Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,801 members, 7,827,950 topics. Date: Tuesday, 14 May 2024 at 07:55 PM

Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) - Literature (13) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) (62028 Views)

Water Strike- A Comedy (18+) / FRESH Toto(adventure Of Prick Master And Miss Young Toto? / Innocent Ilo Wins 2020 Commonwealth Short-story For African Region (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (10) (11) (12) (13) (14) (15) (16) ... (22) (Reply) (Go Down)

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:08pm On Apr 12, 2019
Episode 79
( Hello everyone am wadewaltz, this is what i do for a living )

hahahahahahahaha
i don die oooo,
chaii wetin be this abeg?

Oboy we no believe everybody here for rumours hotel just dey shout dey make noise,

naso person stand up shout,
see come baba olowo as you take do face so like ojuju kokoro so,

why you dey do us like this na?
As i won answer the guy,
naso one waiter rush come outside with full speed dey shout like madman,

the waiter shout
ahhhh i don die ooo
what is all this?
Please i cant find the guy that just declared free drinks for everyone here again oooo,

ahhh everybody confuse shout you say wetin?

So una mean say labush make be wadewaltz cousin don follow backyard fence run dey go house no gree pay any money?

Chaiii the thing vex me die,
naso me baba olowo shout,

hmmm shebi i just tell una finish now say make all of una dey at alert ooo,
say this strange labush of a guy fit follow backyard fence run dey go house,

anyways na the hotel loss so nothing consine me,

but na thunder go really help us fire that idiot labush of a guy green bumbum so,

all the days of your life i swear na like so you go always dey fly back yard fence dey run dey go house,

as you do face so like saving box mad woman dey use save money so,

hahahahahahaha
everybody burst laugh,
chaiii abeg wetin just happen here so?

Naso i tell people,
na like this wadewaltz carry himself enter street go meet people,

baba shout,
hello everyone am wadewaltz,
this is what i do for a living,

i tell una say wadewaltz craze go meet one guy make just sidon him own for outside bone face dey collect evening breeze,

naso wadewaltz tell the guy,
hello bro am wadewaltz,
this is what i do for a living,

the guy bone face no even answer the idiot self,

we no believe wadewaltz still repeat tell the guy again,

hello bro am wadewaltz,
this is what i do for a living

ahhh the guy shout,
see come you this strange good for nothing unknown marketer so,

wetin dey even worry your grandfather here self?
Abi you don craze before?

Which one be hello bro am wadewaltz, this is what i do for a living.

You don tell me this hello bro am wadewaltz, this is what i do for a living like 32 times now,

wetin dey even worry you self?
Abi you think say i get ear problem?

Well i no blame you as you do neck so like all this useless kettle make all this muslim people dem dey use pray so,

na your type dem dey carry ladder for all this nepa people if dem won come cut light,

as you do eye so like blind batimus make dey for bible so,

hahahahahahaha
everybody burst laugh,

naso wadewaltz continue,
am really sorry brother but the thing is am a great pilantropist,

i deal on many things,
as am talking to you now i have 42 different jobs that i do saperately for a living,

i do barb hairs, i deal on fashion design.i sell recharge cards, am a rapper, an actor, a banker, i sell bitcoins online, i sell piracy movies at alaba market, am a dancer,
i do sew cloths, i deal on forex exchange, am a politician,
am a bricklayer,am a buiding contractor,am a pastor,am an highway robber, an herbalist, a kidnapper, i sell phones, i sell bicycle parts, i sell coffins, am a lawyer, i decorate wedding events, am a fraudster online, am a marketer, am a weather forecaster, am a navy officer, am a personal driver to one big politician, i sell kerosone in bulk, i deal on sms marketing, am a rapist for hire incase you need me to rape someone for you,etc

so as you can see i have even more than 42 jobs,

hahahahahahaha
everybody burst laugh,
chaiii which kind mad man be this one self?

For my life i never see person make get upto 42 different jobs at once before ooo,

ahhh i don suffer,
chaiii wadewaltz don craze.

naso the guy look wadewaltz up and down finish shout,

see come you this kidnapper make dey do marketing work so,
wetin be your problem here self?

Whats my business if you have more than 42 useless jobs you do for a living?

Upon all your so many jobs your total gross profit for the whole year make you dey get no dey ever pass 12,000 naira,

no be you i hear say nahim be the guy make get one useless assistant called labush okeremute the great fool?

I still hear say you never for once pay labush okeremute even one month salary self,

and upon say labush okeremute don dey work for you for over 22 years now,

hahahahahahaha
everybody burst laugh
i don die oooo,

naso wadewaltz answer the guy,
you know business is not that booming as normal,

hmmm and perhaps he is just of help to me and nothing more,

hahahahahahaha
everybody burst laugh again,
so person go dey follow you work for over 22 years and you never for once pay the guy salary before?

See come wadewaltz na thunder go fire that your stretch mark yansh for you there so,

as you do teeth so like who dem stone expired paint so,
na your type dey force people buy fake drugs dem,

as you do eye so like karashika the great winch so,

hahahahahahaahaha
everybody burst laugh,
i don die ooo,

episode 80 coming soon

1 Like 1 Share

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:11am On Apr 13, 2019
Episode 80
(baba olowo you too much abeg)

hahahahahahaha
everybody burst laugh,
i don die ooo,

so una mean say wadewaltz of a mad guy get upto 42 different jobs?

Hahahahahahahahaha
laugh won kill everybody for here,
chaiii wetin be this?
As i dey here so i swear laugh won tear my belle ooo,

oboy we no believe person stand up shout,
see come baba olowo you too much abeg,
why you too funny like this abeg?

You dey make us catch fun and forget the days stress,

naso me baba olowo shout tell people,

i swear na like so wadewaltz go work start to dey read baba olowo d long prick funny stories for early morning,

baba burst laugh,
ohh!! my gosh this baba olowo is just dem too crazy funny,

hahahahahahahaha
am really getting this one for a hard time here,
i cant just control myself laughing heavily here,

i tell una say wadewaltz laugh sotey him no know when him boss come work,

wadewaltz laugh dey scatter chairs like craze person make don high,

hahahahahahahaha
baba olowo d long long prickkk!! you have really killed me here,

kikikikikikikikiki

i tell una say wadewaltz boss dey knock for door like 62 times baba no gree answer still dey laugh,

we no believe finally the idiot answer go open door tell him boss say,

please sir you are in the wrong place please check back later my boss is not around for now,

hahahahahaha
everybody burst laugh
i don die oooo,

i tell una say the thing really confuse wadewaltz boss die,

wadewaltz boss sharp sharp turn back dey find him own office,

the boss dey ask himself,
i dont really think thats my office maybe i made the wrong move let me go down stairs and check well again,

hahahahahaha
everybody burst laugh,
chaiii see confusion for here so,

wadewaltz no first normal i swear,
even wadewaltz boss don really craze self,
how you go see your own office door you no go fit recognize am again,

even wadewaltz make open door self no fit still recognize him own boss,
imagine person make dey pay wadewaltz him hard earned salary baba tell am say make him check back say his boss no dey arround for now,

hahahahahaha
everybody burst laugh

naso one guy stand up shout,
abeg baba olowo wetin come really happen after that day na?

