VlamesIffect's Posts
Nairaland Forum › VlamesIffect's Profile › VlamesIffect's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 (of 62 pages)
Flamemignon1:AYO, what are you on about? Nah man. He did the right thing. Sort of weird donnie is that. O.p stay far away from that guy. Gay mofos. His intentions weren't good from the beginning. If the donnie wanted to be friends he should have been straightforward from the beginning not trying to spike drinks and that. |
hartson: wetin be this...from page 1? Ok o. Better go baby pips instead.... |
Jameselias:I dey tell u. Hopefully move volatility & direction go come in as month dey end |
Pristine664:That entry fit dey a little too late o... because of brief buy pullback my big boss... |
Gasive:So help me God.... ![]()
|
So nobody dun carry vawulence come since.... na wa o... Are we traders or fighters ....make una come find trouble now..... Nobody wan run scam anymore? Nobody wan show us the hidden secret to making 6 figures daily? Give me vawulence.....Give me vawulence....bring it on.... ![]() |
Kaybee7000:You sef see say e choke.... ![]() |
Pristine664: sir I'm not your mentor sir..... Sir any trade insight for next week boss? Anything at all I'll appreciate. Thanks sir. ![]() |
Pristine664:My boss...you na senior man now. if you no mk profit who else wan mk profit |
cybertron88: welcome back |
DannyFX2638:I just checked forexfactory.... PMI data for both eur & gbp coming on Tuesday next week.....that one fit be major trend determinant o. Last month pmi really affected market volume that day.....well anyway..... |
DannyFX2638:Make the run asin breakout buy or sell which one? I dey positive on sell...but e dun take me out early this month. If na sell then i go dey look to buy am September. Unless if sell breakout & confirmation at that low price.... |
charly20:My boss fingers crossed o...why them x/jpy just dey do one kind this month ![]() |
Kaybee7000 se you dey see eurjpy... i just dey look the pair since.... Except say eurjpy run one 330+ pips move next week or before month end. Baba fit reverse. Na why i no dey like chase market when i enter...if i wrong i wrong... i no kill person.... We move... |
My bosses...na wa o....what a month.... Na wa for gbpjpy no sensible volatility....i just dey pray say the last 10 days go carry liquidity.....usdjpy just dey buy...gbpjpy just dey do as him like....I understand say e dey range but how far now... 850 + pips range....yet no sensible movement na wa o. X/chf see as i run cut my loss before gbpchf hit 100 pips sl then boss gbp/chf dun go sell off today.... Flexibility na one important feature of a learning trader...novice like me...I still dey on cad/chf buy around 0.73419 As i dey on cad/chf buy i dun delete eur/cad buy pending order. I no dey hedge cad abeg... Usd cpi just push x/USD to temporary buy before the sell ...me i enter at that very top of last month high. On eur & gbpusd. X/usd na patience go do am this month..... Them aud & nzd /usd i dey use side eyes look those pairs. If them tank next week e go favour intraday..... Now na gbpjpy i just dey hope go do sensible volume before month go end....*fingers crossed*. |
see this one. |
ogashman:You wan carry A-K go fight armour tank? ![]() |
infofirst:You too calm to dey support chelsea. This weekend just somehow for me....cpi first teach me lesson then united lost again. Na so i just sit down dey watch that match. ah what a week. |
![]() Wetin you dey wait for? Is she that good in bed or you just have very low self esteem issues? Be like you dey enjoy suffer head abi? |
Fxwarrior:No be sell gold dey so? Abi na only me dey see am? |
infofirst:Boss i just tire....money mgmt & using SL na him dey save me from things like this.... On my day trading account i just see gbpjpy make that whipsaw i was like which news dey today wey serious like this? Na cpi o.... we move sha... |
lynx200: news na catalyst. News can help or screw you hard. I generally give fundamentals space. But sometimes dey can just move unexpectedly like cpi. Cpi normally no dey move for past how many years....all of a sudden over 100pips in 1 hr. forex na scam. |
Kaybee7000:No mind me...na why i sell still give am space for price manipulation up to 150pips s.l. at the end na money management be koko....na just 2% risk be that. ...x/jpy still fit go buy .....na market get final say... |
Omo this month swing get as e be o...i dun exit X/chf buys after the sell breakout & confirmation on H1..i run cut my loss before e reach 100pips sl. If eurjpy later sell ehn e go pain me o ![]() I enter X/ usd sell after that CPI push x/usd to previous month high (1st August high) see why i dey give news space i bet nobody anticipate say CPI go move like that....Still pending buy limit on cadchf 0.734xx Make person dey take month jeje |
Swing....na pending orders go do am this month o...market execution price entries wey i dey see no dey favourable for me ..... X/usd sell pending order around the immediate previous highs on H1. The high around beginning of the month. X/chf buy the H1 low....100 pip sl....same with Eurcad.....patience na him go do am this month...no pressure no rush... Because i dey wait for news now...gbpjpy dun go buy around 159.5X leave me...na wa o....why dem go dey put BOE meeting first week of new month which kind thing be that.... |
Omo eurjpy dun hit sl . I no even follow up the trade na so i open laptop enter mt5 i no see trade again i been think say my house WiFi dey mess up i reset... refresh am come see say na sl trade dun hit ...i suppose sell around that previous high sha i enter a little early....but anyway we move....Monday we go in.....x/usd , gbojpy, eurcad and x/chf.. How una weekend na... |
Galleryeasy:Boss i still dey learn market....i go try implement am.....but i dey comfortable with giving market space to move so i no go dey chase price....if i dey wrong i dey wrong no hard feelings...we move |
Ok so i sold eurjpy around 136.2xx hoping i go catch a sell 300 pips to that low on H1.... SL of my sell trades dey higher than buy so 150pips sl for 300+ pips profit not bad...no partial profit on sell trades just sl to breakeven when i dey half way in profit..... i still dey wait to buy gbpjpy by Europe opening tomorrow or at least place pending order around 159.5x...make una check abi na my eyes gbpjpy or X/Jpy dun enter range market abi? Eurcad dey look good for buy around 1.296xx but na till Monday i go decide that one...i still dey wait for X/chf buy. & X/usd sell entry ...... That price wey gold dey ehn 1782.xx very good for sell but i no fit till after nfp tomorrow. |
samfelly: forex trader na...abi na hedge fund manager you want make we dey call you ni .....if na me i go just say i work in finance.... finance means a lot of things....anyone wey person wan choose e dey finance. |
charly20:Anyone make market do abeg.... See as Gbpjpy play fast one today.... baba first sell around asia & london come reverse for new york... Market at times go dey play mind games...you see that middle button between buy & sell na their i dey. Make i dey observe |
infofirst: man like info. |


welcome back
Na wa for gbpjpy no sensible volatility....i just dey pray say the last 10 days go carry liquidity.....usdjpy just dey buy...gbpjpy just dey do as him like....