Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,451 members, 7,958,354 topics. Date: Wednesday, 25 September 2024 at 12:58 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! (1458 Views)
Nigeria Pidgin Proverbs & Their Meanings / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN / Igbos come show your proverbs skills (2) (3) (4)
Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by Rapmoney(m): 12:53am On Dec 30, 2013 |
My pipo, dem say the words of our elders are words of wisdom. Make we use this medium take nack strong gbudugbudu and surugede proverbs Wen our papa dem dey take give pikin advice. Okay na... Dem say goat know say nor be small waka waka dey for this life, na im make am wear Shoes come life o Dem say tortoise know say to pay house rent nor easy at all na im make am carry e own house come life. Dem say no matter how nyash make yanga reach leg must still first am enter house. You can add yours... |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by waleadex(m): 2:30am On Dec 30, 2013 |
King house wey burn na beauty he add put.... |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by OdenigboAroli(m): 11:56am On Dec 31, 2013 |
Nobi today nyansh begin dey for back. |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by OdenigboAroli(m): 11:58am On Dec 31, 2013 |
Our fathers talk say e better make we de use day time take find black goat before e dark. |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by ladionline: 6:00pm On Dec 31, 2013 |
fly wey no dey hear word, na im dey follow deadybody enter grave. Confusion break bone, deadybody get accident, na double wahala bidat o, make we no see am. this life, na jeje. wetin man so, na im he go reap. fowl wey shit wey no wash yansh, na im sabi. another (one) man food, na another man poison, trouble dey sleep, yanga go wake am. when conny man die, conny man bury am. wise man wey go die for dundy backyard, e get as e be o. the proverbs them no be my own o, them ol people wey don tay for this ogbonge world, wey we be newcomers get am, na them sabi, my own na to yarn, I throwey salute ooo elders, na small pikin they worry me, make i no go misyarn. I still dey laugh ooo. |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by Rapmoney(m): 7:23am On Jan 03, 2014 |
ladionline: fly wey no dey hear word, na im dey follow deadybody enter grave. Omo boy, Kpakam for you!!! You get mouth! |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by Rapmoney(m): 7:28am On Jan 03, 2014 |
Dem say snake wen talk say na tortoise back e wan bite, na toothache go kill that Snake o! 1 Like |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by ladionline: 9:15am On Jan 03, 2014 |
Cokroach wey dey hala say im must to visit canteen wey angry man stay dey chop, abeg make una leave am. Anything wey im eyes see, make im manage am. Lizard no wan be chronic bachelor o, na family matter tire am. |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by Rapmoney(m): 11:13pm On Jan 03, 2014 |
My pipo, I troway salute o, Nor be any shirt wen you see wen get holes na e be lace o! Some na cockroach chop am. Dem say no matter how woman wor wor reach, she go still bele. Dem say if say goat see salad, e for nor start to eat grass Oya na, clear road for Warri boy...Areeeeeeaaaaaaaaa!!! |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by Rapmoney(m): 11:19pm On Jan 03, 2014 |
Dem say wen dem ask lazy pikin why e nor go school, e go say biro too heavy |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by ladionline: 6:21pm On Jan 04, 2014 |
Rapmoney: Dem say wen dem ask lazy pikin why e nor go school,Pikin no sabi book, him mama dey there dey talk say him pikin get handwriting. |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by kemiola89(f): 10:55am On Jan 05, 2014 |
chei! Make una no come take laugh scatter person ribs oo. Miguo to all me warri peeps for house oo. 1 Like |
Re: Drop Your Gbudugbudu And Surugede Proverbs Here!!! by bubbaGambino: 2:34pm On Aug 13, 2020 |
T0t0 water nor plenty, but e dey reach preeq take baff |
(1) (Reply)
Mandela Glasses Sculpture Defaced / A Comprehensive History And Development Of The Igbo Language / What Igbo History Book Is The Closest To Igbo's Oral History?
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16 |