Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,587 members, 7,955,165 topics. Date: Saturday, 21 September 2024 at 06:30 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area (1503 Views)
NEPA Bill In 1984 Vs 2017 (Photos) / Electricity Company Announces Power Outage In Lagos ....... Light Dey Before? / After About 7 Months Of Blackout, NEPA Light Finally Returns To Maiduguri (2) (3) (4)
In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by ceejay80s(m): 3:25pm On Mar 01, 2015 |
Mine dey terrible even my generator shout for my head say shey I wan kill am, e no funny again, na from worse to worst to worstest, In a month na like 30 mins light 1 Like 1 Share |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by Nobody: 3:27pm On Mar 01, 2015 |
Bros no light for here oh, Sotey NEPA dey send them agents to come dey off our candles. 3 Likes |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by ceejay80s(m): 3:35pm On Mar 01, 2015 |
If mod fit help us move dis thread to front page, atleast we know say some pdp and apc agents dey nairaland, dem go let dem Oga hear witin dey happen, e too much ,so wetin Jonathan dey commission ? I fit bet my life say seun sef no get light for him street now, E no funny again, sometimes I dey fear to dey house 1 Like |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by menix(m): 3:37pm On Mar 01, 2015 |
Hmmm, broz to say u wan see light 4 my area b like wise man wey enta okpo hotel dey find virgin. Sotey spider dey live insyd all my bulbs...... 2 Likes |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by ceejay80s(m): 3:39pm On Mar 01, 2015 |
menix:Lol 1 Like |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by TI1919(m): 3:39pm On Mar 01, 2015 |
Light for my place dey like say tomorrow on dey. |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by ceejay80s(m): 3:39pm On Mar 01, 2015 |
Imanuelle:Haba 2 Likes |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by Nobody: 3:40pm On Mar 01, 2015 |
ceejay80s: I dey tell you. |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by ceejay80s(m): 3:44pm On Mar 01, 2015 |
Wetin be the essence of the fix charge wey dey our bill, weda u use light or not u go pay am, e never reach time wey we go close shops and schools and offices ,make we enter street to protest? Na mugun dem call us? Wetin dem dey do now be flashing light, yesterday dem bring am as I Stant up to enta my kitchen to on my frigde , dem take am and dem no bring am again , today dem don flash am again 1 Like |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by daimsy(f): 3:44pm On Mar 01, 2015 |
Nepal -phcn- e dey shine for my side like teeth wey I just dey brush finish |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by Funpeter: 3:49pm On Mar 01, 2015 |
Here worst die ooooooooo we na dey see light oooooooo. Abeg make una help us beg nepa make dem pity us now. 1 Like |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by ceejay80s(m): 3:53pm On Mar 01, 2015 |
As I am typing, dem don flash am and take am again, after dem go bring bill, na flashing I dey pay for? We need to protest |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by ceejay80s(m): 3:54pm On Mar 01, 2015 |
daimsy:Meaning u get light or u no get light? |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by ceejay80s(m): 3:58pm On Mar 01, 2015 |
Funpeter:U don't need to beg dem, u are paying their salaries, u know how much nepa dey make from the bills, calculate the bill of ur compound and then ur street and then 20streets and then the whole of ur local govt area, then u go know how much nepa dey make in a month Shebi our economy don collapse? We go collapse am reach ground by going to the street an protesting, no work, no school, dem go hear us byforce |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by gen2briz(m): 4:27pm On Mar 01, 2015 |
Ez be like say dem dey cheat all of una, for my area here na 48hours per day (yes I mean am 48hours per day). The transformation wey happen for our light in my area na superb. Some yeye pay par post 1diot will so be here to shout the programmed sentence #Never again will i vote for any shoeless politician. 1 Like |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by daimsy(f): 4:28pm On Mar 01, 2015 |
ceejay80s:if.I.say.'e dey shine' wet in you understand by ***e dey shine** |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by EmmaOgbu(m): 4:34pm On Mar 01, 2015 |
........... |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by phlio(m): 6:31pm On Mar 01, 2015 |
2days now no light |
Re: In Pegeon English: How Nepa Light Dey For Ur Area by ceejay80s(m): 7:03pm On Mar 01, 2015 |
Wetin we fit do to stop am because I no say nothing spoil for nepa, dem purposely dey do am |
(1) (Reply)
How Can One Download Pictures From This Site To Phone Using Opera Mini. / Suicide Is All I Can Think Of, Please Help. / UNBELIEVEABLE - Bill Gate Drinks Poop Water
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 20 |