Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,672 members, 7,816,760 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 04:37 PM

Na Wa Oh...so Keshi No Pick Osaze And Martins - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Na Wa Oh...so Keshi No Pick Osaze And Martins (529 Views)

Woman Defrauds Osaze Of £70000 / Osaze Warns Keshi To Watch His Back / Osaze's Congratulatory Message To The Super Eagles (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Na Wa Oh...so Keshi No Pick Osaze And Martins by Livermeka: 11:12pm On Dec 21, 2012
http://www.supersport.com/football/nigeria-naija/news/121221/Keshi_no_pick_Osaze_and_MartinsHead Kochi of d Naija Supa Eagus, Stephen Keshi don finaly rilis him 32 Playas wey go fight for d 23 shirts for d Supa Eagus tim dat will go to d 29th AFcon nes year Januari in South Afrika.

Keshi and him Oga for NFF meet for Abuja on Friday wia him roll out d names of him playas wey kontain 14 Playas wey dey play dem futball for d Naija ligue and 18 wey dey play for Obodo Oyinbo.

Kaptain Joseph Yobo who don play for 5 AFcon for him career in 2002, 2004, 2006, 2008 and 2010 na him top d list of d Playas wey go come from Obodo Oyinbo.

Min Y, Caf don give all d 16 tims wey go play for d AFcon for South Afrika nes year make dem submit dem fina 23 Playas b4 Januari 9 2013.

NFF don arrange intl friendlies for d Naija Supa Eagus against Catalonia and Cape Verde for Portugal on Januari 2 and 9 nes year.

Chai, Oga Keshi no dey look Uche's face atol as him no pick Osaze Odewinge and Obafemi Martins among dos wey go follo him go South Afrika.

Make una look at d playas wey Keshi call.

Goalkipas: Vincent Enyeama (Maccabi Tel Aviv, Israel) Austin Ejide (Hapoel Sheba, Israel) Chigozie Agbim, Enugu Rangers, Nigeria) Daniel Akpeyi (Heartland FC, Nigeria).

Defendas: Elderson Echiejile (FC Braga, Portugal) Juwon Oshaniwa (Ashdod, Israel) Benjamin Francis (Heartland FC, Nigeria) Joseph Yobo (Fernabahce, Turkey) Efe Ambrose (Celtic, Scotland) Solomon Kwambe (Sunshine Stars, Nigeria) Azubuike Egwuekwe (Warri Wolves, Nigeria) Danny Shittu (Millwall FC, England) Kenneth Omeruo (Ado Den, Netherlands) Godfrey Oboabona (Sunshine Stars, Nigeria).

Midufidas: Mikel Obi (Chelsea, England) Nosa Igiebor (Real Betis, Spain) Ogenyi Onazi (Lazio, Italy) Raheem Lawal (Adana, Turkey) Obiora Nwankwo (Calcio Padova, Italy) Fegor Ogude (Valerenga FC, Norway) Reuben Gabriel (Kano Pillars) Rabiu Ibrahim (Celtic FC, Scotland).

Strikas: Ahmed Musa (CSKA Moscow, Russia) Emmanuel Emenike (Spartak Moscow, Russia) Brown Ideye (Dynamo Kiev, Ukraine) Victor Moses (Chelsea FC, England) Uche Kalu (Rizespor, Turkey) Bright Dike (Portlands Timbers, USA) Shola Ameobi (Newcastle United, England) Ikechukwu Uche (Villareal, Spain) Ejike Uzoenyi (Enugu Rangers, Nigeria) Sunday Mba (Enugu Rangers, Nigeria).

http://www.supersport.com/football/nigeria-naija/news/121221/Keshi_no_pick_Osaze_and_Martins
Re: Na Wa Oh...so Keshi No Pick Osaze And Martins by AbdulAdam56(m): 11:17pm On Dec 21, 2012
Super eagles.
Re: Na Wa Oh...so Keshi No Pick Osaze And Martins by chelseabmw(m): 12:38am On Dec 22, 2012
Kool undecided

(1) (Reply)

What Are Your Best Club Football Moments Of 2012? / Did Keshi Make A Mistake By Droping Bright Dike? / London 2012 Olympics: Athlete Claims NOC Asked For Bribes

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.