I tell una say uptill today wadewaltz boss still dey find that him office door,
the thing really dey confusing to people if una dey hear am self,

na like so wadewaltz take loose him job where him dey work as an errand boy for one big firm,

chaiiii wetin be this?
Hahahahahahahaha
everybody burst laugh,

una don see wetin baba olowo d long prick funny stories dey cause now abi?

Abeg read and laugh at your own risk,

naso one guy stand up start to dey dance like person make drink madman piss,
baba dey shine teeth dey happy,

abeg we need to forget all our worries here abeg,
before person go kick bucket die so like baba olowo manager make don die early this year so,

hahahahahahahaha
everybody burst laugh,
i don die oooo,

i tell una say na wadewaltz nahim burst laugh pass,

wadewaltz dey laugh like cricket make dem won use do sacrifice offer to all this gods dem,

kikikikikikikikikikikikikikiki
bibibbibibibibibibi
abrakadabrabratebra

chaiii laugh won kill everybody for here,

ahhh baba olowo don suffer,
naso me baba olowo stand up shout,

see come wadewaltz and this enstranged guy so make resemble madman testicles so,

see come na frying pan make dem dey use fry akara and yam nahim go fire una eye there for me,

as una do face so like old shovel make cause troble between centino their family and youngzubi their family,

na elevated thunder nahim go arrange press una two cloths there for me,

na una type dey enter bush go kidnap one big snake only pikin carry run tear heavy race dey go house,

as una do head like old bendel state make dem born sokodobo baba,

hahahahahahahaha
everybody burst laugh,
i don die oooo,

i tell una say people laugh sotey dem catch wadewaltz and that guy beat craze comot from their two useless teeths,

oboy see better slaps and kicks,
both the once dem use bottle take burst wadewaltz strange bar head gbosa!!

Hahahahahahaaha
laugh won kill everybody here,
chaiii nothing we no go see here so,

abeg baba olowo you too much abeg,

i tell una say wadewaltz confess that day say all this muslim people their prophet mohamed was once a christian before,

nothing wadewaltz no talk for this him mouth ,

well we no blame wadewaltz since niggas dem won use better beating re-arrange the fool brain,

hahahahahahahaha
laugh won kill me for here ooooo,
chaiii na wadewaltz our derailed he-goat be this?

I tell una say nobody even pity for them here,
oboy see latest style of beatings we see for here so,

before we know we see sokodobo stand up shout,

see come centino as you do yansh so like wadewaltz morning mad breakfast so,
na all this china people their electrical fireworks nahim go by mistake fire all your teeths there comot for you,

hahahaahahahaha
everybody burst laugh

abeg wetin consine centino for here again ooo

episode 81 coming soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:17am On Apr 13, 2019
Episode 81
( wadewaltz was once a kidnapper)

hahahahaha
everybody burst laugh,

abeg wetin consine centino for this matter now abeg?

Abi na because of say centino and seun dem defruad sokodobo for who wants to be a millionaire game show before?

Hahahahahahahahaha
everybody burst laugh,
abeg why baba olowo dey drop us new sweet latest episodes dem for here back to back?

Chaiii wetin be this?

Naso i tell people say,
wadewaltz was once a kidnapper, a ritualist and a highway robber before,

wadewaltz see say life don really tire am baba vex venture into kidnapping business,

naso him and all him gangs dem dey find any rich man make dem go kidnap see better money,

naso dem stupidly go conclude say dem must kidnap person this night,

i tell una say we no believe say na poverty stricken sokodobo nahim dem see kidnap,

if una see the way dem use take bundle sokodobo with all this 500 naira tick rope, carry trow inside motor boot pick race dey run fear people ooo,

ahhh people shout which kind thing be this one na?
It has not been a week sokodobo was defrauded by who wants to be a millionaire game show mastermind called seun,

and now he is now been kidnapped again here,

hahahahahaha
everybody burst laugh,

abeg who be this english proffesor make get long mouth so like basuka gun make dey malfunction so?

Abeg who ask you any question for here?
may make you this idiot dey explain to us in pure english like say we ask you anything?

i tell una say wadewaltz dey shout inside their car say,

we are finnally made,
we are finnally rich!!
I told you guys this deal was going to click through,
i told yall it was going to be succesfull,

ohh well, ohh well
look at it now all manifesting right here in our fronts,
we are rich niggas!!

Hahahahaahhahahahaha
everybody burst laugh
i don die oooo,

i don laugh tire for here sotey to dey type for here self my two hands don dey shake ooo,

hahahahahahahaha
see this mad wadewaltz dreaming big,
chaiii what a crazy world,

i tell una say sokodobo make dem wadewaltz kidnap tire rope like antelop make won go thief so,

sokodobo baba no even shake body or move self,
oboy this kind rope dem use tire sokodobo with self tire me ooo,

even the world strongest man no fit untie himself comot from this rope i swear,

the rope be like all those ropes one mad omo ni le guy use go measure sell dem youngzubi their only one pieces of land for lagos here so,

i tell una say since then dem youngzubi are landless,
baba dem no get one single land call their own again,

hahahahahahahahahaha
everybody burst laugh
i don die oooo,

abeg all for the fun baba
i no really mean am oooo,

i tell una say the kind speed wadewaltz their motor take dey run as dem kidnap sokodobo so fear people ooo,

oboy see speed limit to the highest,
the thing even surprise dem the gang members dem say wadewaltz make dey drive like donkey make carry hunch back so,

no just know where him dey carry all of dem dey go self,

ahhh the gang members dem shout,

see come wadewaltz you know say we don really pass with full speed pass the hide out make we suppose go put sokodobo,

why you dey drive like cow make get only only one hand na?

Hahahahahhahaha
everybody burst laugh
i don die ooo,

i tell una say wadewaltz just dey drive with full speed comot from lagos state here dey head go kaduna state,

wadewaltz say abeg i no won really risk am ooo,
we need somewhere more safer to hide this rich guy,

naso one gang member make dem dey call na one day i swear i go enter trouble shout

see come wadewaltz as you do neck so like excape goat make won go collect bribe chop a whole person fruit of his labour so,

na thunder go fire your seat belt there so,
abeg which time we bargain say na for kaduna we go carry this our victim go hide so?

As you carry chest so like grasshoper make no won gree do him birthday,
abeg who and where for kaduna you just know make you dey carry us go self?

