Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,103 members, 7,818,294 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 12:09 PM

Awoniyi Pepper Too Much For Zambia - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Awoniyi Pepper Too Much For Zambia (882 Views)

Super Eagles Depart Nigeria For Zambia [photos] / Kehinde And Taiwo Awoniyi's 19th Birthday Celebrated By The Ex Eaglets Striker / Taiwo Awoniyi’s Twin Sister; Kehinde (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Awoniyi Pepper Too Much For Zambia by Solowande(m): 8:30pm On Apr 12, 2015
Naija U23 team don kwalify for de 11th All
African Games wey go happen dis year for
Congo Brazaville afta dem bilala Zambia 2-1 for
dia second leg kwalifia match on Sunday for
Lusaka.
De match no be moi moi and akamu for de
Dream Team as pipu dey call de Naija U23 team
becos Zambia no take small eyes jam dem for de
match.
Sabee strika, Taiwo Awoniyi wey juss enta de
U23 team na hin waya de two goals wey Naija
take win de match for Lusaka.
Unna go remember say na 0-0 na hin Zambia kon
follow Naija play for de fess leg for Abuja, and
naso Zambia fans kon dey shout say na muss
make dia team win de second leg, but ground no
level for dem
Na afta de refiree blow de wisu for de fess half,
na hin Zambia kon dey run like cheetah for field,
but Naija playas juss dey watch dem dey find
how dem go take hama dem.
As Naija kon see say na shakara na hin Zambia
dey do dem, naso Taiwo Awoniyi kon waya de
fess goal for Naija, and naso Zambia fans kon
dey vex for stadium.
De shout wey Zambia fans dey shout for stadium
na hin kon open de eyes of dia playas bifor
Friday Samu kon ekwalise for dem wen de match
remain 10 minute wey de refiree go blow final
wisu.
As Zambia kon ekwalise, naso dia wahala kon
plenty for field as dem dey find de second goal
wey for helep dem win de match.
Taiwo Awoniyi na hin kon burst dia bloblo as de
bobo waya de second goal wey helep Naija win
de match 2-1 and na jeje na hin Naija take
kwalify for de All African Games.

http://www.supersport.com/football/nigeria-naija/news/150412/Awoniyi_pepper_too_much_for_Zambia

2 Likes

Re: Awoniyi Pepper Too Much For Zambia by terzurum5(m): 9:51pm On Apr 12, 2015
Guy your komenteri na him trai pass joo

1 Like

(1) (Reply)

Drogba Parties With Christiana Milan After Chelsea’s Win! / Top 20 Richest Clubs In The World(forbes) / Nigeria Moves To 43rd In New FIFA Ranking.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.