Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,935 members, 7,817,727 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 06:04 PM

****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** - Food (6) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Food / ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** (23964 Views)

Oyinbo Woman Pictured Praying Before Eating Eba & Egusi With A Bottle Of Stout / Egusi With Okporoko (stock Fish) Soup / How To Prepare Egusi Soup - - The Ultimate Guide (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply) (Go Down)

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by guttentag(m): 12:54pm On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
As I don dey try this Egusi - ehhh - e don sweet me well well ooo... I don kolo to taste am again, so na to learn the formula b the next thing ooo!!

I nor fit relax, I wan chop am, the feelin too much self... so, I don carry my Oyinbo self go one local Afro-Caribbean shop, full my basket with all ingredients wey I wan use cook am.

YouTube don help me sabi am na, so to cook am mysef b the next mata...

If u go follow this Oyinbo wey to cook am eh, e go sweet u wella grin

- Boil meat for one pot, add maggie cubes, thyme, paprika, small mixed seasoning, one chopped small onion for taste (you for use any meat wey u like sha, but me I dey use lamb & beef or chicken)

- As u don dey boil meat, use the time to take one tin plumb tomatoes, one chopped onion & pepper (na the small red pepper oo - two I dey use, u fit put any amount wey sweet u - if na hot u like am add three/four) put all inside ur food processor - blend am well

- The blended mixture u go now put for one small pot, no oil oo! Put am for high heat, make e cook well well... u go leave am for fire till the time e don reduce, don thick

- As the mixture don dey boil, take ur melon seeds wey u wan use (1 cup) and blend am for food processor. U for use small water to blend ooo, so e go make a smooth paste, put am for one bowl, so u go add am to ur soup later

- Check ur meat na, if e don soft (to the way u like am) take am off fire, leave am for the side, with the water... u go use small stock from this water to add to ur soup later. If e neva cook finish, reduce the heat small, keep checking until e don cook finish

- Collect another pot, add small palm oil, make sure e don cover the bottom of the pan, roughly 1cm high. Put am for fire

- The blended mixture wey dey another pot (tomatos, onion, pepper), check am - if e don reduce finish, turn off the heat/burner

- Check ur palm oil na, if e don hot well well, start to dey smoke - ehen, e don ready b that. Add the blended mixture of tomatoes, onion & pepper - careful ooo - e go spit die

- By this time I know say ur meat don cook, if u neva remove am from fire already, do so now

- Take this time as u don fry ur mixture to wash the pots wey u don use finish ooo - u not wan finish cook with plenty washing to do na

- Stir this ur frying mixture small ooo, make sure e nor go burn

- As u don leave am to fry, cut Spinach into strips (the fresh one na the best one ooo) u for use scissors - e easy sha

- Check ur mixture again ooo - if e don begin to dry small, add tiny stock from ur meat water, na dash u go dash am

- Use ur nose to smell the frying mixture na.... if e don smell like e pepper don cook small, e don ready for the melon seeds b that.... Use one small spoon drop the grounded melon seeds into the pot, ontop the tomatoes, onion and pepper... keep dropping spoonfuls around ontop, spread am well covering everywhere

- Let am fry small ontop the mixture for a few mins on high heat... after a few mins don pass, turn am well. These melon seeds dey stick, burn, well well, so now u wan turn am from the bottom regularly

- As ur soup don thick small, add more stock water from ur meat - people like their Egusi with different thickness's, so find the one wey u like

- Add two maggie cubes again to this ur soup

- After roughly ten mins, e don cook b that smiley add the meat to the Egusi and keep turning for another ten mins, this one go allow the flavours to enter ur meat small

- Wen the ten mins don go, add the cut Spinach leaves and stir... after five more mins e don finish finally grin

To serve, u for use Gari or Pounded Yam to eat am, some people even take Semo chop - na ur choice b that

OMO THE THING SWEET DIE OOO - NOR B SAY ANYTHING... any help required, hunt me down smiley


https://www.youtube.com/watch?v=Pd7BpYpz7t4

You fit contact me here:

Facebook - Oyinbo Princess
Twitter - @OyinboPrincess






Abeg send me ur bb pin

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by kandiikane(m): 1:00pm On Feb 12, 2015
ThoniaSlim:
If you like call me a HATER but I could care less!
You came to a Nigerian forum to show us how to cook egusi soup? Seriously rolling my eyes!

