Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,367 members, 7,808,282 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 09:50 AM

My Life At DESPO By Whizkidefe - Literature (51) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / My Life At DESPO By Whizkidefe (237296 Views)

Unknown Destination (The Hellish Life At The Orphanage) / ''life At The Top Cold Night" Is Their Anyway I Could Get This Book For Free (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (48) (49) (50) (51) (52) (53) (54) ... (59) (Reply) (Go Down)

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by chobov123(m): 1:10pm On Jan 30, 2019
if I no dey dis small large community Wetin I gain
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 12:35am On Feb 01, 2019
wink

Happy New Month, Lovely readers wey dey burst brain..

Your Month of Confirmation$ is here.. cool

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Nobody: 10:34pm On Feb 03, 2019
Bob @WHIZKIDEFE I hear say DESPO done call off strike... Abeg how true is this?
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by favch(f): 3:46pm On Feb 06, 2019
yea am back for good, be sorted myself out Efe, oya come n welcome Mr��
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 1:24am On Feb 07, 2019
Greetings from Me2u all my people in this our rented E-community grin . It's not like I have abandoned the story o, but having spare time is a luxury to me right now (shey you understand?) .

As money nor dey fall from heaven so, the boy gats hustle to get funds to take hold body and soul 2geda and tidy one or two matters. (You dey feel me abi)


Learning how not to be broke legitimately is not easy, haven't been easy and won't be easy but, it's worth it .

Nothing good comes easy, cos if e easy, e nor go make sense cos most times, what comes easy won't last and, what last won't come easy. (You dey get abi?)

E no easy o, (ask P'Square) cheesy . If e easy, check well. If nor be Grace , na Set up o . grin

Last-last sha, We Go Dey Alright wink


I'll try to drop an update before the week runs out, thanks for your understanding, ona be the best!

Chobov123, bigtotoboi and favch, I sight you.


Moving to our permanent site just dey hungry me these days o, here go con be our branch. cheesy


We dey 2geda.
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by cue64: 1:59pm On Feb 09, 2019
WHIZKIDEFE:
Greetings from Me2u all my people in this our rented E-community grin . It's not like I have abandoned the story o, but having spare time is a luxury to me right now (shey you understand?) .

As money nor dey fall from heaven so, the boy gats hustle to get funds to take hold body and soul 2geda and tidy one or two matters. (You dey feel me abi)


Learning how not to be broke legitimately is not easy, haven't been easy and won't be easy but, it's worth it

Nothing good comes easy, cos if e easy, e nor go make sense cos most times, what comes easy won't last and, what last won't come easy. (You dey get abi?)

E no easy o, (ask P'Square) cheesy . If e easy, check well. If nor be Grace , na Set up o . grin

Last-last sha, We Go Dey Alright wink


I'll try to drop an update before the week runs out, thanks for your understanding, ona be the best!

Chobov123, bigtotoboi and favch, I sight you.


Moving to our permanent site just dey hungry me these days o, here go con be our branch. cheesy


We dey 2geda.
oshare ur number nor Dey show for what’s app oh try reach me nah
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Samfee001(m): 2:25pm On Feb 09, 2019
Las las ah don reach dis stage of the tori, whizkidefe, you dey try gan. Though yur life for dis tori dey smhow o, ah still dey try define the kine pesin wey you be.
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 2:44pm On Feb 09, 2019
Samfee001:
Las las ah don reach dis stage of the tori, whizkidefe, you dey try gan. Though yur life for dis tori dey smhow o, ah still dey try define the kine pesin wey you be.
If I be course for school, no matter how you study me reach, you nor fit pass me o. wink

Nor try am sef.. grin

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Nobody: 3:20pm On Feb 09, 2019
WHIZKIDEFE:
If I be course for school, no matter how you study me reach, you nor fit pass me o. wink

Nor try am sef.. grin
cheesy
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Samfee001(m): 8:40pm On Feb 09, 2019
WHIZKIDEFE:
If I be course for school, no matter how you study me reach, you nor fit pass me o. wink

Nor try am sef.. grin
I laugh in latin, d tin be sey ur story n my lyf get some similarities. E jst dey b me lyk sey na me u dey write about. Buh no worry, ah must see dis tori to the end.

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 10:45pm On Feb 09, 2019
Before i continue, lemme use this medium to say something that has been annoying me for soe time now. Yess, d tin dey vex me.

