Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,888 members, 7,814,007 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 12:36 AM

Ejiro And Ovigwe (A True Life Story) - Family - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Family / Ejiro And Ovigwe (A True Life Story) (925 Views)

My True Life Story On Finding An 11-Year-Old Lost Child - Chocolateme (Pics) / Please Save A Sister's Life.... Story Verified / A True Mother/virtuous Woman (pic) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Ejiro And Ovigwe (A True Life Story) by Nobody: 8:30pm On Nov 11, 2015
FEAR GOD! FEAR WOMAN!


(True Life Story)


This na wetin happen for Ughelli this year.
Mr Ejiro with e wife, Ovigwe don born four children and dem don hands up for
borning.


Dem two just decide say make dem dey
enjoy their lives and marriage dey go
while dem dey take care of their children.


Una know say, couple wey nor dey born pikin again, dey get time to take care of
their body.


So, dem dey dey younger and look better
especially those wey know what's up.


Ejiro dey work as Estate Agent while e
wife na Nurse for one private hospital. She dey night duty when dem rush one
man wey appendix burst for e belle cum.



Na she nai shave the man that night.
After the operation, the man, Mr Jerome,
cum dey admire her.
Jerome just dey fall in love becos of her caring nature.

For the one week wey
Jerome dey the hospital, na she e dey like
make e do almost everything for am.


A day to when e wan discharge, nai
Jerome tell her say e love her and e go
really like to date her.

Ovigwe don already fall for am since the
very day she see am.


When Jerome ask her about her husband,
she cum lie say she norva marry.
Becos of say she get small body, Jerome
finally believe say she norva marry.


Dem two cum start dating.
Jerome dey work off shore work of 2
weeks in and 2 weeks off.


E don marry with children and e dey stay
Ughelli too with e family.


Anytime when e dey around, na hotel e with Ovigwe for dey meet.
That time, Ovigwe go tell her husband say
she get emergency for clinic and she go
stay till morning.



Unsuspecting husband go let her go.
On one of their meetings for their hotel room, Ovigwe cum tell Jerome make e
rent self contain for her say she don tire
to stay her Aunty place cos dem nor dey
let her get freedom.


When women dey lie, devil sef go dey
fear. Jerome cum rent and furnish the self
contain for her.
My pipo, na there dem two for cum dey
spend their time anytime Jerome dey
around.
Na so dem dey waka for more than two months.
If nor be Emergency call from clinic, na
allnight for church.
One morning, as Ovigwe dey lock the door
make she dey go house, her husband
friend, cum see her. E cum dey call her but she nor hear. She cum enter motor nai
Jerome carry her go house.
Jerome know say na her place be that but
e feel say na her Aunty place not knowing
say na her husband house.
All the while wey she dey sleep out or do night work, na nanny dey take care of the
children. Na nanny dey dress dem for
school while her husband go go drop dem
befor e dey go office.
For closing, the nanny go take keke go
carry dem come. That her husband friend cum go tell her
husband say e dey see e wife for one
particular compound with one man all the
time.
But the husband nor believe.
E don see her more than 10 times. Nai e say e nor go fit bear am again.
On this day, as Ovigwe dey enter the
room, Jerome just dey drive in.
Na so the husband friend carry phone call
the husband say make e come see e wife.
The husband cum first call e wife say where she dey?
Ovigwe lie say she dey clinic.
The husband cum call e friend back nai e
start to quarrel with am say make e nor
scatter e home for am say e wife dey
clinic. Trust na one dangerous thing.
When man trust woman, e hardly believe
anything wrong about e woman.
But love wey dem say e blind, nor mean
say e nor dey see. E simply mean say
despite all the things wey your partner dey do, you nor go mind.
Where e for dey argue with e friend, nai
the friend cut the call.
The friend cum call boys for the area nai e
explain who Ovigwe be. Say she be
married woman and she dey here with another man.
The area boys burst the door nai dem
drag Jerome come out start to beat am.
Dem enter Ovigwe with beat too.
Dem cum tell her to call her husband.
Befor the husband reach there, e nor see e friend but Ovigwe eyes don swell up.
The man body dey bring blood cos of
beating.
Dem carry dem two sidon for ground.
When the husband dey shamefully dey ask
wetin happen, Jerome cum dey beg say Ovigwe tell am say she norva marry nai
make am agree to dey date her.
The area boys allow Jerome carry e wife
go.
Dem cum collect money from Jerome
befor dem allow am carry e motor go. When Ejiro reach house with e wife, e
cum order her to park her things and
leave.
My pipo, na so their marriage take end o.
Now, when we dey talk this matter, who
we go say nai wan break the marriage?

Ovigwe cos of her unfaithfullness.


Ejiro, cos of e unforgiveness.


Ejiro friend, cos of e tafia.


Jerome cos of e eye wey nor fit comot
e eye from another woman body.


Or wetin you think?

And wetin you advise Jerome to do?
End the marriage?
Re: Ejiro And Ovigwe (A True Life Story) by LOC1(m): 8:32pm On Nov 11, 2015
Bros! I hail o. Dis ur pijin no be here o e just do me like say make d tori no end.....back to d topic......... Actually, na d woman dem suppose blame o as per say na 4 her hand the dirty waka start......
Oga lalasticlala abeg you sef yarn something

1 Like

Re: Ejiro And Ovigwe (A True Life Story) by Nobody: 8:57pm On Nov 11, 2015
LOC1:
Bros! I hail o. Dis ur pijin no be here o e just do me like say make d tori no end.....back to d topic......... Actually, na d woman dem suppose blame o as per say na 4 her hand the dirty waka start......
Oga lalasticlala abeg you sef yarn something


my guy, i like as u jst yarn ur mind, true...true if are one blame person, na d yeye woman ooooo, more comments pls
Re: Ejiro And Ovigwe (A True Life Story) by Rukkydelta(f): 9:03pm On Nov 11, 2015
This your story sweet no be small lalasticala come do your work
Re: Ejiro And Ovigwe (A True Life Story) by Nobody: 11:03pm On Nov 11, 2015
This kain tori fit comot joy for person hat oh. Ovigwe nor try at all.

But my own portion of advice be say, make Mr Ejiro find somewhere for e hat take forgive hin wife for her waka waka. E no go easy, but make he try give her second chance. She fit come change.

If e come be say later, she continue to carry herself everywhere around town, he fit separate from her, so that she no go give am all these yama yama disease them, wey fit quench person.

Make una nor blame me say I nor suggest divorce oh, but that na one thing wey my faith nor fit carry.

Na so I see am.

tongue

1 Like

Re: Ejiro And Ovigwe (A True Life Story) by Pidggin(f): 12:33am On Nov 12, 2015
Na Jerome and Ejiro dey at fault. If Jerome don marry why im still dey fain woman? Ejiro sef na mumu.

1 Like

Re: Ejiro And Ovigwe (A True Life Story) by Nobody: 1:55pm On Nov 12, 2015
Rukkydelta:
This your story sweet no be small lalasticala come do your work


tnk u my sista, u fit check my profile to see more sweet sweet tori like dis.

(1) (Reply)

Matured Advice Needed Please. / Beat The Heat With Rechargable Fans!!! / The Family That Got Sextuplets 6yrs Ago Just Recreated The Picture - Wonderful

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 26
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.