Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,846 members, 7,820,947 topics. Date: Wednesday, 08 May 2024 at 04:33 AM

40 Hilarious Proverbs - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / 40 Hilarious Proverbs (1584 Views)

Some Common Nigerian Pidgin Proverbs / 40 Hilarious Pictures that will put a smile on your face today. updated!! / 40 Hilarious Pidgin Proverbs. (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

40 Hilarious Proverbs by chukxy44(m): 6:56pm On Sep 14, 2015
Make we nac am sharp sharp as E dey HOT

1. Na for old age ashawo dey know the
value of pikin.
2. Woman wey never see problem... Na im
dey still hold breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear
pant sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later
é go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black
goat.
6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay
boiled egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back cross water,
wey say him march fish, wetin him mama
go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no
know say the journey far.
10. Person wey don faint before no be
stranger to death.
11. Person wey chop belle full, no know
wetin hungry man dey see.
12. No be as woman dey close eye enjoy
sex she dey enjoy labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut poo.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if
nobody hail am!! é go hail himself
15. Toto water small, but é reach prick take
baff.
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND,
SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.
17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
18. Na cricket tell him children say, No
matter how ground strong, Them no go
sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no fine they
use style call him papa blind man.
20. No be eye wey dem take chop eba dem
take dey share meat.
21. Person wey use Elephant set trap, na
him know wetin he wan Catch.
22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS,
BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW
BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say race don
start.
25. Dem no dey tell blind man say salt no
dey for food.
26. Before you see monkey, monkey don
see you.
27. Thief wey jump fence enter house
where owner dey wait for am, no go jump
again.
28. If pikin say he sabi die, him papa sef go
tell am say him sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na
im dey kill am.
30. If e be like say everybody dey craze" na
you dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your
teeth cut am.
32. My thing and our thing no be the same
oh.
33. Na happiness dey make prick stand
34. Na as goat stand for market dem dey
price am.
35. Craze no hard to form, na the trekking
be wahala.
36. Its a small world!! No mean say you fit
trek from Naija go London.
37. No matter how hot your temper be, e
no fit boil beans.
38. Chicken wey run from Borno go Ibadan
go still end up inside pot of soup.
39. Today’s newspaper na tomorrow
Suya wrap.
40. Akara and moi moi get the same
parent, na wetin dem pass through make
dem different.

Add your own

2 Likes 2 Shares

Re: 40 Hilarious Proverbs by Asito(m): 7:06pm On Sep 14, 2015
[size=13]my personal favourite -toto water small but e reach priick take baff[/size] gringringrin lalasticlala, ben13, dani1luv, the world needs to see this. ***MODIFIED*** lemme drop my own grin [size=15pt]person wey use Camera360 snap picture, still edit am, Nogo Fit Make Heaven[/size] gringrin

2 Likes

Re: 40 Hilarious Proverbs by Damsman10(m): 7:09pm On Sep 14, 2015
@OP thanks 4 cracking my ribs

21. Person wey use Elephant set trap, na
him know wetin he wan Catch.

aeroplane?

2 Likes

Re: 40 Hilarious Proverbs by Ewizard(m): 7:26pm On Sep 14, 2015
grin grin
Mods do d needful mek odaz follow laff..


Lalasticlala.. undecided
Re: 40 Hilarious Proverbs by marshalcarter: 7:30pm On Sep 14, 2015
Pikin wey say me go laff for dis post don dey laff already grin

1 Like

Re: 40 Hilarious Proverbs by IceDude(m): 8:28pm On Sep 14, 2015
41. If madman don beat ur mama before she go run if she see mechanic 42. Cow wey dey hurry to travel go America go come back as corned beef 43. Pikin wey use agbada start to blow guy go talk wetin he go wear when he old 44. If life dey show you pepper take am do pepper soup. 45. To give monkey tea easy but to collect the cup na wahala

1 Like

Re: 40 Hilarious Proverbs by MightyFortress: 10:05pm On Sep 14, 2015
Any day wey small pikin catch bush rat, he go say make everybody cook him own soup.

2 Likes 1 Share

Re: 40 Hilarious Proverbs by APCREP: 2:49am On Sep 15, 2015
Who nor want trouble when e dey eat make e nor buy ingredients for credit

1 Like

Re: 40 Hilarious Proverbs by oppybouy(m): 7:27am On Sep 15, 2015
Looooool.

(1) (Reply)

Guys Be Like [photo] / Very Hilarious Photos But Real Fact LOLZ / Any Man Gonna Do This?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.