Because like this now i know say na operation no distination you dey do like this now,

hahahahahaha
everybody burst laugh,
i don die oooo,

i tell una say even wadewaltz make dey drive the motor self no even know where dem dey go self,

sometimes wadewaltz go stop the motor ask person,
please sir where can i really take to go to kaduna state?

Naso the person go direct dem finish,
i swear na the wrong road wadewaltz go soon follow with heavy speed no looking back,

sotey wadewaltz enter wrong roads tire where dem come see their self na for cotonou border,

hahahahahahaaha
everybody burst laugh

as dem reach the border for the checking point naso dem sight police dem for there,

oboy dem the gang members dem no believe say wadewaltz open the motor door with full speed fly come outside excape run,

hahahahahahaha
laugh won kill everybody

before dem the gang members dem go react run police don surrender their motor
catch all of dem,

hahahahahahaha
laugh no go kill me oooo

chaiii wadewaltz don put dem for trouble oooo,

hahahahaahaha

episode 82 coming soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:42am On Apr 13, 2019
Hahahahahahahahaha
i don really laugh tire for here oooo,

i don laugh like craze person for here oooo,
chaiii what a crazy world,
my belle now don dey pain me oooo,

abeg my niggas dem laugh at your own risk oooo,

lets catch more fun here,
hahahahahahahaha
shebi wadewaltz you say you go fit challenge me baba olowo abi ?

Hahahahahahahaha
i don laugh tire for here i swear down,
abeg all hail king wadewaltz our mad joker of the day,
i swear life go tire you for here,
i know say you go don laugh your self won nearly troway spoil your new phone make dem buy for you with laugh,

i understand your feelings here nigga,
abeg guy laugh and be happy ooo,
no go die untimely death say you dey go reason the stress of this life ooo,

chaiii baba olowo no go kill person oooo,

my next episode 82 will be titled
(mr paul the great criminal)

hahahahahaha even the title name self dey make me laugh here ooooo,

chaiii come o,
na midnight i dey type all this episodes dem here so,

under how many hours i don compose and drop 3 sweet episodes for una here ,
so lets laugh and have fun,

my hand don dey even pain me now self, but too much of laugh for here no dey even make me feel am self,
abeg make my sleeping neighbours dem no go wake say na my laugh wake dem oooo,

hahahahahahahahahaha
i don die oooo,
even me the author of this story dey laugh like madman after composing and droping the 3 episodes here,

abeg is it normal or am i mad?
I don laugh sotey i had to compose this 3 episodes at a stretch oooo,

chaiii laughing jackass nigga

good night my niggas
sweat dreams and please do dream about baba olowo d long prick funny stories thanks

baba olowo

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:50am On Apr 13, 2019
Hello good morning to you all my fans dem,
abeg its been a long road but we are here now,
i will say happy weekend to you all my niggas,
wishing you guys happy flexing and balling life,

come o,
abeg wetin be time now?
Looks like lazy man wadewaltz is yet to wake up oooo,

abeg make somebody here use better cold water dem just go fetch from lagoon abi swarmp,

carry the water go pour this nigga wadewaltz there as him open mouth dey sleep so like person make dem give quit notice pursue comot from house him no gree pay house rent for so,

hahahhaahhahaaha
i don die ooooo,
abeg any volunteer here abeg raise up your hands ooooo,

will be droping more episodes here very soon,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:35pm On Apr 13, 2019
Abeg i won go watch match now for viewing center abeg,

all this one make we dey read for news say stray bullet kill one guy make go watch match for ball house so,

abeg make una wish me long life oooo,

all this my enemies dem fit go shoot me for yansh deny am say na stray bullet be that,

people like dem wadewaltz and company make do teeth so like all this small pikin cultural dance their rehearsal so,

chaiiii wetin be this?
but guy i need to go watch match na,
today na saturday abeg,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Wadewaltz(m): 12:39pm On Apr 13, 2019
okafor200:
Abeg i won go watch match now for viewing center abeg,

all this one make we dey read for news say stray bullet kill one guy make go watch match for ball house so,

abeg make una wish me long life oooo,

all this my enemies dem fit go shoot me for yansh deny am say na stray bullet be that,

people like dem wadewaltz and company make do teeth so like all this small pikin cultural dance their rehearsal so,

chaiiii wetin be this?
but guy i need to go watch match na,
today na saturday abeg,

baba olowo
Get a wife,get a life and leave me alone
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:03pm On Apr 13, 2019
Wadewaltz:

Get a wife,get a life and leave me alone

hmmm apology accepted my nigga wadewaltz,

never again will i baba olowo ever insult you here ever again,
its been a long road but wadewaltz is here now,

all hail wadewaltz our new brand nigga,
but now i dey reason am who i go fit take replace wadewaltz now for the yabbing levels dem,

am even considering using pradioc abi na devilmaycry self,

see come devilmaycry and pradioc make una no run ooo,
as una two do face so like madman parking store so,

see come i repeat no run ooo,
una name self go sweet for yabbing self,
as una do eye so like ghost mode,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:30am On Apr 16, 2019
Abeg all my fans dem sorry for the late posting here again,
my area here no get light for the past 2 days now,

abi na because of all this rainfalls abi na wetin self?

Anyways please keep the hope alive,
una know say na me dem dey call baba olowo and to compose another funny episode drop for here no go hard me,

hmmm well lets see how today fit be sha,

see come abeg for all this niggas having problem reading my story dem, now me baba olowo want to dey add a little bits of pure english dem dey join this my story. so it can be more interesting to read and laugh

some niggas dey yan me for facebook say most of the reason why dem dey like my story dem be say na to come read and laugh for my different patterns of new sweet yabbings i dey yab people dem,

that yab alone nahim dey make dem dey get hiccups dey laugh like craze people,

the thing be say to dey drop new yabbings dem for here no really dey easy ooo,
if una dey wash well una go don notice say some of my sweet episodes dem na so so yabbing full am till the end of the episode self,

if to say its easy abeg try make you self try compose something like that so una go fit really know say me baba olowo i dey really try die,

some niggas here dey like come read my funny story dem but no dey like to dey comment here,

i dey reason am say maybe na because of say if dem comment finish i go use their names for my next funny episode of yabbings,

hmm i won tell una say me baba olowo don really stop to dey yab my fans dem oooo,
unlike before where me baba olowo dey talk anyhow,

but now na only people make go come here to talk rubish na those kind of people i dey include dey yab for my episodes dem,

so abeg all my fans dem for here please dont be afraid to dey comment here after reading,
me baba olowo i promise una now say am a changed man,

as i take promise wadewaltz so say i go stop to dey yab am, na like so i go also promise una all my fans dem say me baba olowo no go ever for once yab una again for here,

abeg this na for my scared niggas dem make dey really fear to dey comment here,

abeg my niggas dem i won also talk about wadewaltz issue of peace,

person now dey yan me say make i no really stop to dey yab that wadewaltz of a guy abeg,

