Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,142 members, 7,815,004 topics. Date: Thursday, 02 May 2024 at 04:27 AM

Black Woman Dey Breastfeed White Pikin - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Black Woman Dey Breastfeed White Pikin (641 Views)

If Truly You Are Olden Days Pikin Then You'll Know These[pics] / An Indian Tribe That Breastfeed Animals Like Their Own Babies / I Beg Am Confused, How Ogbomoso People Dey Do Wedding? (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Black Woman Dey Breastfeed White Pikin by steadyguy: 3:13am On Sep 04, 2015
If you don watch dat film wey dem call THE HELP, you go see as life been dey for dis yankee around 1950s. Dat time, na mostly akata women dey do house helep work for onyibo women. And dat time, na de most popular work wey akata women fit get.

But dis tin no really start today. Even for way back, na akata women been dey take care of onyibo pikin dem. Wetin dat one mean na say onyibo pikin dey spend more time with akata house helep pass dem own mama.

And I believe say dat one dey make akata women to no get too much time to spend with dem own pikin dem. But I fit dey wrong about dis one, na just sometin wey I dey tink.
Den when I begin research dis history about yankee, I come discover sometin wey really shock me!! De tin wey I been find out na say during dos olden days, akata women been dey breastfeed oyibo pikn wey dem been dey take care of. If you dey doubt me, make you check internet and you go still see some photo.

Na wa oo! Dis country history take style dey ova complicated. And dis na time wey dem been dey treat akata people really bad, but dem still allow de akata women to breast feed dem pikin. No be small tin oo! And my quesion come be say, where de onyibo women been dey or wetin dem been dey do when anoda woman dey breast feed dem own pikin?

Imagine say naija woman allow her house helep to breastfeed her own pikin..., lol. I no even wan imagine dat one. Just imagine how a typical naija woman go react when she enter room den come see as her house helep breast dey inside her baby mouth. Ya guess dey as good as my own!!

Any way sha.., dem say culture dey different different. So me I believe say dem get dia reason why dat one been happen during dat time sha...!
Re: Black Woman Dey Breastfeed White Pikin by tpiander: 4:33am On Sep 04, 2015
what's the relationship between The Help and the rest of your post?

(1) (Reply)

â™ Twenty Simple Ways To Show Courtesy And Earn Respect / {today* Ramadan / Ramzan 2016 Taraweeh, Quran Tilawat Prayers In Arabic Urdu / Just About Shao Awon-ga Omo Onibu Eja

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.