Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,553 members, 7,837,120 topics. Date: Wednesday, 22 May 2024 at 05:26 PM

Be Nice To Strangers - Religion - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Religion / Be Nice To Strangers (637 Views)

Being Fed By Strangers In Your Dream? / How My Compassion On Two Strangers I Met Brought Me Incredible Favour / The " My Muslim Friends Are Very Nice" Excuse (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Be Nice To Strangers by Onyeka32(m): 2:29pm On Aug 20, 2015
Na for one big church, according to the story, na this matter for happen.
From the church headquarters for Lagos, dem cum transfer one new pastor come the branch wey dey warri.
So, the branch for Warri don make preparations for a welcome program for the new pastor.
The pastor cum tell dem say e go arrive the church by 10 in the morning say make dem dey go on with their program. Say as soon as the time dey exactly 10 'O'clock, make dem announce e arrival.
On the day wey the pastor from Lagos dey come, dem don decorate the church, even put one big banner for the gate wey carry the pastor picture.
As early as 7 o'clock that morning, pipo start to troop the church.
As the church host pastor drive e jeep through the church gate dey park for e parking space, nai e see one beggar wey sidon for front of the church. The main entrance to the church.
Na with annoyance nai the pastor take rush come down begin shout for the Ushers why dem allow a dirty looking beggar to sidon for front of the house of God.
E shout finish nai e order dem to take the beggar out from the church.
The ushers cum escort the beggar out from the main church go outside the gate.
The beggar cum sidon for the gate for road with e plate again.
Pastors pass, deacons pass, deaconesses pass, choristers pass, members pass, in the end, the money wey the beggar don get nor reach #100.
One small pikin wey hold lucozade boost and gala dey waka with e mama wan enter church. The mama nai be prayer band leader.
As dem dey enter, the pikin cum run go give the beggar the lucozade boost and the gala.
If you see the beat wey the mama beat this pikin?
She dey say the pikin nor know say devil dey use any means dey enter the children of God?
Dem don dey sing and worship the Lord.
the host pastor cum call the new pastor wey dem dey expect so dey ask am where e dey say time don reach.
The pastor for Lagos say e don drive enter the church street make e make the pronouncement of his arrival at exactly 10 wey e tell am befor.
Time na 5 minutes to 10 now.
One Toyota Landcruiser cum roll enter the church.
The pastor cum breathe reach ground say the pastor from Lagos don come.
Na so e get up, take microphone, after e don ask some of e elders and deacons to go escort am enter the church, e cum start to announce the e arrival.
For the front gate of the church nai these deacons and others wey the pastor send go receive the pastor from Lagos for stop in shock.
Na the beggar wey dey the church gate since nai dey enter church again.
The host pastor cum shout make dem carry the beggar go outside the church but the beggar hold ground say e must enter say na e papa house.
The thing cum cause small noise for church cos some members cum dey say make dem leave am.
The beggar begin waka for the aisle dey go sidon for front seat cos some vacant chairs dey there.
Ushers nai stop am say e nor go fit go sidon front with the kain dirty clothes wey e wear.
The beggar cum dey tell dem say e nor be mad man o.
Make dem nor dey look am as if e dey crase.
The ushers nor gree listen cos dem cum tell am say if e nor sidon for back seat, make e dey go.
Last last, e cum sidon for back.
The man wey come down from the Landcruiser cum tell the deacons dem say make dem announce the arrival of the new pastor say na him be e driver and na him send am this message.
As the host pastor, still skeptical, announce make all the members give a standing ovation to the new pastor from Lagos, na so e eyes dey the church gate dey wait to see the man of God.
From back, nai that same beggar stand up, start to waka go the altar.
As e dey waka dey go, ushers wan stop am again but the kain english wey comot from e mouth, make all the ushers leave am.
As e dey go, the full church dey look am.
Nai e meet the host pastor for altar, collect the microphone from am.
E cum drop the microphone for the pulpit start to remove all the shreds and dirty stuffs wey e wear.
Inside the dirty clothes, this man was dressed in a clean designer suit.
He stand straight, nai the driver cum give am e black leather shoes and e Holy Bible.
By now, the whole church don quiet like grave yard.
To dem, e just be like judgment day.
E cum clear e throat nai e say
"I dey perceive the aroma of food.
I know say unu wan do party to welcome me.
The church dey very fine and well decorated.
Many of unu pay money just to make me, the new pastor of the church feel your love and hospitality and care.
Even though unu nor know me.
Unu norva see me once.
Yet, unu make a lot of sacrifices to welcome me.
May God bless you all."
Na few pipo say
"Amen"
But, how you go fit show this kain love to person wey you norva see when you have some pipo around you like the beggar at the gate this morning?
Tears start to roll down from the pastor eyes
"So, how can I lead the flock wey nor fit show love to someone wey dem nor know?
How?
God!
Everybody don dey feel ashamed and sober even the host pastor.
The next thing wey this pastor from Lagos talk be say
"You can not say you love me
When you cannot love the man that you see"
He drop the microphone nai e go back to the seat wey e sidon put befor for back.
The rest of the church activities continue in coldness.
My pipo, be nice and show love to pipo, most especially, strangers cos you never can tell.
May God give us the grace to be loving and kind to all.
Amen.

Re: Be Nice To Strangers by Rosemary216(f): 2:42pm On Aug 20, 2015
Eyaaaa..i don learn sumtin here!

(1) (Reply)

Women In Saudi Arabia Can Now Vote. / Over 30 Judges Opt Out Of Officiating 'Gay Weddings' Following New Law / WORLD Ending Next Week

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 33
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.