Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,100 members, 7,811,095 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 11:16 PM

Conversation Betweenebola And Aids. - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Conversation Betweenebola And Aids. (1342 Views)

Discussion Between Ebola And Aids / Chat Between Ebola And AIDS Reloaded / Conversation Btw EBOLA And AIDS (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Conversation Betweenebola And Aids. by Charleschidera(m): 2:12pm On Aug 05, 2014
JUST FOR FUN:
AIDS: Bros na wah for you oo, u just come everybody dey fear you like death, wia u get ur own from.

EBOLA: Hahaha, I been tell u that tym naa, say make u wait ,make u neva commot, u no gree, u rush come out, e no tey doctors tidy u... But see me now, the patient dog, eats the fatest bone.

AIDS: na wa oo, everybody dey fear oo, no body dey near person wey u catch oo, but me, if i catch someone, no one go send, people go dey even chop wit am, hug am, even 'sleep' with am
sef, without issue.

EBOLA: Bros i ready come.. I dey pursue somebody sef even if my victim don die...u no fit carry person wey I kill from state to state like dat oo.

AIDS: Even hospital sef dey fear u oo, if dem carry ur victim come hospital, d hospital don close be that, bt me, everybody go dey go normally like say i no dey dia sef.

EBOLA: Bros, no be me do u ooo, na only u waka come naaa.

AIDS: ur case tire me ooo, I wan be like u oo, u just make me look like kindergarten. Even me dey fear u cos u fit catch me sef........but know sey, all these virus wey u dey share, remember that 'dia is God oooo'.

EBOLA: hahaha... Park well jor. Ur time don pass. Na my time to shine be dis.

AIDS: hmm for ur mind u wan replace me as no1 killer disease abi. see mak i remind u,remember ur brothers sars, lasser fever, spanish flu, bird flu, swine flu, rat flu nd all d flus. Dem all think say dey go fit replace me. Dem all begin wit initial gra gra, me jus park one side dey watch. Today all of dem don disappear, me stil dey
kampe. Anyway, enjoy ur moment, e no go last. U go soon fade.
Re: Conversation Betweenebola And Aids. by romzyxy(m): 2:18pm On Aug 05, 2014
lwkmd.........omo very creative.2 gbasky

(1) (Reply)

/ The History Of All Religions Explained In One Fascinating Graphic / .

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.