Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,694 members, 7,816,836 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 06:26 PM

Ashley Williams Na Killer - Ferguson - European Football (EPL, UEFA, La Liga) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / European Football (EPL, UEFA, La Liga) / Ashley Williams Na Killer - Ferguson (425 Views)

Picture Of Ashley Youngs Wife / Alex Ferguson’s Last Chewed Gum For Sale On E-bay / Extract From Ashley Cole's Book: My Defence (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Ashley Williams Na Killer - Ferguson by Livermeka: 1:24pm On Dec 24, 2012
http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121224/Ashley_Williams_na_killer_Ferguson


Ashley Williams na killer - Ferguson

Manchesta United coachee Alex Ferguson dey vex say Swansea Citi defenda Ashley Williams for kill Robin van Persie during d 1-1 draw wey dem play.
D Wales defenda bin take shot hamma Van Persie for head wen im dey ground for d second haff od deir match, wey come make players dem start to dey fight inside field. Even as refuree come book Van Persie and Ashley Williams.

Swansea numba 1 gol man, Michu bi cansil Patrice Evra gol,wey come stop Fergie and im boys to tak incris d 6 point wey dem get for City head.

" Robin van Persie lucki say im dey alife " Feguson talk

" Na disgrace wetin dier player do today and d FA sef suppose ban am for d yeye tin wey im do, im for kuku break Robin neck sef.

" Wetin im do na one of d veri dangeros tin wey i don eva see for field for plenti plenti years, im sabi wetin im dey do and na for refuree front e happen"

Williams talk say wetin happen na accident and im tell Sky Sports say " Me jus clear ball, na vex plus frustrashun i take hit d ball and e come hit am for head, and d tin vex am.

Swansea catch fire for d beginin of d match, Michu nearly score as im lif Nemanja Vidic for back run go, before Wayne Rooney sef and Ashley Young pepper Swansea gol kipa Michel Vorm wey just come back from injuri.

United come score for d 16 minute and Evra header enta net from d cross wey Van Persie cross, na im numba 3 gol dis seasin and na with head e take score all of im gols.

For d 29 minute. Wayne Routledge pass, bin clear space for Jonathan de Guzman, as im run take shot, De Gea come stop am but Michu dey beta postion to put d ball inside Manchesta net come score d numba 13 gol dis seasin

Vorm bin save Rooney shot before halftime reach, and Ferguson sef bin halla refuree why im no do anytin when Chico Flores bin push Van Persie fall for ground befor Swansea run go score dier gol.

De Gea sef dey action as im save shot from Routledge and Kemy Augustine and d two team dey play demselves to see who go score d winning gol.

Na United fess draw dis seasin be dat for all d kompitishion wey dem play and na onli four point dem take gap Manchesta City now as dem dey prepare for Newcastle United match for house.

Arsenal dey 3rd now for table as per d 1-0 win wey dem win Wigan, and dem be one of d team wey get 30 point, togeda wit Everton, Tottenham Hotspur and West Bromwich Albion.


© supersport.com
http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121224/Ashley_Williams_na_killer_Ferguson

(1) (Reply)

Champions League Quarters Revealed.. / Has Mourinho Failed @ Madrid?? / Preview: Fc Barcelona Vs Real Betis. Sunday, May 5th, 2013.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.