₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,326,498 members, 8,426,818 topics. Date: Sunday, 14 June 2026 at 11:44 PM

Toggle theme

Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) - Romance - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralRomanceWetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) (1346 Views)

1 Reply (Go Down)

Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:23am On May 29, 2020
Abeg which matter wuna de settle for wuna area sohuh??

LockDown Lockdown Boredom grin
Mine
1. Landlord wan chase tenant for house, tenant vex call NCDC say landlord get Covid symptoms..na de matter we dey settle like this

2. Side chick carry sugar daddy moto go do hair for him wife saloon, na dey matter we dey try settle since yesterday

3 Tenant we de owe landlord mistakenly comment "cult people" instead of "Cute people" for landlord family picture...
Na de Matter we de try settle since yesterday

4. Yahoo boy collect charm from baba use am scam baba pikin when dey Canada.. we dey back yard now dey argue how we go resolve matter

5. Native doctor faint we don rush am hospital now...

6. Police escort nepa go cut another police station light
Na case wey we settle this evening for junction

7. I escort my friend go police station, we de station my guy fone come lost there, we try calling... Phone de ring for DPO pocket...
We come vex go another police station go report...
Since we de try settle matter..be like say this kind matter no fit settle cool

Add your kiss wink
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:23am On May 29, 2020
E don happen o
Vigilante don break soja windscreen to enforce quarantine order..
Na fight we dey watch like this
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:23am On May 29, 2020
Boyfriend dun call babe through her papa phone now na d matter we dey settle
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:24am On May 29, 2020
Girl promise me Puna
I come she no gree allow me Bleep
Na de matter Dem de try settle us now ooh
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:25am On May 29, 2020
They send 20k for me to give my mama bank don remove there ATM maintenance charge, now I dey with 19,621 naira so na the matter wea I dey settle with am
I don tire with the matter saf
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:26am On May 29, 2020
Doctor wey suppose deliver pikin don go finger the woman sotey the pikin one eye don burst..

Na the matter we dey settle since yesterday matter no wan finish
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:28am On May 29, 2020
Madam mistakenly shout musa while sleeping...
Oga com vexx, the mater don reach police station now, we no fit settle ahm
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:28am On May 29, 2020
Doc impregnate one covid patient for isolation center...


Na de matter we dey try settle
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:29am On May 29, 2020
My friend give him babe money make she do abortion, babe carry money buy data post for Facebook saying mother to be..
Na de matter we dey try settle
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:29am On May 29, 2020
E don happen...
DJ mistakenly play SVC Aromate sally for Aye national jolly..
Na dey matter we dey try resolve since yesterday
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:30am On May 29, 2020
Lock down lockdown...
House girl call oga naughty boy in front of madam... Na de matter we dey try settle
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:33am On May 29, 2020
Landlord no gree pay NEPA bill, tenants vex disconnect landlord light, na de matter we dey try settle
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:34am On May 29, 2020
Usher call pastor ODE for online meeting, na de matter we dey try settle since
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:35am On May 29, 2020
Covid-19 patients go sallah break and dem no gree return to isolation Center... Na de matter we dey try settle so
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 6:37am On May 29, 2020
Simi don born pikin, pikin resemble falz.. Na DNA matter we de try settle since yesterday
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by Gentle0wavez: 7:04am On May 29, 2020
As I see this post I come laugh, my mama come dey ask me which girl I dey gist with this early morning. Na the matter we dey settle since
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by Gentle0wavez: 7:05am On May 29, 2020
HundredWays:
Simi don born pikin, pikin resemble falz.. Na DNA matter we de try settle since yesterday
Kai!! You no get conscience
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by Uyi168: 7:13am On May 29, 2020
shocked.
OP, make i help ur ministry small..

Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by Uyi168: 7:26am On May 29, 2020
angry grin

Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by JAOS(m): 7:49am On May 29, 2020
one boy use him papa pant clean chair for visitor face,,,we still dey find the boy yansh
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by Ifabernard(m): 8:05am On May 29, 2020
grin
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 10:44am On May 29, 2020
Chelsea wan make FIFA cancel their match wit Baryen Munich...we de FIFA office right now the settle the matter
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 10:49am On May 29, 2020
Chinedu go use hand wey ein use grind pepper take finger landlord pikin....nah the matter we de try settle since
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by kingjrofficial(m): 10:53am On May 29, 2020
My guy buy pepper soup for ein side chick...beb chop, later con give my guy BJ..m na the matter we de try settle since yesterday matter no wan finish
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by kingjrofficial(m): 10:54am On May 29, 2020
Trump wan shutdown Twitter.... Na de matter we de try settle since yesterday
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by kingjrofficial(m): 10:55am On May 29, 2020
HundredWays:
Lock down lockdown...
House girl call oga naughty boy in front of madam... Na de matter we dey try settle
grin
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 12:26pm On May 29, 2020
Pikin dey teach papa how to use smartphone... Papa no con understand,
Pikin con vex tell ein papa, MUMU man, how many times I go teach u.....na the family matter we de try settle since morning so���
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by HundredWays(op): 12:27pm On May 29, 2020
My guy invite beb con ein house for sleep over, beb come piss for bed... Na me and my guys de try settle matter since yesterday
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by Galactico4ever(m): 12:32pm On May 29, 2020
Yahoo boy babe don go cook chicken wey babalowo give am make im use renew im juju.We de hospital since last night,the matter don tire me.
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by paulolee(m): 12:58pm On May 29, 2020
oga say him wife no sabi fck bt gateman say na lie...na d matter we de settle since under rain
2... soap wey baba gv akin to take baff mk he for get cliant naim him junior bro take go wash canvas...na d matter we dey on lyk dis
3..student call lecturer baby mi for online class...na d matter we still de try settle like this..
Re: Wetin De Sup For Wunna Area So?? (jokes) by Nobody: 1:04pm On May 29, 2020
My Guy Carry 3k Go Dey Price Jeans Of 15k, Zip Come Spoil Now Like This I Don Run Leave Dey Shop Make e Settle Him Own Matter Only Am��
1 Reply

Wetin Corona No Go Cause'?- See What A 13 Year Old Girl Did For Her BoyfriendIgbo Why?:see Wetin Yansh Do Me For Church Today.Afonja Why?2.see Wetin Toto Nearly Do Me234

Why Do We Share Nudes?ExpiredCan You Imagine?