Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,872 members, 7,956,295 topics. Date: Monday, 23 September 2024 at 09:20 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (41779 Views)
Some Nigerian Ethnic Groups And Their Dressing Styles (pictures) / Edo State Proverbs In All Dialects With Translation(s) / Nigerian Proverbs (in English) (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply) (Go Down)
Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by HopeAlive14(m): 10:07am On Dec 07, 2014 |
1. When thief thief thief thief thing, e don red be that. Wahala dey o. 2. Year wey get January dey get December o. 3. No matter how snake long reach, e no fit wrap imself around palm tree from bottom to the top. 4. If needle fall inside river, dem no go fit see am pick again o. 5. Na fly wey no get Special Adviser dey follow dead body enter grave (no wonder we have so many Special Advisers in Government) 6. Do to other people wetin you want other people to do to you. 7. No matter how okro plant grow reach, e no dey tall pass who plant am. When time to harvest am reach, the owner go bend am down. 8. If woman deny man food, na man go still chop am. 9. Person wey no chop beans no dey shit beans o. 10. Dem say love is blind. If blind person lead another blind person, both of them go fall inside pit. 11. Na people wey dey use Mace fight for assembly Mace go tear head, no be me wey siddon jeje for my house. Oya, spice it up by adding your own and let’s have a fun-filled, stress free Sunday. 15 Likes 9 Shares |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by donmalcolm21(m): 10:21am On Dec 07, 2014 |
D water wey Buhari don take eye cry for naiJa go fit make ocean for Katsina. 61 Likes 8 Shares |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Zonacom(m): 10:40am On Dec 07, 2014 |
If army slap you, you go know say police na your friend 76 Likes 5 Shares |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by tobillionaire(m): 10:58am On Dec 07, 2014 |
E no. Easy. To b a man o 6 Likes 2 Shares |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by acenazt: 10:59am On Dec 07, 2014 |
pikin no fit compare prick with him papa. you no need spoon to chop slap no matter how chicken fly e must still come down 42 Likes 4 Shares |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Mogidi: 11:09am On Dec 07, 2014 |
donmalcolm21: 8 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PapiWata: 11:10am On Dec 07, 2014 |
Na only person when get patience well-well, go fiti cook stone sotay e go done reach to chop. Where there is a will, you go meet relative plenty. Out of all lizard when lie-down ontop roof for sun, na only the one when belle dey worry am, go fiti know hinself. The run when buffalo run after wey hunter shoot am wound, na to save him own life TOGETHER with hunter life, make am dey run. No how wey hungry fiti wire bush rat, wey he go forget himself put leg near the place when only one ripe banga dey for ground, because na trap be dat. Na the ting when bush rat take eye see for night, come make am by-force dey wakka SOFTLY for afternoon. Man pikin when take eye see die, begin dey run like antelope, nogo remember the leg when dey pain am before. No how wey tortoise wakka go far, na for inside hin house he go sleep that night. Monkey no fine, but him mama love am. Over-sabi person when carry him dog go sell, come take the money buy baboon for market, go regret hinself and cry say "had I known", when time reach. 24 Likes 3 Shares |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by tonyot(m): 11:32am On Dec 07, 2014 |
pikin wey say him mama no go sleep, him ma no go sleep too 13 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by emirateprince: 11:36am On Dec 07, 2014 |
who belle full go hungry. 10 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by kokoA(m): 11:50am On Dec 07, 2014 |
Na as goat take stand for market na ehm dem dey price am. Shoe get size Pikin wey no play today must play tomorrow 14 Likes 1 Share |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by publicenemy(m): 11:55am On Dec 07, 2014 |
woman wen don born no dey fear Pènis. 73 Likes 3 Shares |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PapiWata: 11:55am On Dec 07, 2014 |
kokoA: Chai. That one dey deep o. Mean say if the goat no sabi stand witi correct yanga, dem nogo price am well for market. Wonderment. 7 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Alphaoscar: 11:57am On Dec 07, 2014 |
If we pound yam inside Bill Gate's jet and cook delicious soup on top Bill Clinton's head, a clueless President will still remain clueless!!! Mama piss say so. 10 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PapiWata: 12:02pm On Dec 07, 2014 |
Alphaoscar: Oga tender you resignation NOW. Common Broken language, you no sabi. After now, you go open mouth begin dey blow lie say you be Africa man, but as we see say you be fake, we don kukuma BAN you commot for this topic. 16 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by kokoA(m): 12:14pm On Dec 07, 2014 |
Breast wey stand gidigba today must fall tomorrow Rake from today till tomorrow you no fit use teeth grind bottle Small girl wey no wan sidon for one place, na one prick go advice am one day. Pikin wey say him mama no go sleep, him ma no go sleep Person wey say my water no go boil, him own no go hot. Na person wey don chop beleful dey ask for big meat 31 Likes 4 Shares |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by lionduke(m): 12:58pm On Dec 07, 2014 |
rolling stone na person push Am.. pikin wey say I'm mama no go sleep, sleep no fit catch Am. he who fights and run away, na fear dey catch am. 6 Likes 2 Shares |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by IVORY2009(m): 1:07pm On Dec 07, 2014 |
Person when dey cry, dey see road oh pointing one finger, and others pointing back @ you. 4 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by macpetrus(m): 1:49pm On Dec 07, 2014 |
1 Like |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by holatin(m): 1:49pm On Dec 07, 2014 |
Na style pesin dey kill the mosquito for im ball. 10 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by bunmioguns(m): 1:49pm On Dec 07, 2014 |
2 Likes
|
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Isiterere(m): 1:49pm On Dec 07, 2014 |
Hmmmm To be a man no be day job Gossip no get reward ALL IZZ WELL 2 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by natureblack(m): 1:49pm On Dec 07, 2014 |
**Toto wey still get water fit born pikin no matter the age **barren woman no dey reject to shine Congo anytime,because she no know the one wey fit turn to belle (pregnancy) **old woman dey always fear when she hear dry born for proverb **prick talk say the water wey dey for toto no plenty, but e dey reach am baff **you no fit use big prick threaten ashawo 28 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by lovinhubby2wife(m): 1:49pm On Dec 07, 2014 |
present |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by felixchip(m): 1:50pm On Dec 07, 2014 |
Laughter want kill me. Ok. Pikin wey carry I'm Papa up, Too many scatter scatter and yaga yaga go cover I'm eyes. 4 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by kenbee(f): 1:50pm On Dec 07, 2014 |
OK now |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by anssy(f): 1:50pm On Dec 07, 2014 |
na person dey fall for laugh ,no be laugh dey fall person 4 Likes |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by dmjinc(m): 1:50pm On Dec 07, 2014 |
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by KidProgrammer(m): 1:51pm On Dec 07, 2014 |
Funny 1 Like |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply)
Kano Monarch, Dahiru Abba, Shot Dead / Photos From Ikwerre Bicycle Carnival, Rivers State / Olowo Of Owo, Folagbade Olateru-olagbegi Has Died
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21 |