If you’re a matured man and you still carry all these under 18yrs old girls in the name of ‘emie-emie(sweet sweet)/tight puna/ loyal’ or whatever name you choose to sugar coat your senior-man degrading act.

I just want to let you know that ayam vexing for you, yess, real vex o, the kine vex wey fit blow transformer, you are among the reason Nigeria is not moving forward.

Imagine if those small girls don see your ‘matured ‘gbola’ finish, dem no go con dey get regard for their elders again, unto say dem don see the unclothedness of bros like you wey we dey give maximum respect for the street.

Shey ona dey see wetin ona don cause? Ona dey angry me, wetin do ona mates?

If I say may your daughter be treated the way you treat other people’s daughter(s) now, will you gladly say YES?

I’m not a saint.(and I don't intend to be one), make you nor go dey think say I dey form holy o.

I just don’t like seeing matured guys carrying girls the age of their younger siblings, dat tin na big fvck up, believe me.

Most matured guys go for this small gals cos they're easy to get. ( o.wrong nau)

What happens to going for girls your age or above the 18yrs bracket?

Smallie wen neva get sense na you con dey run her show... (smh for you)

Cos she's yet to be fully matured, won't see the advances as wrong, rather, she'd enjoy the attention cos she'll be thinking she's matured...

Wrong attention at the wrong time. And most times, after they taste have a taste of the forbidden fruit... There's no going back for them.
(That's how they become loose-gals)

The worst part be say, if you dey roll withyour guys and you dey arrange dat smallie on code, she go dey use dat eye tey dey look your rest guys, she go dey think say na so all dem dey do, chai!

Guy, if you doing that, stop eet!

Get some standard, you're not that cheap.

Leave minors alone, no matter how matured and well built they may look.

Go for adults and adults only.

Not just any adult sha... I won't impose my spec on you.

If you like go for low quality females, it's your life- Enjoy! (As far she isn't a minor, no wahala) grin
……..

Update is here as promised


Continuation.
‘bros, clam down na, wetin be your stress sef, abi you don give the babe line before she no gree?’ I asked while I dodged his playful blow.

‘ Efe nor loose guard dat babe o, from wetin I dey see, she like you and her mind don full am,’ my broda advised while we were sited alone in an area o the pool section.’

I listened halfheartedly but paid full attention on the other babe and her friends, she somehow got my attention and I felt I was temporarily attracted to her assets and cute smile. I was ’lust in love’, don’t look at me like dat. (somebody please what is the definition of lust again?) Lol

I decided to meet her up there but I stayed back while I weighed how she might react. The presence of her friends and the awkward position she must had seen me with Bee’s friend the few times stole some look gave me concern.

………..
The best moment to approach a babe is when she is alone cos if in company of her friends, one or two ‘bad belle’ among them might just pass bad energy that will make her give you wrong vibe, even if she is interested.

Sometimes, the risk is worth taking, mostly if you won’t get to see her again, she might be your missing rib, who knows, love could be found in strange places. (SENSE101) lol.

………….
‘as you don get wife so, no worry, I go stil see my own’ that was meekest in his attack activated mood(I nor know wetin I do d boy sef o) lol. While we talked, Bee came around and asked about the where about of her friend. ‘am I your friend’s keeper,’ I asked in my mind while I pointed towards the changing room. She climbed up and went to meet her up, to gossip I guess. (gossip in some baes DNA by default) lol.

When Bee left, I zeroed my mind and swam to meet the other bae. ‘ hello cuties, lemme borrow your friend for some time, I promise to return her in one piece, ’ I said while I held her hand and moved her away from her squad. She hesitated a bit (initial gra-gra) before she followed me.

I was speechless like MJ at first. You know that awkward moment you were caught stealing meat, and you don’t if you should start explaining what led you to the pot in the first place or eat the meat and face the consequences after all ‘all die na die’ cos beating must involve whether you eat the meat or not.. lol

She kept quiet, while she stared at me, waiting for me to say something. Her silence was sending chills down my spine, before I complimented her playful nature and how she’d successfully stolen my attention with the innocent glances she stole, she grinned.

