Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,195,523 members, 7,958,611 topics. Date: Wednesday, 25 September 2024 at 06:33 PM

Hhahahahah!! Must Laugh I Carry 3rd Position - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Hhahahahah!! Must Laugh I Carry 3rd Position (635 Views)

You Must Laugh / 31 Funny Sarcastic Replies You Must Laugh To / I Swear You Must Laugh If You No Laugh Konk Me (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Hhahahahah!! Must Laugh I Carry 3rd Position by kraftbeat(m): 11:49pm On Nov 20, 2015
Akpos :- Papa, See my result, Na me carry 3rd.

Papa Akpos :- Hahahaha, Akpos Akpos! Na now I know say na me born you.

Akpos :- Shey I tell you na. All those time I dey carry 35th..Na the teachers dey do ojoro, They know say I too brilliant.

Papa Akpos :- I believe you my boy. Na now I fit buy that Bicycle wey you see for Papa Metus shop !

Akpos :- Papa na u biko. You get mouth pass BasketMouth.

Papa Akpos :- but, Who be the two idiots wey pass u sef Akpos?

Akpos :- Na one WIZARD wey be Isaac and one WITCH wey be Patience.

Papa Akpos :- No mind them, You go show them next term. But who you come pass na? I no say dem plenty and you no fit mention all of them, I just wan know how many of una dey class.

Akpos :- Na just the three of us I don mention so na… Isaac, Patience and Me. Na just the three of us PRINCIPAL put for Elementary Class ‘F’ !!!

Na im Akpos papa just land for floor, gboossa, faint o!!!

Get This LAtest Free Beat Now From Prepare http://www.kraftbeats.org/product/prepare-free-beat-prod-by-prepare/

(1) (Reply)

Women Can Hardly Be Caught.... / Laugh Out Ur Sorrows... / Dasuki V Buhari: Caption The Photos

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 7
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.