Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,194,546 members, 7,955,026 topics. Date: Saturday, 21 September 2024 at 02:49 PM

Mexico Flog Naija - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Mexico Flog Naija (565 Views)

Fifa Women Under-20 World Cup: Nigeria Vs Mexico, FULLTIME (1:1) / Mexico V Nigeria: FIFA U-17 World Cup (1 - 6) on 19 Oct 2013 / Super Eagles Vs Mexico - (2 - 2) -Intl Friendly On May 31 2013 (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Mexico Flog Naija by Livermeka: 8:39am On May 30, 2013
The way wey de Naija Flying Eagus take stat dia waka for de Toulon tournament for France don get k leg afta Mexico flog dem 2-0 for dia first group game on Wednesday nite.

The Flying Eagus wan use dis championship prepare diasef well well for de 2013 U20 world cup wey go shele for Turkey next month.

Walahi, na from de first minute na hin Mexico don dey nack Naija plenty attack, but de odeysi wey de Flying Eagus dey use helep dem small as dia defendas just dey parry all de shot wey Mexico dey waya dem kommot.

Kasala kon happen for Naija in de 27th minute wen Samuel Mathias go smoke ciga for petrol station and Morales Zavala no kumma waste time as him bomb Naija with de first gol.

The gol wey Mexico score pain Naija Boys die and naso dem too kon dey nack Mexico plenty attack as dem been wan ekwalise, but no way for dem and naso de first haf take finish.

Naija carry swagga stat de second haf, and walahi dem suppose ekwalise in de 48th minute wen strika Olarenwaju Kayode carry beta pass give Edafe Egbedi, but de shot wey de guy play no fit score Mexico golkipa, Sanchez Alcaraz.

Naso de game just dey sweet dey go for de second haf before Mexico kon score dia secon gol through Abella Fantul in de 72nd minute and naso de game take finish.

For de second game wey dem play for group B, Brazil bulala Belgium 2-1 as na dem dey top de group now with 3 points.

The Naija Flying Eagus go jam Belgium on Sunday for dia second group game and dia coachi, John Obuh tok say him boys go improve against Belgium.

“Chai, de koboko wey Mexico take flog my boys pain me, but no yawa as we go improve for our second game,”. Naso Obuh tok.

http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/130530/Mexico_flog_Naija
© supersport.com

1 Like

(1) (Reply)

Mikel Puts Career On Line After Defying Chelsea Doctors Order To Play Namibia. / AC Milan Owner Berlusconi Jailed For Seven Years / Liverpool Reject Arsenal's 30million Pounds Bid For Luis Suarez

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.