Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,335 members, 7,954,369 topics. Date: Friday, 20 September 2024 at 05:46 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Backseat Boys(rough Sketch) (772 Views)
Borno: Home Of Boko Boys / May Your Road Be Rough / The Rough Journey To The Peak Of My Career – Hope You Can Draw Some Inspiration (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Backseat Boys(rough Sketch) by JefferyUk(m): 1:54pm On Aug 08, 2014 |
Classroom setting;rowdy. 2 boys are sitted at the back engaged in a conversation Destan: her paaaaaa!!!!! James: hahahahahahaha ya still dey reason am? Destan: before ncor,one small pikin go get mind curse me becos wetin? She dey jand James: guyyyyy na ya bring yaself down wey she take see ya finish Destan: abiiiiii,well shaaa lesson learned In walks Tobi Tobi: aswear Boyo na confam gay ohh James: hahahahaha wetin suppp? Tobi: me and em Dan be dey talk bout avengers movie and hw hulk take Bleep loki up na bros jus start to talk rubbish like he wonder hw big hulk dick be and whether da ting dey big more as he dey vex. I jus weak when I hear am Destan and James: hahahahahahahahaahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahaahahahahahahahahahaahahahahahahaha Tobi: da matter tire me ohhhhh Bell for break over rings Destan: so 4 days in a row now we no go out for break,moneyyyyyyyyy ehnnnnn James: aswearrrrrr,see as we jus dey lean anyhow Tobi: iono bou una oh buh me go hustle food chop,I don be ragging master hahahahahahaha Destan: dat na sontin wey I no fit do,make all da girls come dey reason person as beggar Tobi: guy na ya own be dat o,life na per-head. James: shey break don end? Hw come nobody don come? Wetin we even get right now? Destan: na English we be get buh I no sure say he come school cos C class no do English today. Thank God sef cos me be no bring ma textbook James: me too ohhhhhhhh,so na anoda free period. This na da 3rd one today and we neva openbook and waec na jus 3 months away. We gats serious oh Tobi: na word ya dey talk guy buh to dey read for school get as it be for me,too many distractions and una no dey let person concentrate wiv una mumu mumu talk Destan: all dose ones na jege,if to read dey ya body ya for read. James: no leave am make he dey blame person for he unseriousness Tobi: una be gbefs oh A lil far away a group of guys arguing loudly…………… Destan: all dose ones don dey argue mumu mumu tins again Tobi: aswearrr,it be like say na da usual argument of who strong pass btw naruto and goku James: na wa ohhh and this na ss3 boys ohhhh,wetin jss1 boys no fit do. Destan: guyyy no dey form tins,when I come ya house dat day no be im ya pman and he friend dey argue or ya fink say I no hear am haahahahahahahahahaahahahhaha Tobi: hahahahahahaahaahahahahahahahahaah James: ya jus be fool ohhh Destan: na joke eeee guy Tobi: ehenn James hw far Sonia na,ya still dey run am? James: guy me na usain bolt for the matter oh buh she dey form hard to get. Me know say na initial gra gra na she jus dey do Tobi: na sooooooo,ya head dey dere Destan: me jus dey reason dat new ss2 girl oh; da fair onee,she bam dieee and this morning I see am dey eye me one kain. I come dey feel fly Tobi: hahahahahaahaha no wonder ya come dey pack when we dey comeback upstairs hahahahaha why it be say when ya wan form ‘cool’ ya go come dey pack trouser dey drag ya sleeves up? Dat na small pikin tin naa Destan: hahahahahaha guy me no know ohh,na jus force of habit James: buh guy na Bleep up to dey run ss2 girl na,girls no dey our class? Destan: all dese ashawos for our class wey dem don press finish? Ya dey crase ya hear. All da good girls dey either taken or them don friendzone me. Dat mumu Yvonne don friendzone me sotey she come dey meet me make I give im and her mumu bf deir couple name. ahhhhhhhhhhhh I don dieeeeeee Tobi: hahahahahahhahahahaaahahahahaahaahahahahahahahhahahaahaaahhaahah dat one na big Bleep up ohhhhh,na ya fault shaaa cos ya too dey play and joke around so hw dem wan take reason ya as bf material? Ya don too show yaself James: abiiiiiiiiiiiiiii,ya don dey wise ohhh Tobi Destan: abeg make una shut up,wetin una know? If any girl no like me as I dey den make she park well. Me no fit change maself jus cos I wan impress girl Tobi: kk ohhhhhhh broda,na ya know Destan: ehnnnnn na me James: make una shut up,teacher don show In walks the English teacher,da whole class organizes itself and proceed to greet. Mr Ode: sorry class for coming late,I am not feeling too good today #Sneezes Destanshouts) EBOLA tinssss Da whole class burts into laughter To be continued,this is somefin I did outta boredom. Not really a committment buh that can change depending on the kinda comments and views I get so if ya wanna see hw da story goes pls comment. And am still a freelance content writer,if interested hit me up on ma mail www.jeffukhurebor@gmail.com |
(1) (Reply)
Bed :)))) / Nairaland Literature Section Awards 2014..... Your Thoughts. / Describe Diz Guys Head In One Word (pix)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 18 |