While she smiled, I told her I would be coming for her on Monday, and asked where and when will I meet her. ‘I’ll be in the lab anytime from 3pm,’ she replied before she suggested I come after her practical session. I told her to expect me before I took her back to her friends. (Mission Accomplished)

I went back to meet the baes and my guys taking pics and I joined o. Bee’s friend found her way to my side and we took pics. I kept my phone, for where? Babe no gree o, she insisted on using mine.

After every-every, I told her to bring her phone so I could transfer her selfies and the pics we took together, lai-lai, she no gree. Babe said her phone’s ba3 wa dead that I should send them to her on Whatsapp,' was her reply as she collected my phone, added her number and sent the pics herself. (see format, the bae sharp) lol.

That’s her subtle way of collecting my number, but I just lock- up like say I nor code wetin she do. She could had just sang Simi’s ‘Joromi’ for me and I would had gladly given her without having second thought. Lol.

Shout out to Simi and all the bold girls out there, you guys rock! cheesy

Bee, her friend and my brother’s left before us to prepare food for the boys. I didn’t bother to collect the other babe’s number . We stayed and swam or a little while before we went home.

The aroma of ‘Ogbolor’ soup welcomed us as Meekest and i entered Bee’s room.
‘Where is my baby?,’ Bee asked after some time. ‘he is in the station,’ I replied with a sad countenance, as the plate she held fell from her hands.



To be continued.

2 Likes

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 12:01am On Feb 10, 2019
Mood cool

Listening to a blind man whose talent and songs could see..

Starlight dey blow my mind..

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Tuhndhay(m): 7:38am On Feb 11, 2019
Good to be here
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Nobody: 1:23pm On Feb 11, 2019
Abobi afta all dis wait na dis small update u give us tk hold body.....u try bt weeee neeeeddd mooore
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by peterafo: 10:37pm On Feb 16, 2019
this update ona too small na
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 4:53pm On Feb 19, 2019
Its been a while o, abeg make ona nor vex. Ona don suppose know wetin dey sup. Lol. Actually, I typed a lengthy update on the 14th, na so anti-spam bot tey ban me for wetin I still dey try know the reason.

Painful part was that, I typed straight from the browser, before I reload page, everything wey I take time type don disappear, omo, na so I just weak like who electric shock. All those tins dey make person wan stop to update till I get my own site but, dat devil is a liarr.. E nor fit stop me from delivering update to my correct readers that have sense! Lol

February 14th is AKP’s dating annivasary, let me tell you how it came to be… I’m talking about it cos everything happen for DESPO dat year.

we go con

One for the road wink

On that cool evening, the freeze was gently caressing my skin while I sat outside with my ear piece plugged in my ears, listening to a naija mix on my phone.

‘fine boy, how far you na, why you just dey here on your own? You suppose dey one side with your baby dey do one or two activities na, abi you nor know say today na Lovers day?,’ That was my caretaker, addressing me, with a wrap of burning weed in one hand and a mini pack ‘alomo bitters’ on the other hand.

‘Oga, so na only 1 day lovers get out of the whole 365 days abi?,’ I wanted to ask him but restrained myself cos, if I did, it’s the weed he had been smoking that would had replied me, through him. ‘Keto, I hail o, you just dey like yourself with kush and alomo dis evening o, I like your style o,’ I replied changing the topic.

‘my broda, wetin man go do na? as money nor dey to buy champagne and better cigar so, make we do th one wey power reach until Oluwa go bless us na,’ he replied with a smile, exposing his weed stained teeth and black lips. He carried his plastic chair to where I was and sat close to me.

‘ dis one wey you just dey on lowkey like dis dey press your phone so, e be like say you dey chat your work o,’ he said after some minutes.

‘Hey God, who send dis man com outside com disturb my peace na?,’I complained within me as I made plans to go and relax inside my room, to enjoy my me-time.

While I was about leave him, a red ‘Toyota Spider’ drove towards us with full speed and halted by our lodge. When the stopped 2 girls, stepped outside and ran inside our lodge.

‘who be those ones wey just run inside the lodge so?’ Keto asked as he stood up and marched towards the lodge as if he wan go fight, to know the identities of the people that just entered.

The guys in the car opened the doors of the car and increased the volume of their car stereo.[ dat we dem boiz doinz]

About 5mins later, the girls walked outside and that was when I realized that they were my neighbors. They wore a red top over a white bum shorts. They entered the car, and the sped off just the way they came.

