Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,697 members, 7,816,853 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 06:51 PM

Maybe Benitez Get The Manual For Fernando Torres! - European Football (EPL, UEFA, La Liga) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / European Football (EPL, UEFA, La Liga) / Maybe Benitez Get The Manual For Fernando Torres! (449 Views)

Fernando Torres On Loan To AC Milan / Fernando Torres Wins Golden Boot At Euro 2012 / Fernando Torres Vs Robin Van Persie: Who's Better (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Maybe Benitez Get The Manual For Fernando Torres! by Livermeka: 9:17pm On Dec 25, 2012
http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121225/Benitez_bilif_say_Chelsea_still_get_powerBenitez bilif say Chelsea still get power

Benitez bilif say Chelsea still get power

Rafa Benitez bilif say Chelsea dey show sign say dem fit challenge for d title as dem dey prepare to play Norwich for Carrow Road for Wedenesday.
Chelsea scatta Aston Vila 8-0 for Sunday match, na one of dier ogbonge tapping wey de tap dis seasin b dat afta dem nack Leeds 5-1 for Lig Cup quata final.

Na onli one goal remain for dem to score to comot d rekod for Premier Lig wey klub don score for match before and na 7 diffrent players score d goals sef for d Aston Vila match.

D plenti gols don cari Chelsea reach numba 3 for table, 11 point for Manchesta bak, but dem still get 1 game wey dem still go play.

Benitez dey pray say d form wey dem don show since d time wey dem come back from Japan afta d World Klub Cup, go dey kontinue as dem go wan try challenge Manchesta United and Manchesta Citi to c weda dem go fit catch dem.

" I hope say d wey go dey tap wella as we dey go, d players mentalo sef don change, even wen we score 6, we still dey go front to c say if we go get anoda gol"

" If we fit continu like dis , manage win our match dem, den anytin fit happen" E be like say Brazil defenda David Luiz go play for midufiel again against Norwich dem, even as Chelsea go try to win 3 match strait.

John Terry no go play, so na Branislav Ivanovic go patna Gary Cahill for back, Frank Lampard bin celebrate d ogbonge 500 match wey im don play for Premier Lig come take score d numba 4 gol for d match wit Aston Villa, but wahala dey small becos e be like say dem no go gif am new kontrak for Stamford Bridge.

Im kontrak go expire for d end of dis seasin, and wit d plenti amebo we say im fit waka go QPR abi na Monaco for France, Benitez sef kuku no talk anytin

" Lampard de veri impotant for here oh, na korrect pesin, e dey train well and im mind dey here " Benitez talk

" I hapi say im score sef, seasin still long and im dey try well well". Norwich bin surrenda d unbitin wey dem get inside 10 match, na West Brom do dem strong tin for Saturday, but dem don win d lass 5 match wey dem play for house.

Grant Holt fit play d match afta im bin miss d match for West Brom side, but d coachee no go gamble on top im fitness as per plenti match dey for dis Krismas time

" We dey hope say Grant go dey for d Chelsea match, but we go c as e go b. Im bin nealry play West Brom, we but wan make sure say im fit kakaraka before we trow am enta match" Hughton yarn.

" Seasin still long, no b say we go just gamble anyhow, odas dem dey, so if Holt no too tight, we go use d odas ones and dem sef dey tap ball well"


© supersport.com
Re: Maybe Benitez Get The Manual For Fernando Torres! by chelseabmw(m): 7:53am On Dec 26, 2012
undecided undecided undecided WTF

(1) (Reply)

Wenger 'not Close' On Any New Signings For Arsenal / Alex Fergerson Refused To Shake Benitez Hand / Champions League Semi Final Draws

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.