say the guy too dey talk anyhow self, even mods dem for here dey shine teeth dey happy as i dey finish rape the guy anyhow for here so,

say abeg baba olowo no stop ooo that guy really get mouth before,
i tell una say na like so wadewaltz take bounce fallin this my thread drop one bombshot make just kill off my moral for that day,

i was like wondering whats all this?
So as him take yan that day i come say,
ahhhh na all this nairaland moderators be this ooo,

so since i no want any ban i decided to let him say what he wanted and me baba olowo no even answer am,

na when i come go read youngzubi story come dey see how mods dey threaten wadewaltz with ban and suspension, that was when i come know say the guy self na just ordinary nairaland member like us self,

ahhh after some days nahim my mind remember wadewaltz,

baba first think say na play,
you think say i be the type make dey listen to bad people negative comments dem,

i tell una say when i fear my self be say na when i go all this facebook group where dem dey argue between igbos and yorubas who is better,

laugh won kill everybody for there, dem just dey ask abeg who be this mad funny guy abeg,
why you too stupid like this?

I yab group of people dem sotey some people start to dey leave the group,
some niggas dem laugh tire send me friend request guy abeg you too sabi yab abeg,

person drop message for there say i still be learner for yab levels dem,
naso i first yab the guy for the open group there people won laugh kill theirselfs,

but the thing surprise me die say the guy no gree reply or answer ooo,
and the idiot dey online self,
i wait for how many minutes baba no still gree answer,

naso i send am friend request baba accept sharp sharp,
ahhh the thing really surprise me na there i vex send am message,

see come as you do teeth so like enstranged mad shark so,
with your head like who dem stone bottle so,
na your type dem all this village drunkards dem go catch for night rape for bush,

hahahaha
the thing surprise me say the guy read am finish no still gree answer,

naso i send am another message,

see come you this strange looking guy so, make do face like all this kogi state their kidnappers,
na your type dem dey hang ontop all this big trailers dem dey shine teeth go work,
as you do yansh so like electric cooker make no good,
with your thin belle like all this cele people their musical band,

hahahahahaha
i tell una say i no believe baba reply me shout,

hahaha you win!! You win!!

Nahim be the only thing baba reply me with,

i tell una say since my carear of yabbing people dem, na that guy be the easiest win i don ever get before,

that one nahim dem dey call flawless victory if you dey play wrestling or boxing for all this playtations dem,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:15am On Apr 18, 2019
Coming up next is Episode 82 tittled ( mr paul the great criminal)

abeg all my niggas dem please keep the hope alive,

chaiii so mancity is out of the champions league?

Ahhh the thing pain me enter blood when i don celebrate finish for that last minute goal make VAR show offside no goal,

ahhh what a life

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:48am On Apr 18, 2019
Episode 82
( mr paul the great criminal)

hahahahahahaha
i don die ooo,

come o,
wetin be this?

I tell una say as wadewaltz pick race run excape,
na dem the remaining gang members make no sharp nahim police dem see arrest,

dem the gang members dem shout,
ahhh wetin be this?
See as wadewaltz don put us for big problem ooo,

hahahahhahahaha,

I tell una say the way police take hijack all of dem carry go police station fear people ooo,

the thing even surprise me say police follow carry sokodobo make dem kidnap carry go prison go lock join self,

chaiii wetin be this?
Abeg wetin sokodobo do na?

Dem the police oga say,
abeg this sokodobo of a guy looks like a hardened criminal and needs to rot in jail,

see him face like all this small pikin 10 naira biscuit make no sweet at all,

hahahahahaha
everybody burst laugh,

chaiii sokodobo make be say na kidnap dem kidnap am carry come here nahim dem put inside prison,

how manage dem still include arrest sokodobo join say na also their gang member him be,

hahahahahaha
laugh no go kill me ooo,

as things come take be for here,
naso person shout,

see come baba olowo as you dress like craze person make won go find work so,

why you dey delay to dey give us new updates na?
Looks like you don dey suck breast too much abi?
as you do face so like madwoman bag,

hahahahahaha
everybody burst laugh,

ahhh the thing surprise me die,
naso i look the guy make dey talk self,

chaiii me baba olowo shout,
come o,
no be mr paul the great criminal be this?

Ahhh people shock look me,
you say wetin baba olowo?

Naso i continue,
this mr paul na the greatest criminal i have ever seen in this life,

i tell una say mr paul don thief sotey dem give am award for surulere as the most respected thief,

nothing mr paul never thief for this him life make him dey so,

as i still dey talk,
naso one babe make sidon near mr paul stand up shout,

ohh my gosh where is my pox?
ahhhh please am serious ooo where is my atm card?

Ahhh people shout,
chaiii wetin be this?

I tell una say mr paul bone troway face dey even drink beer,

naso some good fellow nigerians come dey help the babe dey look for her pox and atm card,

the thing pain me die say almost everybody make dey here dey help the babe find her property except mr paul and d black baba,

the next thing make we hear na,
person shout i have seen it!

Naso we rush go look oboy i tell una say na the babe one leg of slippers nahim the idiot see come dey shout like say na the atm card be that,

ahh the thing pain me die naso i tell the guy,

see come you this strange looking guy so make do face like mosquito coil so,

na thunder go fire your left hand for there,
as you do face so like heavy gambler,
na your type dey work for all this cementary dey bury dead people,

as you do eye like cockk and bull story,

hahahahahaha
everybody burst laugh forgeting say we dey even find that babe stolen property self,

naso i look mr paul shout,

see come mr paul,
as you dey here so i swear i dey suspect you die for here,

forget say you bone face sidon here dey drink beer like who dem force carry go shrine go swear for so,

na thunder go help us fire your inner boxers make you wear come here so,

na your type dey enter motor thief 20 naira sweet make person mama buy give him small pikin dey lick inside bus,

the small pikin go dey cry,
mummy!! Mummy!!
This bros don lick my sweet ooo,

the mama self go think say the pikin don troway the sweet or maybe the pikin dey lie,

not knowing say na you this mr paul don hijack the small pikin sweet,
trow the sweet sharp sharp enter throat swallow am,

hahahahahaha
everybody burst laugh
i don die ooo,

baba olowo you no go kill us ooo,

naso i continue,

see come mr paul as you do neck so like news caster their reporters dem make go one rural area make area boys dem catch rape turn by turn so,

as you do back so like centino mad laptop so,
na your type dey enter people farm thief their cutlass carry go sell,
as you do yansh so like d blacc baba their one and only useless dog make dem get for house,

hahahahahaha
everybody burst laugh
i don die ooo,

abeg baba olowo you too much abeg,

naso we surprise the babe slap craze comot from mr paul eye as the idiot still dey drink him beer,
gbosa!!

ahhh wetin be this?

I tell una say as the babe sound baba hot slap for eye,
all the babe pox and atm card fly come outside from mr paul back pockets,

hahahahahahahaha
everybody shock
wetin be this?

