Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,881 members, 7,956,326 topics. Date: Monday, 23 September 2024 at 10:01 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / I Love Nigeria... Check Why (451 Views)
5 Reasons I Love Nigeria / 5 Reasons I Love Nigeria / One Reason Why You Hate Or Love Nigeria (2) (3) (4)
(1) (Reply)
I Love Nigeria... Check Why by Skynet247(m): 10:48pm On Dec 16, 2014 |
ILOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless Nigeria!!! Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship. Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win Benin Republic. Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria because their colour na Green. Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE" Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey sey:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a pity) Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me. Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC 4 Police station. na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na you invent internet? Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer. Na only for Naija u go buy coke, dem go say make u no forget to return d bottle. Na 4 only Naija, you go see madman dey control traffic, people wey their head correct dey obey... Na 4 only Naija, wey you go see the president senior the country herself. Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money. Na only for Naija u go wish somebody 'happy birthday', he go answer 'same to u'. Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS RELOCATED" Na 4 dis country Lawmakers de climb fence and Police de fire teargas at big men. Hey Naija! Come see Roudabout plus traffic light plus police and Karota for Kano or Zarota for Gusau for drivers to obey rule. .. im proud of dis my country I add yours please. . |
Re: I Love Nigeria... Check Why by Nobody: 2:44am On Dec 17, 2014 |
Jokes section please. |
Re: I Love Nigeria... Check Why by Skynet247(m): 5:42pm On Dec 17, 2014 |
Please no vex carry am go there... Thanks |
(1) (Reply)
What Men Can / Why Did We Stop The Card Exchange?! / Bride List (pics)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10 |