Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,409 members, 7,958,191 topics. Date: Wednesday, 25 September 2024 at 10:33 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully (1895 Views)
Hilarious Advert For GARRI In Pigin English....h / See An Indian Speaking And Singing In IGBO/PIGIN (inspiring) / Some Common Nigerian Pidgin Proverbs (2) (3) (4)
Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by Kingpinukecy(m): 8:43pm On Oct 01, 2015 |
Pidgin Proverbs . 1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin. 2. Woman wey never see problem... Na im dey still hold breast run. 3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep. 4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go hear am. 5. Na for afternoon dem dey find black goat. 6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg. 7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD. 8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march? 9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far. 10. Person wey don faint before no be stranger to death. 11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see. 12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains. 13. Yansh no get teeth but e dey cut shit. 14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself 15. Toto water small, but é reach prick take baff. 16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND. 17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck. 18. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside. 19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man. 20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat. 21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch. 22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open. 23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK. 24. Dem no dey tell tortoise say race don start. 25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food. 26. Before you see monkey, monkey don see you. 27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again. 28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury. 29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am. 30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze. 31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am. 32. My thing and our thing no be the same oh. 33. Na happiness dey make prick stand. 34. Na as goat stand for market dem dey price am. 35. Craze no hard to form, na the trekking be wahala. 36. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London. 37. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans. 38. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup. 39. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap. 40. Akara and moin moin get the same parent, na wetin dem pass through make dem different. ADD URS OOOooo! |
Re: Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by INTROVERT(f): 8:43pm On Oct 01, 2015 |
spacing paragraphing btw they are all funny.... nice |
Re: Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by McCarlito(m): 8:47pm On Oct 01, 2015 |
Pidgin English is supposed to be offered as a course in nigerian schools Meanwhile; How 'W' is pronounced: ENGLISH= Double U, YORUBA= Doubly U, IGBO= Doubelly You, HAUSA= Doufley You, CALABAR= Doubrey U 1 Like |
Re: Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by Nobody: 8:48pm On Oct 01, 2015 |
Hahaha, arrange this stuff bro. It will make front page. 1 Like |
Re: Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by LOC1(m): 8:51pm On Oct 01, 2015 |
AREA! |
Re: Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by Kingpinukecy(m): 8:56pm On Oct 01, 2015 |
ikenigel:Bros check it out how did u see it nw? |
Re: Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by jamesharryson(m): 9:02pm On Oct 01, 2015 |
No matter how short a man be, his prick no go fit dey roll for ground as he dey waka. Dem no dey use big prick intimidate ashawo Yam wey don done don done No be as bitter cola dey sound for mouth when dem dey chew am be as e dey sweet Na de sound of mess dey determine de taste of shit pikin wey dey laf him papa spoilt yam no know sey na de hunger wey go strike am tomorrow he dey laff The sweetest tin wey dey for madness na de trekking. I get am before no be property. If the fowl mess, de ground go dey pursue am Sweat and tears get the same colour and taste No matter how tall a building is, e get a ladder to climb d roof. No be de voice dem carry borrow money dem dey carry pay am back. 3 Likes 1 Share |
Re: Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by Niyeal(m): 9:09pm On Oct 01, 2015 |
V. Funny. |
Re: Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by hajlat(m): 9:25pm On Oct 01, 2015 |
Monkey no get skill, na tree near tree. 1 Like |
Re: Nigerian Pigin Proverbs... Read Carefully by Kingpinukecy(m): 6:30am On Oct 03, 2015 |
jamesharryson:my guy no b lie
|
(1) (Reply)
See What I Saw Beside Mobil Filling Station *photos* / Eritrea Sweet O (pics ) / Akpors Experience With His Teacher !
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 18 |