My issue sef is not with her but all these inferior negros on this thread. They will be the same ones saying oyibo people this and oyibo people that but see them like flies on shyt when they come across one. Smh!

4 Likes 1 Share

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by thaoriginator: 1:03pm On Feb 12, 2015
kowema:
Nawa o....All this Ceremony for only Egusi soup?.Nazo!!

You try sha but the process too get drama so tey the outcome Sef no compliment the drama
I don laff troway here o grin

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by ThoniaSlim(f): 1:07pm On Feb 12, 2015
kandiikane:


My issue sef is not with her but all these inferior negros on this thread. They will be the same ones saying oyibo people this and oyibo people that but see them like flies on shyt when they come across one. Smh!

I lived in Europe for too long to see through the bullcrap. I'm sorry but not impressed with it all. Good attempt, I'll give her that but I know a couple of my white friends that throw it down in the kitchen when it comes to African dishes but don't make a fuss about. So what is all the oohhing and ahhing for like its some ceremonial process?

3 Likes 1 Share

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by vicchi12(f): 1:15pm On Feb 12, 2015
Lilboots:


Excuse you for what? Do you own this thread? angry angry. See me see this early morning wahala. Waka!! Anumanu!!! lipsrsealed lipsrsealed embarassed
Don't care to understand your gibberish, voodoo man. :p move along, boy
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by thaoriginator: 1:16pm On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
grin grin grin grin *R*O*T*F*L* grin grin grin grin

Chaiiiii I don die b this with all the replys wey full here oooo - nor b small oooo!!! I wan reply all separately but u know say I nor fit na.... a few things wey I don pick up na, firstly #bluebloodforlife b me ooo, na Chelsea b that - pele I nor fit change ooo cool secondly, the Pidgin, na so e sweet me for my eye, so na so I come apply mind / mouth / ear learn am - I don borrow this ur swag b this ooo

As far as the question reverting to Islam, pele no, na Christian I be ooo - I nor fit change am.... na my roots, my upbringing and na the level wey I come sabi b that. However, all under one sky we dey live na, so I nor dey get any kind feelings to any religion or culture, I accept ppl for their beliefs and backgrounds, na respect I get ooo!!

Na, for the YAHOO boys out there, u knw say these my eyes clear well well oooo - ABEGGGGIIIEEEEEE nor try me ooo - I go rip u for arsepaper self!! U knw say this Oyinbo sabi wella, make u free me wiv these ur 419 stories ooooo - I nor gree hear am!!

OnElOvE for all the comments - Baba GOD dey ooo kiss
LMAO! grin you dey mad gan o! Nice one cool

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by vicchi12(f): 1:18pm On Feb 12, 2015
ThoniaSlim:


I lived in Europe for too long to see through the bullcrap. I'm sorry but not impressed with it all. Good attempt, I'll give her that but I know a couple of my white friends that throw it down in the kitchen when it comes to African dishes but don't make a fuss about. So what is all the oohhing and ahhing for like its some ceremonial process?
Exactly! Like african women don't cook western inspired dishes. Sheesh!

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Lilboots(m): 1:36pm On Feb 12, 2015
vicchi12:

Don't care to understand your gibberish, voodoo man. :p move along, boy

Because I speak in pidgin then it is gibberish. Lol. This is a pidgin english thread in case you are not aware.
And this sudden change to speaking Queen's english, is that an attempt to sound/look sophisticated ? I just laugh. You are an epitome of everything wrong with Nigeria. Just dey form levels wey e no reach. cheesy cheesy cheesy

1 Like 1 Share

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Moana(f): 1:49pm On Feb 12, 2015
Akinmail:

Haha

How come I don't know this song?

