Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,209 members, 7,836,018 topics. Date: Tuesday, 21 May 2024 at 07:19 PM

Funny African Proverbs And Thier Meaning To Spice Up Ur Day - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Funny African Proverbs And Thier Meaning To Spice Up Ur Day (804 Views)

Represent Your State, Current Nigerian States And Thier Slogans / List Your Ten Top Nairalanders You Always Check Thier Post / Some Pidgin Proverbs And There Meanings (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Funny African Proverbs And Thier Meaning To Spice Up Ur Day by adrelanine: 3:13pm On Apr 27, 2015
Chicken wey run way from borno go Ibadan go still end up inside pot of soup
Loose Translation: You Can't Run Away From Your Destiny

Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap
Loose Translation: Keep calm! Nothing last forever

Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef
Loose Translation: Just be patient. Let the game come to you. Don't rush!

Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem different
Loose Translation: How you start doesn't matter, what matters is how you finish.

If life dey show you pepper, my guy make pepper soup from am.
Loose Translation: Make something good out of a bad experience.

I get am before No be property
Loose Translation: stop living in the past and start living in the present.

If person too tey for party e go follow dem wash plate
Loose Translation: Don't outstay your welcome

Craze no hard to form,na the trekking be wahala
Loose Translation: Easier said than done

No matter how hot your tempa be,e no fit boil beans.
Loose Translation: Calm down,your temper won't solve the problem

Every mallam with em own kettle,every Northerner with em own radio.
Loose Translation: Every man for himself

Opolo eye no be open eye
Loose Translation: Having Big eyes doesn't make you civilised

Bring suya, bring suya,.......na cow body dey suffer am.
Loose Translation: Every action has a consequence

E go better e go better,na im make ibo man still dey Kano. Loose Translation: When there is hope,there is Life.

The difference between kpekere and plantain chips na packaging
Loose Translation: Don't judge based on appearance alone

Escort me, Escort me, naim slave trade take start.
Loose Translation: serious things sometimes start like joke

Pikin wey use agbada take start guy, go talk wetin e go wear wen e old.
Loose Translation: slow and steady wins the race

The water wey dem use take make eba can never be recovered back.
Loose Translation: Don't cry over spilt milk.

Feel free to add urs cheesy

1 Like

Re: Funny African Proverbs And Thier Meaning To Spice Up Ur Day by Arbiola(f): 3:19pm On Apr 27, 2015
Ok
Re: Funny African Proverbs And Thier Meaning To Spice Up Ur Day by IlorinFinest: 3:26pm On Apr 27, 2015
Funny but try space and number them
Re: Funny African Proverbs And Thier Meaning To Spice Up Ur Day by Basildvalour(m): 3:30pm On Apr 27, 2015
Piss wey man hold for 6 hours come later piss dey totori for body

Loose translation: Success is sweet after the pressure
Re: Funny African Proverbs And Thier Meaning To Spice Up Ur Day by p2t2r(m): 3:36pm On Apr 27, 2015
Thunder go fire you.

Loose translation: Thunder go fire you.

1 Like

(1) (Reply)

closed / Open Letter To Seun / SHOCKER! Married Man Commits Suicide After Prostitute Girlfriend Slept With Anot

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.