Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,740 members, 7,817,042 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 12:33 AM

Le Roy Don Kari Cunny Come - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Le Roy Don Kari Cunny Come (621 Views)

LE-ROY: We Will Destroy Eagles With counter Attack / I Swear,we'll Shatter Nigeria's Afcon Dream, Says Claude Le Roy / Claude Le Roy Quits! (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Le Roy Don Kari Cunny Come by Livermeka: 5:15pm On Dec 13, 2012
Africa Nations Cup paale, Claude Le Roy, don tok say e go hard make Democratic Republic of Congo (No, no be that yarinya wey dey my street. Dis one na different “Congo”) carri first for South Africa nes month.

Le Roy sabi wetin he dey tok sake of say he been don carri Cameroon take first tay tay (for 1988), come follow take Ghana carri 3rd for Accra sef for 2008. (Yes, na dat one wey Junior Agogo been waya beta goal, de time wen dem bilala our Paale Eagles. E still dey pain me)

Le Roy been dey yarn all dis as contri people ask am whether Congo fit carri first, on Monday.

“Carri first ke?! E go hard us o!”

Le Roy been don coach Syria befor (2011) but he no tay for dia; na only 2 months he been train dem befor he revise come back Congo (Dis Congo na DRC o!) for part 2. (Yes, he don be coachi for Congo befor. Una no say Congo full dat side na)

Congo team waka comot Kinshasa on Monday, becos dem wan land berekete for Port Elizabeth, inside South Africa, to prepia wella.

As dem dey waka, Le Roy tok say, “We wan carri 41 playas for 23 shirt”

“Na only playa wey sabi tap ball I go give shirt.”

“Any playa wey feel say he sabi, na im chance be dis.”

“I no be fada Chrismas.”

Le Roy dem go play for Group B and dem go play hin former boys, Ghana (na small remain wey don no reach final for 2012), Mali (our own coachi former boys) and Niger.

Una rememba say Nations Cup dey start for January 19 and e go finish for February 10.

[b]Africa Nations Cup paale, Claude Le Roy, don tok say e go hard make Democratic Republic of Congo (No, no be that yarinya wey dey my street. Dis one na different “Congo”) carri first for South Africa nes month.

Le Roy sabi wetin he dey tok sake of say he been don carri Cameroon take first tay tay (for 1988), come follow take Ghana carri 3rd for Accra sef for 2008. (Yes, na dat one wey Junior Agogo been waya beta goal, de time wen dem bilala our Paale Eagles. E still dey pain me)

Le Roy been dey yarn all dis as contri people ask am whether Congo fit carri first, on Monday.

“Carri first ke?! E go hard us o!”

Le Roy been don coach Syria befor (2011) but he no tay for dia; na only 2 months he been train dem befor he revise come back Congo (Dis Congo na DRC o!) for part 2. (Yes, he don be coachi for Congo befor. Una no say Congo full dat side na)

Congo team waka comot Kinshasa on Monday, becos dem wan land berekete for Port Elizabeth, inside South Africa, to prepia wella.

As dem dey waka, Le Roy tok say, “We wan carri 41 playas for 23 shirt”

“Na only playa wey sabi tap ball I go give shirt.”

“Any playa wey feel say he sabi, na im chance be dis.”

“I no be fada Chrismas.”

Le Roy dem go play for Group B and dem go play hin former boys, Ghana (na small remain wey don no reach final for 2012), Mali (our own coachi former boys) and Niger.

Una rememba say Nations Cup dey start for January 19 and e go finish for February 10.

[/b]Africa Nations Cup paale, Claude Le Roy, don tok say e go hard make Democratic Republic of Congo (No, no be that yarinya wey dey my street. Dis one na different “Congo”) carri first for South Africa nes month.

Le Roy sabi wetin he dey tok sake of say he been don carri Cameroon take first tay tay (for 1988), come follow take Ghana carri 3rd for Accra sef for 2008. (Yes, na dat one wey Junior Agogo been waya beta goal, de time wen dem bilala our Paale Eagles. E still dey pain me)

Le Roy been dey yarn all dis as contri people ask am whether Congo fit carri first, on Monday.

“Carri first ke?! E go hard us o!”

Le Roy been don coach Syria befor (2011) but he no tay for dia; na only 2 months he been train dem befor he revise come back Congo (Dis Congo na DRC o!) for part 2. (Yes, he don be coachi for Congo befor. Una no say Congo full dat side na)

Congo team waka comot Kinshasa on Monday, becos dem wan land berekete for Port Elizabeth, inside South Africa, to prepia wella.

As dem dey waka, Le Roy tok say, “We wan carri 41 playas for 23 shirt”

“Na only playa wey sabi tap ball I go give shirt.”

“Any playa wey feel say he sabi, na im chance be dis.”

“I no be fada Chrismas.”

Le Roy dem go play for Group B and dem go play hin former boys, Ghana (na small remain wey don no reach final for 2012), Mali (our own coachi former boys) and Niger.

Una rememba say Nations Cup dey start for January 19 and e go finish for February 10.

http://www.supersport.com/football/africa-nation-cup/news/121211/Le_Roy_don_kari_cunny_come

(1) (Reply)

Guiness World Records Recognises Messi’s Goal Scoring Record. / Top 10 Reasons Why Keshi Will Fail At Afcon / Who's Arsenal Greatest Between Thierry Henry And Dennis Bergkamp

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.