Will you sing it for me please?

cool


https://www.youtube.com/watch?v=9z4VrDu_ZYw
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 1:54pm On Feb 12, 2015
OmO - se wahala wey don form for this my thread now oooo - people beefing, no LELE.... nor b by force u come read am, na ur nose u don follow ooOOoo... I nor try 'big myself' for cookin 9ja food na, na freedom of speech don allow me make I share my experiences! I nor wan seek praise nor agro - just simply sharing love for d 9ja culture I care passionately about!! ABEGIEEEEEE if u no like am, no read am!!!!

For those wey still question if na confirm Oyinbo I be, na true I dey talk ooo - u for come follow my twitter ati facebook, wey u go see latest uploads etc smiley if u neva read am already, a quick story on my background dey available here: http://thenet.ng/2015/02/meet-nets-biggest-fan-oyinbo-princess/

Make I com remind u na, nor b my post wey we don yarn for since Abeg, free me ooooOOOoooo - if I wan try write for Pidgin, na so I go do!! The replies self, if dem dey for Pidgin, e go help me learn small sha - so continue oo grin

Appreciation goes out to all those wey don come watch my YouTube links and follow on facebook ati twitter - I hail u all ooo cool ONELOVE

Twitter: @ OyinboPrincess - Facebook & YouTube: Oyinbo Princess

4 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by esosuo: 1:54pm On Feb 12, 2015
ThoniaSlim:


I lived in Europe for too long to see through the bullcrap. I'm sorry but not impressed with it all. Good attempt, I'll give her that but I know a couple of my white friends that throw it down in the kitchen when it comes to African dishes but don't make a fuss about. So what is all the oohhing and ahhing for like its some ceremonial process?
babe take it or leave it the babe dey represent fully ,check the langua alone na comfirm ,the babe is nigerian an heart and love for naija is the beginning of sharpness oh

3 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Lilboots(m): 2:11pm On Feb 12, 2015
vicchi12:

Exactly! Like african women don't cook western inspired dishes. Sheesh!

Why the beef na? Since last night, you have been on this thread dissing up and down. You see the girl for dream abi she snatch your bf? As the girl has explained, there is freedom of speech and anyone can start any topic wey dem want on NL.
Your own no pass to dey hiss, dey yawn (that ya mouth go bend go one side if u no take care) and making uncomplimentary comments up and down. Jisos!! You can start your own thread on Western inspired dishes if you like. Mini pork pies with piccalilli dey there, Crispy topped Cumberland pie dey there wey u fit start thread on. Unless of cos, the WESTERN wey u mean na yoruba food and in that case we go like to learn one or two things about black amala and ewedu. shocked shocked

But dissing this chick's thread for no reason isn't cool. Women, na una be una own worst enemy angry angry

3 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by loomer: 2:42pm On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
OmO - se wahala wey don form for this my thread now oooo - people beefing, no LELE.... nor b by force u come read am, na ur nose u don follow ooOOoo... I nor try 'big myself' for cookin 9ja food na, na freedom of speech don allow me make I share my experiences! I nor wan seek praise nor agro - just simply sharing love for d 9ja culture I care passionately about!! ABEGIEEEEEE if u no like am, no read am!!!!

For those wey still question if na confirm Oyinbo I be, na true I dey talk ooo - u for come follow my twitter ati facebook, wey u go see latest uploads etc smiley if u neva read am already, a quick story on my background dey available here: http://thenet.ng/2015/02/meet-nets-biggest-fan-oyinbo-princess/

Make I com remind u na, nor b my post wey we don yarn for since Abeg, free me ooooOOOoooo - if I wan try write for Pidgin, na so I go do!! The replies self, if dem dey for Pidgin, e go help me learn small sha - so continue oo grin

Appreciation goes out to all those wey don come watch my YouTube links and follow on facebook ati twitter - I hail u all ooo cool ONELOVE

Twitter: @ OyinboPrincess - Facebook & YouTube: Oyinbo Princess


Me slf tire as some people de beef o, like say na by force to read her thread.

