do yansh like cele prophet so,
which one be this one again make you title this your episode baba olowo @60 so?
Abeg you don reach 60 years?

Hahahahahahahahhahaa
chaii baba olowo na old man be that o,

naso i answer the idiot,
see come Nwankwo Greenbon as you take do face like mtn sim make no gree register so,

na your type your people go carry go market go exchange carry ugly monkey come back house,

your people go say as far this monkey fit dey help us dey go message abeg we are ok like that,

as you do teeth like gani jumor street for my side here,

you carry belle like old time kidnapper so,

see your name self Nwankwo Greenbon,

as you take resemble person old fowl make green so,

hahahahahahahahahahha
everybody burst laugh
abeg baba olowo you don ever see fowl make green before?

Naso i answer the guy make talk am,
baba name na Destiny Tony,

see come destiny tony,
as you take do face like wetin oracle reject so,

i no know wether you be destined fool abi na hungry just dey catch you?

as you carry hunch back like devil handkechief so,

hahhahahahahahahhahaha
see as people dey laugh dey get craze join am,

hahahhahahahahahahaha
one guy make dem dey call Olubuade Natty laugh sotey baba fall for ground still dey laugh,

chaiii baba olowo you too funny abeg,

naso i look the guy laugh,
see come Olubuade Natty as you take carry chest like madman playpant so,

na your type dey pursue old man fowl so you fit thief the one leg go cook chop,

as you do eye like okadabooks their book store where dem dey sell plenty books,

na your type dey hang babe on top tree Bleep,

hahahaahhahhhahahaa
see as people dey laugh
chaii baba olowo you no go kill us today o,

naso one other guy make dem dey call Rude King shout,

see come baba olowo abeg na your final episode be this?

Oboy i tell una say wetin we hear next na hot slap for rude king eye gbosa!!

Ahhh wetin happen na?
Oboy na one bouncer make get mental problem sound craze comot for baba eye o,

naso the bouncer shout,
see come rude king na thunder make wear baggi nicker nahim go fire all your teeths there comot,

so you want make baba olowo stop to dey update us this him funny jokes dem everyday abi?

Oboy naso i tell rude king,
see come as you take do face like juju pot so,

na your type dem dey use take dey act babalawo for all this nigerian yoruba films dem,

as you do eye like gran chako field for inside playstation 2 so,

i tell una say gran chako field worst die,
see as the field white like belle medicine,
noting like grass there,

na your type dey go enter public bus dey claim staff make you no even be,

as you rude die like person make dem give 9 wicked injections for belle so,

hahahahahahhahhahahaa
everybody laugh tire,
chaii baba olowo abeg leave rude king alone o,

as we dey laugh dey catch fun,
oboy we no believe we see 5 policemen with Nwauzor Vincent Ikechukwu enter rumours hotel,

naso the policemen dem shout,
see come who among una here dem dey call baba olowo?

Oboy everybody run point Aikoriegie Solomon say nahim be baba olowo,

chaiii i don die o,
hahahahahhahahhahahaha
see as people burst laugh,

oboy the thing confuse Aikoriegie Solomon,
baba dey look no believe wetin him dey see here so,

naso one guy stand up shout,
see come Aikoriegie Solomon as take do face like left and right shoe make don spoil so,

na your type dem all this old aboki beggers dem dey carry,
so you fit dey help dem dey beg money,

as you do teeth like china phone so,

hahahahahahahahhhaa
everybody burst laugh

naso Nwauzor Vincent Ikechukwu make carry policemen dem come shout,

see come baba olowo as you take do eye like cow make no fit swim water so,

shey be na because of all this your funny story dem nahim make i loose my job,

upon say dem sack me 2months ago since that time i never fit get chance go find another work,

all because of say everyday i go come here to come read your funny story dem even forget all my stress and worries,

this your story dey make person forget him worries dem too much,

abeg baba olowo na by force to forget my own stress self?
Abeg leave my worries for me o,
so i fit vex go find work o,

everyday na so so laugh i just dey laugh dey forget say dem don even sack me for work self,

thats why i won use this police dem arrest you,

oboy like so dem the police carry Aikoriegie Solomon go prison o,

watch out for episode 61
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:27pm On Jan 23, 2019
See come all this ghost readers dem make do face like evangel F kennedy so,

na una type person make get pimples go see get hope,

una go read finish common to comment go hard una,

as una do yansh so like dry leaf,

abeg make una try dey comment for here na,
thats the only motivation i dey ever get to dey compose this stuffs for here so,

i need una comments not read and go like say e no consine you,

abeg na me dem dey call baba olowo,
all for the fun baba,

baba olowo

(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) ... (22) (Reply)

Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him / Rhoda / African Nerd

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 240
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.