‘ na so, wen dem don flex dem finish, na their ‘down side’ go feel the heat later,’Happy remarked while he sipped from his sachet of ‘alomo’.

I was streaming a movie when a text popped up on phone. I was about to swipe it away thinking it was those nonsense service provider spam messages when I saw the sender’s name, AKP.

I clicked the message, the content was; ‘ Efe abeg come block me for ‘Galaxy Baze’, na me and that babe dey now and I nor like as tins dey go, com assist me bro, please be fast.’

I read the content of the message over and over again before I sped to the bathroom to freshen up. The text was an emergency back up call. Before my guy use pidgin tey start the message con end am with correct English so, I know say situation go don critical. (who say woman no get power? If i hear)

I freshened up with the speed of light, wore a combat nika and a shirt. I looked at myself on the mirror and my reflection smiled at me and said, ‘you dey well, boy’ while I wore my perfume.

I look myself again, and thanked God for taking his time to create me….. wink I confirmed that I was okay, who knows, I fit jam any potential wife material or babe for there, so the boy gats bam..( shey you dey feel me?) lol

The bar they were was trek able but the urgency of the situation demands I took bike, before situation go con wear pant cheesy. The way I ran towards my junction hoping to get bike, people may had thought I was chasing my destiny.


To be continued..


Tuhndhay, ladidacanon and petarafo, i hail o!

2 Likes

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 9:52am On Feb 20, 2019
@Divepen1, thanks for the unban. You too much! cool
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 8:13pm On Feb 23, 2019
Still on AKP's Love Story wink

I finally got to the bar, Galaxy base was bubbling that evening. Guys and babes could be seen at different spot, drinking or eating and gisting. The dj was doing in a nice job. Some babes and guys were on red and white, dem oshey ‘lovers’. Arsenal and Man U jersey dey sell well dat period. cheesy

I saw some peeps and baes I knew, I just smiled my hello with a wave while I scanned the bar to locate my nigga. He waved at me from one end before I walked towards their table. I greeted the bae and she stretched her towards me for a handshake which I subtly declined with a ‘ I don’t shake hands with baes’. She smiled before she stood up and gave me those ‘Deeper life’ kind of hug.

‘hug me well joor, do I look like a deeper life member, are you a learner?,’ i said while she laughed and hugged me properly , AKP laughed. ‘ oya its do, before my brother wee com and press my neck in the night, thinking I want to steal his wife from him,’ I remarked while they both laughed out loud.

‘K baby, so you are the one my brother had been dreaming about all these while, na wa o, and I dey plan to date you for my mind since o, chai!’ I said while a bar attendant brought my ‘mortuary standard’ chilled bottle of Heneiken.
The Dj was doing a good job while i moved my body to the low (music wee not kee me) lol.

I picked my phone and scrolled through my contact list to call any of my female friend to come balance the equation but, I decided against it cos I haven’t accomplished the mission that brought me there.

‘ K bae, do you have a sister?,’ I asked out of the blues. Akp gave me that ‘no come spoil my show’ look while I winked at him. K didn’t reply me at first, she stared at me, wondering where I was driving at. ‘I don’t have a sister, I’m the only girl child in my family, why?,’ she asked.

*cleared throat* ‘well, I asked cos I felt it wouldn’t be bad if my brother and I marry from your family. Since he don get you so, and you nor con get sister wey I go marry, you go con give me one of your friend be dat o,’ I said and cleaned my mouth while I waited for her reply.

She laughed and voiced an ‘OK’. I won’t take that, we gats put it into writing or I’ll have to record you, as evidence, just incase you decide to change your mind and play me wayo later on,’ I replied. We all laughed while I got up to give the lovers a bit of privacy.

When I got outside, I dialed Meekest’s number, he picked at the second ring. ‘ Efelism, I don dey call you since but your number no dey go, dat your nonsense lodge wey network nor dey so….’ He was attacking immediately he answered the call before I interrupted him.

‘dis respect wen you nor get for your elders so, bad wel-wel o and if you continue like dis, you nor go live long o. where you dey like dis?’ I asked him, laughing.

‘Omo, me dem OBO and Owos, we dey the Valentine show for Legit, like dis with some babes o, fall in na, na Erigga wan perform so o, I don reserve your space o, where you dey?’

‘bros, I dey Galaxy Base, I con tidy one matter first, if I finish I fit com block ona.’

‘ok, no wahala, we dey wait you.’