Ahhh this mr paul na really great criminal,

chaiii oboy see as guys run go carry better planks come outside,

naso mr paul shout,
please let me explain

am a cool headed nigga it must have been the handwork of my enemies here,

am not the one who stole all this stuffs please ooo,

i tell una say see better beatings for here so,

dem beat baba sotey him faint,
as people see say mr paul don faint and dem no see anybody beat again,

naso dem catch d blacc baba,
oboy dem beat craze comot from d blacc baba

hahahahahaha

episode 83 coming soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:08am On Apr 18, 2019
Abeg i go need una comments for here ooo,
its not easy droping stuffs for una to read ooo,

episode 83 will be titled
( Get a wife,get a life and leave me alone )

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:34pm On Apr 18, 2019
Episode 83
( Get a wife,get a life and leave me alone )

hahahahahahaha
laugh won kill everybody for here,

the way people take gather beat d blacc baba fear me ooo,

abeg wetin d blacc baba do may make people include am dey beat with mr paul the great criminal self?

I tell una say as mr paul faint crowd still gather am dey beat baba no know when him stand up from the faint,

oboy see another round of black and blue beatings for here so,

na later dem come carry mr paul and d blacc baba go prison go lock,

hahahahahahaha
laugh won really kill me for here because i know say nothing consine d blacc baba for this matter,

but people dem still choose to beat d blacc baba join,

hahahahahahahaha

nothing we no go see for this place so,

naso my phone ring,
as i pick na my guy oboy enter dey call me,

abeg baba olowo do fast dey come area ooo,

i won show you one slay fine baby make dey hot for area here so,
i tell you say many admirers and rapist dem dey really plan that babe,
the babe just too fine like mammy water,

chaiii me baba olowo shout,
naso i rush come outside from rumours hotel dey head go my area ontop bike,

as i reach naso my guy carry me dey go the babe their house,

the thing be say the babe house get one small provision shop for the front of their house,

and the babe dey shop with some of her school friends dey laugh dey discuss,

as me baba olowo sight the babe,
oboy this babe too make sense die,
she is too damn beautiful,
chaiii i go need this kind of slay baby in my life,

naso i waka pass do as if i just dey go somewhere,

oboy i turn my neck well dey skemp the babe ooo guy,

i tell una say i waka pass the babe shop more than 52 times,

if i waka pass go front i go wait for some minutes,
then i go waka pass again to skemp the babe,

the thing surprise me say one of the babe friend make dey the shop just dey notice the way i take dey waka up and down for the front of their shop like person make no get work,

naso the babe friend tell the babe,

hmmm look at this good for nothing guy called baba olowo d long prick,

he has been busy passing here up and down for like 30 minutes now,
i dont know what he is even looking for self?

Why is he walking up and down here like someone that has epilepsy?

Hahahahahahahaha
i tell una say all of them make dey the shop burst laugh,

chaiii shame won kill me,

naso me baba olowo bounce go the shop,

hello baby please can you give me bottle water?

Hmmm one of her friend look me hiss,
but the babe come ask me how many do you want?

I tell her say i will be needing just 2 bottles,
one for me and also one for my guy oboy enter,

naso she carry the two cold bottle water give me,
me too sharp sharp give the babe money come tell her please keep the change,

hmmm she tell me thank you,
naso i squeeze face dey form posh guy,

naso i ask her,
hmmm am really sorry dear please whats your name?

I tell una say all the babe friends dem burst laugh like people make just go suck youngzubi prick finish just now,

hahahahahahaha,
naso one of the friends tell the babe,
i told you this guy is just pattroling up and down here all because of you,

ahhh the thing shock me die,
which kind devilish friends this babe get self make dey talk rubish like who dem swear for so,

but the thing really surprise me say the babe answer me,

my name is ann2012,

hmmm naso i smile tell her actually my name is stanley okafor and i do stay arround here,

so can i have your number?
Naso she answer me sorry i dont really know you and i dont give out my number to someone i just met now,
maybe next time

naso i compose myself,
hmmm you know what i will check back on you maybe 2moro so we can talk more better,

it seems you are very much busy with your friends here,

hahahahahahahaha
all her friends burst laugh,

who told you we are busy mr long prick?

Ahhh the thing surprise me die,
come o,
who tell dem this babes dem say na me dem dey call baba olowo d long prick self?

Chaiii which kind wahala be this na?

I tell una say ann2012 the babe i dey talk to tell me,
please Get a wife,get a life and leave me alone.

Ahhh the thing shock me,
why do you have to say that dear you know am kind of having feelings for you,

i really do need you in my life baby.

Naso her friends reply me,
it looks like you are deaf and dumb, didn't you just heard what she said to you?

So you better leave her alone and go look for a better life to live,

ahhhh the thing pain me baba olowo die,

naso i tell dem her friends,

see come,
as all of una take keep face so like evil spirits make dem cast comot from madman body so,

na thunder go help me fire una bikini pants for there,
na una type dey later go do fasting and prayer for 40 days and 40 nights so una go fit see husband make go marry una,

as una carry long mouth dey talk so like mad herbalist make no well so,

hahahahahahahaha
i tell una say all of dem burst laugh including ann2012 my sweet baby,

ohh my gosh this guy is really too stupid!

Episode 84 coming soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:48pm On Apr 18, 2019
Abeg all my fans dem,
my next episode 84 will be tittled
( a day with Aikoriegie Solomon)

una go laugh tire i swear down,
abeg laugh at your own risk ooo,

the episode will be droped this night arround 8 pm or so,

abeg all dedication to Aikoriegie Solomon baba i no really mean am ooo,

you self you know say all i do is all for the fun and no hard feelings brother,

i been tell you before say i go fit dedicate one of my episodes for you Aikoriegie Solomon baba

do watch out for episode 84 of baba olowo d long prick coming soon live on Hd,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:19pm On Apr 18, 2019
Na me dem dey call baba olowo d long prick,
this my pics na for my niggas dem make never see me before,

its been a long road but we are here now

baba olowo

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 4:04pm On Apr 18, 2019
Will be droping more episodes here very soon please do watch out,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:13pm On Apr 18, 2019
Episode 84
( a day with Aikoriegie Solomon)

hahahahahahaha
ann2012 friends just dey burst laugh here dey laugh like rats make just go lick red oil,

naso me baba olowo bounce dey comot from their shop,

i no believe one of the friends shout,
please baba olowo dont go ooo,
you should have stayed here and be watching how we ladies change our undies and our cloths idiot!