Simple encouragement dem no fit encourage d girl.

But if na dem now 6months we them go stay London dem go don form British ascent.

3 Likes 2 Shares

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by BlackLeopard(m): 3:19pm On Feb 12, 2015
I dunno, she got better pidgin than me an it's a nice thing 2 see someone tryna learn culture dey ain't from? But I also see it, 9jan girls gettin praise nowhere for sharin food an sharin fashion an sharin this an that nd gettin only hate 4 it? So totally not gonna hate on da sistah dat came with da objection, she got a valid point, she no hatin' OyinboPrincess r anyone, she tire w the hypocrisy, a different thing.

And hey, we understand each other, imma leave all de 'how da fwck ya talk' to messed up whites.
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by babsjnr(m): 3:22pm On Feb 12, 2015
Typical black chick mentality racial jealous thing
ThoniaSlim:
If you like call me a HATER but I could care less!

You came to a Nigerian forum to show us how to cook egusi soup? Seriously rolling my eyes!

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by babsjnr(m): 3:26pm On Feb 12, 2015
Oyinboprincess wey dey ur side if anybody try to bully u here we go chase dem out asap.

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by ThoniaSlim(f): 4:28pm On Feb 12, 2015
babsjnr:
Typical black chick mentality racial jealous thing

But that's not my cup of green tea. cool

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 4:36pm On Feb 12, 2015
ThoniaSlim:


I lived in Europe for too long to see through the bullcrap. I'm sorry but not impressed with it all. Good attempt, I'll give her that but I know a couple of my white friends that throw it down in the kitchen when it comes to African dishes but don't make a fuss about. So what is all the oohhing and ahhing for like its some ceremonial process?

Stop Hating on the Girl joorh. With your photoshopped Pic

4 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 4:38pm On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
OmO - se wahala wey don form for this my thread now oooo - people beefing, no LELE.... nor b by force u come read am, na ur nose u don follow ooOOoo... I nor try 'big myself' for cookin 9ja food na, na freedom of speech don allow me make I share my experiences! I nor wan seek praise nor agro - just simply sharing love for d 9ja culture I care passionately about!! ABEGIEEEEEE if u no like am, no read am!!!!

For those wey still question if na confirm Oyinbo I be, na true I dey talk ooo - u for come follow my twitter ati facebook, wey u go see latest uploads etc smiley if u neva read am already, a quick story on my background dey available here: http://thenet.ng/2015/02/meet-nets-biggest-fan-oyinbo-princess/

Make I com remind u na, nor b my post wey we don yarn for since Abeg, free me ooooOOOoooo - if I wan try write for Pidgin, na so I go do!! The replies self, if dem dey for Pidgin, e go help me learn small sha - so continue oo grin

Appreciation goes out to all those wey don come watch my YouTube links and follow on facebook ati twitter - I hail u all ooo cool ONELOVE

Twitter: @ OyinboPrincess - Facebook & YouTube: Oyinbo Princess



Oyibo princess. All this one so wey you dey yarn na ajebutter pidgin. Come make I drill correct Waffi pidgin as e dey go. You nor know the marra?? Oya shoot me text make the lecture start. 08168916035.

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 4:40pm On Feb 12, 2015
ThoniaSlim:


But that's not my cup of green tea. cool

I thought where you come from Stupidity is a Crime. Why are you showing it.

