Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,483 members, 7,958,456 topics. Date: Wednesday, 25 September 2024 at 02:43 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Oga Bigi Boy (478 Views)
Oga Police (season 1) / The Brouhaha Of Oga Martins / Happy Birthday Oga Kingphilip (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Oga Bigi Boy by pcaliphate(m): 8:22am On May 01, 2015 |
OGA BIGI BOY You no dey drink pure water; your style na bottle things You too like woman; you no care if she fat or thin Clubbing na your hobby; in fact you don marry am Na browsing sure pass; looking for whom to scam Even when you dey sleep; you still dey form swag Humility no dey show for your face; your body too dey brag Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy! Oga bigi boy! You just dey spend the money as e dey come You no sabi save, even you your stomach sef na drum You no dey hear advice; your parents sef don try You dey live your life so wild; na every time your mother dey cry As you dey waka; you just dey step on toes You character just dey magnet different foes Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy! Chai! I hear say Oga bigi boy don sick Lapi don spoil and brokenness don thick You need to see his face; his swag was so cold The ever gallant Oga bigi boy was far from bold Damm! Things fall apart; the ocean has gone dry Surviving or dieing became a very solid tie Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy! (Olowo Tosin John) |
(1) (Reply)
Farewell Poem For My Dear Finalists / Finding Solace In Death! / No More Excuses
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 6 |