Hahahahahahahahahaha
all of dem burst laugh again,

naso me baba olowo turn look dem,

see come,
as all of una do face so like expired indian hemp so,

na thunder make dey bleach heavily nahim go fire una tight butthole for me for there,

as una do eye so like counter attacks make liverpool take dey win match dem,

hahahahahahahahaha
all of the babes dem burst laugh,
i told you this baba olowo of a guy is just too damn stupid and funny,

i no believe ann2012 rush come outside say she go give me her number,

ahhh the thing surprise me die,
how manage abi she don drink high or what?

Ann2012 tell me,
please stanley can you be coming here everyday to keep us company i really do like your jokes,

or better still please dont go dear,
stay with us for a little longer na,

as i still dey reason whether na this babe i won toast so dey talk abi na her ghost,

naso one guy make dem dey call Aikoriegie Solomon rush waka come the shop,

Aikoriegie Solomon tell the babe,
please can i have a private time with you please?

Naso the babe look Aikoriegie Solomon up and down finish hiss,

laugh won kill all her friends for here,

i tell una say Aikoriegie Solomon be like all those ancient rapist dem make carry scatter scatter hair like madwoman pant,

chaiii wetin be this?
Naso Aikoriegie Solomon tell the babe please am kind of liking you every minute and every day,
i cant really stay without you thats why am finding it harder to sleep at nights,

ahhh the thing really surprise me,

come o,
no be this same Aikoriegie Solomon make don marry born 5 children be this?

Naso i tell Aikoriegie Solomon,
see come,
as you do face so like 1892 post office so,
why you dey fall in love with babe make i ready die for so?

See come as you carry long throat like ostrich make dem just deliver from evil spirits so,

na your type dey go barb hair nepa go take light the barber go tell you say abeg oga my generator no good abeg come back later,
after when the barber go don balb comot almost half of your hairs dem comot,

chaiii abeg which kind style we go call this hairstyle make the barber no gree finish so?

Hahahahahahaha
all the babe friends all of dem burst laugh,

ohh my gosh is it you Aikoriegie Solomon this baba olowo of a guy is talking to?

If it where us we would have smashed out 2 of his teeths now,

hahahahahahaha
dem still dey laugh

naso Aikoriegie Solomon look me hiss,

baba tell me,
hello young man whats your problem here?
Are you really sick in the brain or you need a brain replacement surgery?

Hahahahahaahaha
everybody burst laugh

kikikikikikikikiki
whats all this madness here?
Hsdhjgfdnytwdsgbhbdgsdjdg

Naso i answer Aikoriegie Solomon,
see come na you go need brain replacement surgery there idiot,

as you do face so like craze person face cap,
with your thin belle like buhari one leg of shoe,
as you keep chest so like d blacc baba inner bumbum so,

hahahahahahahaha
all the babes friends dem burst laugh,

kokokkokokokokoko
abeg baba olowo which kind new pattern of laughs be all this one na?

Which one be kokokokokoko like people make dey hide change elections results dem,

hahahahahahaahahaha
everybody burst laugh

abeg why baba olowo too funny like this ooo,

naso ann2012 my sweet baby answer Aikoriegie Solomon,

you think i dont remember you abi?
Are you not the same guy that almost raped me last week?

When i was almost closing the shop arroung 9.30 pm you came here to force me to follow you,

ahhh all her friends shout,
hmmm this Aikoriegie Solomon of a guy even looks like a rapist,

you want to come and reap in the place you did not sow abi?

Na strange thunder nahim go help us fire all your teeths there comot for us,

hahahahahahahaha
laugh no go kill me here ooo,

as things come take be for here,
naso Aikoriegie Solomon shout,

hello baby i will make it rain for you,
i will spill out my cash and blow the fuckingg hell out of you,
do you know who i am?
Am a real top baller of cash,
i spend in dollars and pounds and i can make it rain right now as we are talking,

hmmm the thing surprise us die as Aikoriegie Solomon dey talk like person make get morning sickness for mouth,

naso ann2012 ask am,
please where is your ride?
And the last time i checked you just trekked down to this place without even a broken bicycle,

hahahahahahahaha
everybody burst laugh,

this Aikoriegie Solomon na really madman make don high,

naso the babe hiss troway face,
all her friends come dey beg me please stanley just stay with us for some few more minutes na,

we really like your company here,
chaii Aikoriegie Solomon won die,

wetin happen next

episode 85 coming soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Ann2012(f): 8:40pm On Apr 18, 2019
You no well walahi grin

Thanks for the update
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:01pm On Apr 18, 2019
Ann2012:
You no well walahi grin

Thanks for the update

hello baby please be mine dear,
you know i have been thinking much about you my sweet baby,

even now am kind of having a fever all because of you my love,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Ann2012(f): 6:27pm On Apr 19, 2019
okafor200:


hello baby please be mine dear,
you know i have been thinking much about you my sweet baby,

even now am kind of having a fever all because of you my love,

baba olowo

Go hospital, dem go cure your fever
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:02am On Apr 20, 2019
Ann2012:


Go hospital, dem go cure your fever

you really know i need you in my life baby,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:10am On Apr 20, 2019
Abeg all apology to my nigga Aikoriegie Solomon baba,
anyways all for the fun ooo,
me baba olowo no really mean am ooo,


but abeg do watch out for episode 85 titled ( madman .f. kenedy)

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:10am On Apr 20, 2019
Episode 85
(madman ,f, kenedy)

hahahahahahahahahha
see as all ann2012 friends here dey laugh Aikoriegie Solomon baba,

before we know baba vex comot from the shop dey go house,

as i still dey there dey shine teeth laugh with them the babes dem,

naso one guy make dem dey call madman ,f, kenedy waka pass the shop shout,

see come baba olowo as you do neck so like basket make fishermen dey use go catch fish so,

as you do belle so like new operamini browser,
na your type dey go thief people ram go sell,

hahahahahahahahaha.
All the babes dem burst laugh
chaiii dem won use laugh break all my waist for here,

naso i look the guy laugh no even answer am,

naso the guy continue again,
why you go use my name as your episode 85 title as madman ,f, kenedy?

Abi you want make strange thunder fire that your throat for there?