When the call ended I received 2 text messages from two different numbers. I was reading the first love related text when Akp flashed me. On my way inside, a number called me, and I had to go back outside cos the music was loud inside.

‘Happy Valentine, baby. Where are you?,’ a female voice sounded from the other end while my brain got activated in trying to know who the owner of the voice could be.


I will try to end this chapter' AKP's Love Story' chapter Tomorrow so we can continue from the main story. wink

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Slimynonny: 4:32pm On Feb 24, 2019
I have been a ghost reader all these while bt i cant anymore......abeg this piece of work make brain die.....bros op i hail oooo carry go nothing do you...... Na beg i dey beg ooooo see bros eehn overdose no go fit kill me...so i need some more. Kudos
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 2:17pm On Feb 25, 2019
Back to the matter


‘hellooo, are you there?’
‘yes, good evening, how are you doing?,’ I said, in an attempt to buy time, trying to decipher the owner of the voice.
‘ I’m good, I have been expecting you’re a text or call from you, but since you didn’t I decided to check on my baby boy,’ she said, giggling and I finally knew her identity.

‘ that’s nice of you, baby girl, sowie I couldn’t call, don’t mind me joor, how are you enjoying your evening?’ that question was my first mistake.

‘ my evening is boring, I want to be with my lover,’

‘ call him nau, a fine girl like you isn’t supposed to be bored on a day like dis,’ I remarked, while I smiled.

‘ thats why I called you na, where are you joor, let’s go have some fun at the lovers show at De’Legit,’

‘Since wen did I became your lover? don’t allow your boyfriend to hear what you just said, besides, I can’t go to De’Legit right now cos my account balance battery is low,’ I said teasingly, hoping she would let it slide. (if e nor dey, e nor dey, why I go boast put?)

‘ your account balance is none of my business, did I complain about money? Give me your location lemme meet you joor,’ she countered me while she laughed. I told her I would get back to her but I don’t think I would go the hotel, before the call ended.

I went back inside the bar, AKP and K were talking when I got there. K asked me where I have been all the while. I told her I went to inform our family members that AKP has found his missing rib and they should prepare cos we would be coming for her introduction anytime from now. She smiled shyly and looked away.

I shifted my chair close to her. ‘I just want to thank you for putting a smile on my brother’s face, I don’t know if he’d told you anything, but I just want to let you know that he has been nursing feelings for you for a long time now, and the feeling is genuine, not the hit and run, believe me,’ I paused for her to digest words I just said. I winked at AKP, signaling him to excuse us for a while.

When AKP left, she asked if I was serious about what I said. I affirmed. Fact was, I knew her before, even if we were mere acquaintances. I got involved cos AKP and K had been friends for a while and he had been telling me about his feelings for her prior to that day.

‘I wouldn’t pressurize you to go against your wish, but, I wouldn’t want a situation where we’ll waste our time,’ I said cos there’s a difference between being patient and wasting ones time.

She was quiet for a while, before Akp came back.

‘I have a confession to make,’ she said with a blank expression on her face. Akp and I looked at each other. One thing about such statements is that, they tend to make your mind run through different wild scenarios.


lets continue later.
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 7:49pm On Feb 25, 2019
back to the matter

-----
Toasting a girl is not for the weak minded, you gats learn how to deal with rejection first(very ‘importanter’). When wooing(gisting) a girl, there are always two options. Its either she accepts, or she declines. If she accepts to date you, good and fine. If she declines, you gats move on, nor be be quarrel or fight. (you win some, you lose some). only weaklings take rejection(s) personal.

if out of the thousands of babes around, one rejects to date you and you start behaving as if the world is finished, then your mumuness is out of this world, dem gats check you cos you are not normal.

Although, its not every girl that you have to ask to be your lover. With some, you guys just connect and go with the flows (no will you be my girlfriend? talks). While some, no matter the level of flow. You guys may had even ‘uhumm ehen’ and do all the things meant for lovers sef, but, they wouldn’t see you as their lover until you ask them them out, officially. ( Oshey team official lovers)
-----
‘okay, I will think about it,’ came her reply. That word don’t always go down with me, I don’t know why. Maybe because I think, if a girl will accept to date you, she already knows from the second you approached her (that’s if she isn’t already in a relationship) . All those ‘lemme think about it na format’. Not in all cases though, most times.