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by idlatest(m): 4:41pm On Feb 12, 2015
Wonders

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 4:55pm On Feb 12, 2015
LOOOOOL - I don dey crack rib today ontop these comments ooooOOoooo grin nor b small smiley

3 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Idowuogbo(f): 5:06pm On Feb 12, 2015
This poster is everywhere mahn! Jeez! Calm down woman! So bcus you dey blow pidgin,man pikin no go hear word again? Anyways na your time sha, dey jolly dey go. smiley

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by yungchop: 5:11pm On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
LOOOOOL - I don dey crack rib today ontop these comments ooooOOoooo grin nor b small smiley
Mr man, who are you deceiving here? I've told you that scamming people won't pay, na vulcanizer job sure pass tongue
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 5:16pm On Feb 12, 2015
Idowuogbo:
This poster is everywhere mahn! Jeez! Calm down woman! So bcus you dey blow pidgin,man pikin no go hear word again? Anyways na your time sha, dey jolly dey go. smiley

Omo see hate cheesy cheesy cheesy

3 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Idowuogbo(f): 5:23pm On Feb 12, 2015
Monstertrucks:


Omo see hate cheesy cheesy cheesy
hate? see this f00l,i have oyinbo friends wey dey blow pidgin and yoruba so what's there to hate? Na my fault u never comot for ya village? undecided Ogbeni dress go one side jare

1 Like 1 Share

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 5:33pm On Feb 12, 2015
Idowuogbo:

hate? see this f00l,i have oyinbo friends wey dey blow pidgin and yoruba so what's there to hate? Na my fault u never comot for ya village? undecided Ogbeni dress go one side jare

Goat. How can an idiot that has no life outside the internet now claim to have Oyinbo friends that speak pidgin and yoruba. Which friends
sef. Or you mean e-friends??
don't forget to add the e- next time you hear

Lies all over the world. There's no lie I wil not hear. Abi na the girl wey you dey hate on you wan claim as friend now. Oloshi.

Carry you lenghelenghe body comot make I see front jorrh. Mtchew

2 Likes 1 Share

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by toprealman: 6:01pm On Feb 12, 2015
FriedPlantain:
Where this babe take learn pidgin like this
She must be into a Nigerian Guy. When they are in, they give it their 100%. The day you walk out.....No 6 underground street for them.
Nice girl and good job by her man.

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 6:52pm On Feb 12, 2015
OMO God dey oooOOOooo grin

shocked lol if una think say na GUY I b ooo, make una come watch my videos joooooooor - abegieeee make una collect fact before accusation o!!

4 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 6:56pm On Feb 12, 2015
E sweet joooooor - nor b lie grin


https://www.youtube.com/watch?v=lTVnPxcmrtU

Na the EatingFaxtor b this oooo - Egusi ati Garri cool

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by donodion(m): 8:12pm On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
E sweet joooooor - nor b lie grin


https://www.youtube.com/watch?v=lTVnPxcmrtU

Na the EatingFaxtor b this oooo - Egusi ati Garri cool

Sweetie no mind them.When next they hiss..laugh out in their faces and shout "JEALOUSMOQUINE dey worry una" grin grin

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Idowuogbo(f): 8:16pm On Feb 12, 2015
Monstertrucks:


Goat. How can an idiot that has no life outside the internet now claim to have Oyinbo friends that speak pidgin and yoruba. Which friends
sef. Or you mean e-friends??
don't forget to add the e- next time you hear

Lies all over the world. There's no lie I wil not hear. Abi na the girl wey you dey hate o5n you wan claim as friend now. Oloshi.

Carry you lenghelenghe body comot make I see front jorrh. Mtchew
Lmao! See paragraph ooo... this niggah is hurting mehn....na so the thing pepper you? awww....so oyinbo dey freak you ?don't worry you'll get to hang out with the op that's if she replies your mail.Foooooooolish thing!

1 Like

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply)

What Food Taste Better The Next Day -. Photo / 1200 Christmas Chickens Lost To Auto Accident / Concern Over Low Quality Of Local Rice

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 77
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.