Well i no blame you as you do teeth so like antelop last born,
with your yansh like stolen van,
na your type dem dey go kidnap bush baby pikin carry go market go sell,
as you do face so like point and kill catfish,

hahahahahahahahahhahaha,
laugh won kill me for here
chaii see as all the babes dem for here won use laugh finish my life,

ahhh the thing pain me die naso i answer the guy,

see come,
you this guy make do teeth so like who dem won go bury for bush so,
as you take resemble wetin person just vomit now so,
na epilepsy of the brain nahim go catch your yansh for there idiot,

as you do belle so like youngzubi their useless hand fan,
na mad person motor make no get brake from nowhere go come jam you as you stand here so,

na your type dem dey repeat primary 6 common entrance exams 7 times before you go finnally pass,

as you do eye so like old man make no dey see road well,

hahahahahahahahaha
everybody burst laugh,
all the babes dem won die with laugh,

naso madman ,f, kenedy shout,

see come baba olowo,
as you take do neck like pickup van so,
na all this small pikin bicycle nahim go jam you there, break almost half of all your teeths there comot,
as you do yansh so like centino baba brain box make no good,
with your face like food make i chop yesterday night make no sweet,

hahahahahahahahahaha
all the babes dem burst laugh,

naso i answer am,
see come madman ,f, kenedy,
as your name take be like who dem swear for so,
na mad dog make dey find who to rape nahim go disvirgin your yansh there,

as you do hand so like grasshoper make won go thief sokodobo their precious one and only TV pick race run,

na your type dey stand for bustop dey help people dem dey carry their load go their shops,

as you do back so like youngzubi one leg of shoe,

with your brown teeths like who dem give one wicked back hand slap,

hahahahahahahahahaaha
all the babes dem burst laugh,
i don die oooo,

as things come take be for here naso madman ,f, kenedy vex bone face,

baba shout,
am a very good friend of Aikoriegie Solomon and am here to defend my friend,

na because of you this stupid baba olowo of a guy nahim make this babe ann2012 no won gree look my friend Aikoriegie Solomon face again,

inshort na thunder nahim go fire you baba olowo and this ann2012,

as una two take do face like who court just dissolve their marriage so,
na scorpion make dey learn how to bite nahim go pinch that una yansh for there,
as una resemble wetin dem troway enter dustbin so,

hahahahahahahahaha
everybody burst laugh,
chaiii wetin be this?
Which kind person be this guy make dem dey call madman ,f, kenedy self?

Naso me baba olowo answer the guy,

see come as you do face so like centino baba morning wood so,
na thunder make dey suffer from cancer nahim go fire your prick there for you,
na your type dey arrange go thief people slippers comot from their house as dem enter inside,
with that your teeth like who dem stone bottle,

as you carry eye so like dirty pampers make small pikin no won gree wear,
na higher killers dem nahim go help us fire that your tight bumbum for us there,

hahahahahahahhahahah
all the babes dem burst laugh,

naso i still continue,
see come,
as you resemble iron bender make never see work do for almost a year so,

na your type dem no dey ever sweet for bed,
na to just fuckkkk like fowl under 5 seconds you don finish,
as you keep chest so like madman basin,

na electricuted cat nahim go pursue you to fuckkkk,
as you keep bears so like who dem swear for,
na your type all this strange goat for dreams go by force won suck their prick,

as you keep forehead so like katapot make no straight,
with your bend leg like all this japan people their radio make no good,

hahahahahaahahahahaha
all the babes dem burst laugh
abeg baba olowo stop oooo,
you won kill am?

We no believe madman ,f, kenedy vex won follow me fight,

baba dey shout,
ahhh na me you dey talk to so like this abi?
Na me you say i keep bears like who dem swear for so abi?

Ahhh baba burst cry dey shout join am,

oboy see as people rush come saperate ooo,

naso i tell am,
see come as you keep teeth like who cripple so,

na your type

episode 86 coming soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:47am On Apr 20, 2019
Hahahahahahahaha
baba olowo on a yabbing levels ooo,

See come abeg today na saturday so lets have fun,

will be droping episode 86 very soon so please do check back,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:11am On Apr 20, 2019
Abeg see me see wahala again ooo,

abeg wetin consine this mad johnson anyanwu of a guy again for this my last episode 85 i just post here so,

abeg make una see wetin this idiot comment for my episode 85 make i post for facebook,

Johnson Anyanwu
Baba olowo u be mad man with u face like sarri(chelsea coach)ciga,

naso me baba olowo answer am,

Hahahahhahaha

see come Johnson Anyanwu as you keep bears so like person make dey sell groundnuts for streets so,

na your type dem dey hang for person back of motor dey shine teeth go work,
as you carry bar head so like who dem swear for so,
na people like you dey help all this small pikin dem cross road but na you motor go later jam,

as you do neck so like back of kettle,
with your flat head like all this cele people their band,

looks like this guy don start again ooo,

make i no go use the fool take compose my next episode 86 ooo.

Anyways all for the fun baba

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:19am On Apr 20, 2019
Inshort me baba olowo don vex for here,

my next episode 86 will be tittled
( johnson anyanwu the slay baby )

we go laugh tire for here,
all for the fun baba,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 2:52pm On Apr 20, 2019
Its been a long road but we are here now,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:45am On Apr 22, 2019
Happy easter celebrations to everyone here,

baba olowo d long prick comedy stories will still be continued,

do watch out for my next funny episode thanks

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 4:52pm On Apr 23, 2019
Episode 86
( johnson anyanwu the slay baby )

oboy as i won complete the yab make i won yab madman.f.kenedy so,

wetin i hear for my ear na hot slap gbosa!!

My ear ring like say i just dey recover from one strange mad sickness,

ahhh me baba olowo shout,
chaiii wetin be this?

Oboy see fight ooo,
see as people full here just dey saperate fight between me and madman.f.kenedy,

ahhh make dem just give me small chance make i just beat craze comot from this mad guy teeth,

naso people rush saperate us ooo,
ahh the thing pain me because madman.f,kenedy don use better slap design my face as first attack,

chaiii if to say i know me for ready for the slap,
ahhh now my face don really red ooo,

as things come take be for here naso everywhere here later come settle,

naso i bone face start to dey go house,

as i reach close to my street naso person shout,

see come baba olowo as you take do face so like anointing oil so,
why you never update us the latest baba olowo episode na?

Whats your problem here self?

Naso i still bone face no even answer the idiot,

oboy the guy shout again,

see come baba olowo as you take keep neck like all this yoruba touts dem so,
why you no won answer me?
Na even recently when i read your last episode i surprise to dey even see you dey type in english join this our baba olowo pidgin story dem,

see come na thunder make just go vacation nahim go help me fire that your yansh for there so,

hahahahahahaha

chaiii wetin be this?
I tell una say na one guy make dem dey call johnson anyanwu the slay baby nahim burst laugh,

baba dey laugh dey shine teeth seriously,

johnson anyanwu the slay baby shout,

nothing for this life dey sweet me pass say person dey help us insult yab baba olowo,

i swear the thing dey give me sweet orgasm,
i cant explain the kind of joy my heart use to get from seeing baba olowo been insulted,

hahahahahahahaha
baba burst laugh
kikikikikikikikikikiki

naso me baba olowo turn look the guy make dey yab me and johnson anyanwu make dem dey call the slay baby,

hmm the thing just weak me as their two even resemble people make their fathers pursue comot from house,

naso i tell them,
see come as una two take resemble all this secondary schools their mid term break so,

na kabu kabu motor nahim go help me jam una wide mouth as una dey talk to me here so,

well i no blame una since una father and mother don plan pursue una comot from house,

as una do face so like madman waist products,

hahahahahaha
i tell una say na one babe make dey pass her own nahim burst laugh ooo,

the babe dey laugh dey shout,
kikikikikikikikikikikiki
ohh my gosh whats all this?

