Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,779 members, 7,810,033 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 07:04 PM

Akpos Interveiws Saka {"why I Port Go M.t.n"} - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Akpos Interveiws Saka {"why I Port Go M.t.n"} (835 Views)

Saka Rejects Ministerial Position / Akpos Interveiws Saka {"why I Port Go M.t.n"} / The Akpos Adventure - Post Only Akpos Story Here. Enjoy! (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Akpos Interveiws Saka {"why I Port Go M.t.n"} by DoctorShroud(m): 2:23pm On May 26, 2013
Below is the excerpt of akpos interview with saka.

Akpos : saka how d go dey go na?

Saka : .....{ akpos notices saka is dosing }

Akpos : {taps saka on the shoulder} saka wake na, why you com dey sleep like dis na.

Saka : eh! Eh {he wipes his eyes} i no dey sleep o

Akpos : {irritated} then wetin you come dey do.

Saka : i dey dream, infat i dream say i b obama.

Akpos : na im b say , america na yankari game reserve o.

Saka : no insult me {he grimaces}

Akpos : no vex na, abi pesin no fit play wit u again.
Oya Wetin be d meaning of your name?

Saka : my name? {laughs}, na one day when i go america, so for dia na im i go toast queen elizabeth, na im she call me. "Sack of shit" . but d way she talk am sweet, i hear "sack'a'shit", na im i throway d shit collect saka!!

Akpos : saka saka!! u dey wise, and you sabi filter!!

Saka : thank u /thank u


Akpos : So tell us why u port go m.t.n!

Saka : {laughs hysterically} krikata krikata, i don port to m.t.n eh!!

Akpos : eh tell us, y u port na.

Saka : i know say all of una go dey think say na because of money, but no be because of money!

Akpos : {getting curious} then y u port?

Saka : if u wan knw! Bring ur ear come, make i tell u.{ akpos goes closer, and saka whispers inaudibly to him. }

Akpos : yaaaaaaaay!! {akpos jumps up and begins to sing and dance } I don port o! i don port o, akpos don port to M. T. N chei!! KriSAKA KriSAKA!

(1) (Reply)

The Arabs & The Marine / The Picnic / Laff! Laff!! Laff!!!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.