Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,305 members, 7,815,557 topics. Date: Thursday, 02 May 2024 at 02:28 PM

40 Hilarious Pidgin Proverbs. - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / 40 Hilarious Pidgin Proverbs. (34326 Views)

Some Common Nigerian Pidgin Proverbs / 40 Hilarious Pictures that will put a smile on your face today. updated!! / 40 Hilarious Proverbs (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

40 Hilarious Pidgin Proverbs. by khalhokage(m): 8:08pm On Sep 10, 2015
1. Na for old age ashawo dey know the value ofpikin.
2. Woman wey never see problem... Na im dey still hold breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black goat.
6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.
10. Person wey don faint before no be stranger to death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.
12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself
15. Toto water small, but é reach prick take baff.
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.
17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
18. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.
20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.
21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.
22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say race don start.
25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.
26. Before you see monkey, monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again.
28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.
30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am.
32. My thing and our thing no be the same oh.
33. Na happiness dey make prick stand
34. Na as goat stand for market dem dey price am.
35. Craze no hard to form, na the trekking be wahala.
36. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.
37. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans.
38. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.
39. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap.
40. Akara and moin moin get the same parent, na wetin dem pass through make dem different.

Add your own cheesy

1 Like

Re: 40 Hilarious Pidgin Proverbs. by Nobody: 8:22pm On Sep 10, 2015
You get NL acc. No mean say u go d post anything you like
Re: 40 Hilarious Pidgin Proverbs. by Behira(f): 8:26pm On Sep 10, 2015
Smb!!!
Re: 40 Hilarious Pidgin Proverbs. by hendy05: 8:37pm On Sep 10, 2015
Na nO 15 mek sense pass
Re: 40 Hilarious Pidgin Proverbs. by misreal(m): 8:54pm On Sep 10, 2015
tjark1:
You get NL acc. No mean say u go d post anything you like
hahahaha.
Re: 40 Hilarious Pidgin Proverbs. by Nobody: 1:23pm On Sep 11, 2015
Behira:
Smb!!!

Really?
Re: 40 Hilarious Pidgin Proverbs. by samueljonah(m): 2:08pm On Sep 11, 2015
Guy na just nomba 15 u lyk pass
Re: 40 Hilarious Pidgin Proverbs. by Nobody: 4:14pm On May 31, 2019
Clean notification, friend.

(1) (Reply)

When You See The Guy You Stole His Money In Boutique PIC / A Maths Student Letter To His Girlfriend / "What Is Food Poisoning?": See Student's Hilarious Response (Pictured)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.