'Akp is my baby boy right now but i get to say this so that my mind would be free,' she said. I felt like she should spill whatever she had to say already, i nor dey like plenty drama.

‘Efe, I have been crushing on you all these while, just that you don’t seem to notice, and even if you did, you’ve been styling,’ she remarked. My thoughts froze, while I smiled, speechless. (I didn’t experrerit)

‘ don’t mind him, that how he use to do, with his small head!’ Akp fired at me jokingly while i was still in my speechless mood.

Fact was, K was a friends crush back at home, and we used to be’ Hello, Hi’ acquaintances from distance. She was my kind of bae.

She was naturally cute with her ‘Anita Baker' hairstyle,got the assets,intelligent plus she can smile for Africa too.

‘if you had made this confession earlier, I would had proposed to you with the diamond ring I had been keeping for my future wifey, immediately. Nevertheless, I’m happy though, at least, na my family you still dey las-las, it’s a win-win situation,’ I said with a wink, immediately I found my voice.

The lovers held hands while they whispered between themselves before I stood up and gave them some space. (Some times, 2 na company, 3 na crowd) wink

I went to the other side of the bar, where the MC was doing his thing to spice up the show there. The name of the game going on was devils number (you'll be dared to anything written on the piece of paper you pick from the basket that goes round randomly, or bail yourself with some cash).

That game is not for the weak minded and broke cos you gats do what you are asked to do if you can’t bail yourself. My pocket wasn’t kukuma strong that evening, so I left that zone, befor e go over me. (nor me dem go tey catch trips).

I went back to our table, love was in the air. I sat down and brought my phone out to keep myself busy. I signaled the bar attendant to come take our orders. Upon his arrival,i asked him to bring a bottle of star ragler for our latest signee, and he smiled. K rejected subtly, on the ground that the gate of her lodge would soon be locked, which was normal in some lodges in DESPO.

Na so o, we gisted a bit before we came outside. That was how AKP and K’s relationship started and they had been so strong since then. Marriage is knocking on their door, and my best man suit don ready dey wait… Just waiting for them to pick their date and material for the traditional marriage. Lol

Not all relationships leads to marriage, but this one........

AKP and K, Happy Anniversary in arrears. I wish you guys the best of the best.

The End.


We continue our story next...........


HBD in arrears Charminee with the charming smile and nice personality. I wish you all the best life has to offer, in good Health and Wealth.

Slimynonny, i see you o. thanks for the ginger, e join give me voltage. cheesy welcome on board, bro.

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Slimynonny: 9:30pm On Feb 25, 2019
Nice update....pls keep it flowing, i need some more....abeg i no be man na lady oo
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 2:19pm On Mar 07, 2019
Slimynonny:
Nice update....pls keep it flowing, i need some more....abeg i no be man na lady oo
Slim bullet cheesy .. Update is on the way..


Happy Matriculation to the matriculants of DESPO.

Matric is Important but, Graduation is 'Importanter'

I'm in DESPO now with TOBIllionaire.. If you're around, we may share a bottle of happiness and some snacks before I leave. wink

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Slimynonny: 10:58pm On Mar 07, 2019
Thanks for the mention...... I don land with my mat since, this time no be sit i carry come......abeg no more delay
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Tobitrueman(m): 4:59am On Mar 11, 2019
WHIZKIDEFE:
Slim bullet cheesy .. Update is on the way..


Happy Matriculation to the matriculants of DESPO.

Matric is Important but, Graduation is 'Importanter'

I'm in DESPO now with TOBIllionaire.. If you're around, we may share a bottle of happiness and some snacks before I leave. wink

Habeg! � These your words, na bomb � o "Boss like dat"!. Great job o bro, keep it up. Thanks sir

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 4:30pm On Mar 11, 2019
Tobitrueman:


Habeg! � These your words, na bomb � o "Boss like dat"!. Great job o bro, keep it up. Thanks sir
Boss man , I greet you specially!

Biggie man wey nor dey wear agbada, na man you be! cheesy

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 11:21pm On Mar 11, 2019
This update is dedicated to slimmynonny(slim bullet) wey dey ginger me and Tobitrueman(boss man) wey get level. cheesy

Continuation.

Bee went out to check if Azo was lurking around outside and she came back some minutes later with a sad expression. ‘ how did it happened, what led to his involvement with the SARS? My boyfriend is not a yahoo-boy nau,’ she stated, looking at Meekest and I for an explanation.

