Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,205 members, 7,818,701 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 10:06 PM

Ephesians 6 10 -23 In Pidgin - Religion - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Religion / Ephesians 6 10 -23 In Pidgin (819 Views)

Exposing The Goat Nature In Church (2) [hebrews 10:23-25, Matthew 12:22-30] / The Most Powerful Truth Revealed By Apostle Paul In The Bible!! - Andrew Wommack / . (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Ephesians 6 10 -23 In Pidgin by KMB: 8:05pm On Nov 16, 2015
Ephesians in pidgin 6:10 -23

10 Finali, mak una dey strong wit Kraist mighti pawa. 

11 Mak una wear komplit soja uniform wey God dey giv, so dat una go fit stand fite di wayo wey devol dey yuz.

12 Bikos, wi nor dey fite against humanbin, bot na against di wiked rulas wey dey for dis wold, against evil spirits and pawas wey dey di hevuns. 

13 Na dis mak mi sey, mak una wear komplit soja uniform wey God dey giv, so dat una go fit stand for groun wen trobol and wahala go kom and wen una don win, una go stil stand wel. 

14 So, mak una stand wel-wel kon tie trut laik belt roun una waist, den wear bullet proof koat as raitiousnes for una bodi.

15 Mak una wear shu for leg wey go show sey, una dey redi to prish di Gud News wey dey giv pipol peace

16 and wit all dis, mak una kari fate wey go help una kwensh all di wiked arrows wey Satan dey trow. 

17 Make una wear salvashon laik cap for head kon hol di Spirit sword wey bi God wod.

18 Wit difren prayas, mak una dey ask God to help una. Mak una always dey pray wit di Spirit and dey shine una eyes wel-wel. Mak una nor giv up, bot mak una kontinu to pray for all God pipol.

19 Mak una pray for mi tu sey, mak God giv mi beta wod enitaim wen I opun my mout to tok and mak I fit esplain di sikrit wey dey di gospol. 

20 I bi God mesenja, ivun doh I dey for prizin naw. Bot mak una pray sey, I go dey tok wit boldnes as I sopoz to tok. 

21Tikikus wey bi my special broda and fateful savant for God wok, go tel una evritin, so dat una go no wetin dey hapun to mi for here. 

22 Na bikos of dis I send am kom mit una, mak una for no haw tins dey wit us for here and mak e for fit enkorage una heart.

23 I pray sey mak God, awa Papa and Oga Jisos Kraist giv all my felow Kristen brodas a

2 Likes

Re: Ephesians 6 10 -23 In Pidgin by Bern1992(m): 8:32pm On Nov 16, 2015
If God happens to see diz one een,,,, na red card him go giv you

grin grin grin
Re: Ephesians 6 10 -23 In Pidgin by dsquare33: 9:17pm On Nov 16, 2015
Lols, nice one, although if the "soldier" word can be replaced with another word it would have better. if the Bible can be interpreted to Pidgin English language then those who are fluent in pidgin English will have a deep profound knowledge of the word of God better.

(1) (Reply)

Open Heavens Daily Devotional 23/02/16 / The Rosary And The Scapular Are Inseparable / Check Out The Theme Of This Church Program.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.