As we still dey talk,
i no believe one guy make dem dey call eskelenje waka come like who dey play lotto,

eskelenje waka go meet johnson anyanwu the slay baby,

hello baby its been a while na?
Why have you not been visiting me since all this while dear?
You know i have been missing you since baby?

Hahahahahaha
laugh won really kill me for here,
chaiii wetin be this?

Naso johnson anyanwu the slay baby shame answer am,

you know i have not been around all this while dear,
i have been busy putting things all together so i can be chanced to come and see you when am free,

ahhh the thing surprise me baba olowo die,
naso i shout,

see come johnson anyanwu,
as you take do face so like who choleral catch so,
which one be all this one na?
So na gay nigga you even be self guy?
Chaiii this world don really end ooo,

anyways i no blame you fool,
as na your type dey help people go grind pepper and tomatoes dem for bustop,

as you do teeth so like charcoal board,
with your bears like all this kidnappers dem make dey stay for under bridge,

hahahahahahaha
people make dey pass dem burst laugh,

hahahahahahaha

naso i tell eskelenje,
see come eskelenje as you take do face so like who dey carry cement before dey offload from trailer so,

na thunder make dey gym nahim go fire your testicles there for you,

as you won help us disfigure this our fellow guy make dem dey cal Johnson Anyanwu,

So you no see all this sweet babes dem go bang na our sweet loving brother you see dey call your slay baby abi?

Na people like you dem supose send go sambisa forest go fight boko haram dem,
so make dem fit see you kill sharp sharp,

as you do back so like madman offspring,

hahahahahahahaha
laugh won kill people,
chaiii wetin be this?

Oboy we no believe for our front,
eskelenje baba hijack johnson anyanwu the slay baby with speed tear race enter room go fuckkk,

ahhh the thing really surprise everybody,

Johnson Anyanwu dey shout abeg your thing too big ooo,

ahhh abeg wetin just happen here so?

People laugh tire for here,

i tell una say the thing surprise everybody for here,

naso people rush dey go knock for the room make eskelenje carry johnson anyanwu the slay baby enter,

ahhh people dey shout,
abeg bros no kill am ooo,
your thing go big too much for that guy yansh ooo

hahahahahahaha
wetin happen next you no go believe,

episode 87 coming soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:20pm On Apr 23, 2019
Its been a long road but we are here now

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:54pm On Apr 23, 2019
Episode 87
( is baba olowo a wasted talent? )

as things come take be for here,
eskelenje don hijack our guy johnson anyanwu the slay baby go bang craze for room,

i no believe one man shout,
is baba olowo a wasted talent?

Ahhh people surprise shout,
you say wetin?

Abeg wetin consine us with say is baba olowo a wasted talent with this rape issue make dey on ground here so?

naso the man still shout again,
please everyone here,
is baba olowo a wasted talent?

Chaiii the thing weak everybody for here,

i swear for my life this na one of the most emotional episode i go ever drop here,

we no believe one woman burst cry,

hmm its painful to say or to see,
baba olowo to me is not a wasted talent all he needs is just a little bit of exposures and love,

naso one guy shout dey cry,
its not really easy reading baba olowo funny stories almost everyday,
to me he is not a wasted talent,

we no believe one babe cry shout,
i have been following baba olowo stories from the beginning till the present episode now,

never have we seen baba olowo droped an episode that moves us to tears like this before,
although we never knew or believed much in him,

one guy breath in shout,

hmm its been a long road but we are here now,
to me baba olowo is my number one funny online nigga,
he makes me laugh anyday i read his funny episodes online,
he really makes my day feel brand new as i always seems to forget most of my stress and worries with laugh,
i tell you there was one day i was walking alone on the road and suddenly starts laughing when i remembered baba olowo different funny stories,

to me all dedication to our one and only baba olowo,

naso one small boy cry dey shout,
i have never had the oportunity to know who baba olowo truelly is,
although he always makes my day feel happy reading his stories,

to me i dont have a phone yet to call my own,
but anytime i have the chance to go online the first things i do check is if baba olowo has posted his latest funny episode,

to me its a sad thing to see baba olowo cry or been sad,
indeed he needs encouragements because indeed its been a long road but we are here now,

oboy i tell una say the small boy start to dey cry ooo,
na women dem rush go console the boy as him dey cry,

oboy we no believe d blacc baba send me text message from prison,

hmmm baba olowo my number one nigga,
you are the only compensation that i have while am here roasting in the prison cells,
i always got courage anytime am reading this your funny stories online,

although am been locked away but that does not mean we dont read your funny stories here in the prison,

please my brother take heart and God will console you,
its been a long road but we are here now,

ahhh the thing touch me die,
chaiii d blacc baba make dey prison nahim send me this text message so,

chaiii people here won cry,

we no believe one guy shout,
abeg na baba olowo episode 87 be this abi na where dem dey mourn for person make just die so?

See come i suppose dey laugh by now ooo,
why tears come full my eyes like this na?
See come baba olowo why you do me like this na?

No yabbing and no funny stuffs abeg which kind episode be this one self?

Why have you really forsaken us na baba olowo?
Ahhh life don tire me,

chaiii the guy burst cry,
na people rush go console the guy,

hmmm one guy cry shout,
in the beginning there was hardships,
in the very beginning till now there is still hardships,
please baba olowo take heart,

naso i tell people,
earlier this year the man i was working for died of sudden heart attack,
i was forced to leave there to look for another place,

although life has not been rosy for me baba olowo but i had always looked for time to update my fans dem my latest funny episodes,

this is life and we all go through temptations and trials,

naso one babe stand up cry shout,
i have never seen any story more funnier back to back like your funny stories here baba olowo,

you have indeed made me your number one fan,
i love you and will always be there to support you baba olowo,
you are the best thing that can ever happen to us here,

please may your mind be at rest and forget all the hardships of this world,
baba olowo you are my number one nigga,

ahhh the babe burst cry,
na people dem still rush go dey clean the babe eyes,

chaiii baba olowo don really touch our hearts today,
hmm some niggas wants to be like me but keep wondering how i keep doing this,
how come i do drop funny episodes here back to back,
they really wished they where me baba olowo

hmm its indeed been a long road but we are here now,

there are some times man needs to recheck all his moves and actions,

even if things are going really well for you but it seems you are not really happy for no reason,
this is what is called depression of the soul,

it happens to everyone and every race,
so it does not litterally means things are not going well for you,

abeg sorry to all my niggas and fans,
me baba olowo never intended to do this,

episode 88 coming soon

(1) (2) (3) ... (10) (11) (12) (13) (14) (15) (16) ... (22) (Reply)

Out Of The Blue / House Of Secrets : A Story By Angelsss / Story: A New Dawn

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 233
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.