‘We got to NDU, those SARS guys stopped the vehicle we boarded and asked us to come down before we were searched. They found different credit alerts on his phone and several ATM cards bearing his name inside his wallet. He was asked to follow them to the station for some questioning, that’s it,’ I managed to explained.

‘has he called anybody to report the situation of things yet?’

‘Not really’

‘hmmm’

‘what are your plans, cos I won’t just be here and allow my baby to be intimidated, infact lemme call my uncle,’ Bee said as she picked her phone from the bed.

‘abeg go serve food com make we eat joor, don’t worry your boyfriend will be fine’ Meekest remarked while I smiled, holding myself from laughing out loud.

Azo walked in at that moment and we all laughed. Bee nor gree o, she change am for us. She was angry that the prank was too expensive. Later calmed her down before we all ate and relaxed.

‘ oya make ona ready make we enta one side go relax na,’ Azo commented and the event of the previous night flashed through my brain.. To me and my guys, the word 1-side means a bar or a hotel. It would be deliberate foolishness on my side to go with them for another drinking session after I recovered from the previous night’s hangover.

‘I nor dey game o, make ona dey go, e get one matter wen i wan go tidy for house,’ I said. Meekest and Azo gave eachother a knowing look before they burst out laughing. Bee and her friend had that puzzled look on their face. I just gave dem that ‘wetin you nor know, big pass you’ look before I stood up.

‘hmmm,’ that was what Bee’s friend could do before she came to my side. ‘ do you really want to leave or you are joking?’ she asked. (me wey serious pass who hungry dey beat).

‘Yea’

She didn’t say anything, she just held my hand before Bee came to drag her for them to get ready or their movement which I jejely declined not partake in.

The babes got set and we all went outside before i took a bike home.

When the bike stopped at my lodge's gate, i heard voices of people shouting inside. ' which people don dey disturb the peace of the lodge again na,' i asked no one in particular as i entered inside.

[b] 'you go run race o, you know who i be?' [\b] , if you know how i personally hate the bolded statement ehn, then you could picture the look on my face that moment.

' all these small boys sef, if dem don join confra new, dem nor go dey allow people hear word again. Ogbeni wee you keep kwayet there, who you be sef, na you first join cult abi?,' i asked in my mind as i brought my key out of my pocket.

'you dey ask who i be? you dey maddd, smallie like you dey ask who i be abi? if dem don flog you dis night for your fvck up ehn, dat means i be mugu,' Biggie shouted as some guys held him from punching Julius.

' You dey mad, bigggie, i say you go run from dis skul if i mean you, fat fool,' Julius countered.

'ona go pack from dis lodge! Una dey crase for head, nor be dis lodge ona go tey show ona self dey disturb everybody, infact make i first call community first' caretaker shouted as he brought his phone from his pocket.

'keto, wait calm down, e neva reach like dat,' Julius said calmly while Biggie's men held him to his room.

They calmed down cos in DESPO, 'the fear of community is the beginning of behave matured,'



to be continued.

2 Likes

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 3:28pm On Mar 14, 2019
Greetings from Me2u all.

I'm currently somewhere around Berger Bus Stop. Holla @ your boy if you're close by, let's chill over a chilled bottle of pepsi. wink
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 5:29pm On Mar 14, 2019
WHIZKIDEFE:
Greetings from Me2u all.

I'm currently somewhere around Berger Bus Stop. Holla @ your boy if you're close by, let's chill over a chilled bottle of pepsi. wink
Somewhere around Ikeja City Mall... holla. cheesy
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 11:55pm On Mar 15, 2019
Angels do exist in human form, I can testify to that cos i have had encounters with some of them.

Techprodigy , oshe sir!
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 6:29pm On Mar 17, 2019
WHIZKIDEFE:
Somewhere around Ikeja City Mall... holla. cheesy
I'm in Kingstine Jo foods, Apapa. If you're close by lets relax over a chilled bottle of drink and some snacks.. wink

(1) (2) (3) ... (48) (49) (50) (51) (52) (53) (54) ... (59) (Reply)

Bloodline.......part Two[Blood And Diamonds] / The Dog Attendant (T. D. A) [COUNTLESS Part 2]. A story By Darousmart Emmanuel. / How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 87
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.