Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,157,900 members, 7,834,989 topics. Date: Monday, 20 May 2024 at 11:56 PM

My Year Of Restoration, A Very Touching Story - A Must Read. - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / My Year Of Restoration, A Very Touching Story - A Must Read. (604 Views)

Mercy Aigbe Celebrates One Year Of Marriage Crash / Mr Eazi: "Dating Temi Otedola Is One Of The Highlights Of My Year" / "Best Year Of My Life" Peter Okoye Says As He Shares New Photo (2) (3) (4)

(1) (Reply)

My Year Of Restoration, A Very Touching Story - A Must Read. by Nobody: 3:07pm On Jan 08, 2016
Jerry dey look e wife, Peace for where she
sidon for bed dey vex.
Peace cum dey try explain say nor be her fault say things like this dey happen to
her.
Dem just dey come back from hospital
where dem rush her go becos of another
miscarriage wey she get.
Na four years dem don marry now. And na two times she don get
miscarriage including this one,
For Jerry mind, maybe ba spiritUal
problem dey follow e wife.
So, e cum dey tell her say if this
miscarriage thing happen again, she go explain why e be say na only she e dey
happen to out of all the 6 women wey dey
their family as wife.
Na there e for threaten her say if this
happen again, she go leave e house.
So, make she ready to go find solution to her problem. Cos as it is, e nor get hand
for any miscarriage again.
She just dey cry dey think her life.
Like the faithful woman she was, when
you see wetin strong pass you, you go run
to God. Na so she face God squarely.
Every week na church.
Steady all night.
Every church program she dey attend.
She don cry to God.
And God cum pick her call. After 8 months, she cum take in again.
Her belle cum dey big.
Pipo begin talk.
"She don carry belle again o.
After the belle go fall.
Na fibroid dey her belle. She dey deceive herself becos ba fake
belle she dey carry..."
My pipo, when God open your file, pipo go
start to talk different things to paint your
blessing bad.
Her husband cum dey tell her make she go hospital go confirm whether na belle she
get.
She go come, doctor say na fibroid dey
grow for her bell.
She became confused.
Her world collapse for her head. Tears began to wet her face.
But she nor end am there.
She go those maternity homes, na there
dem for dey rub her dey tell her say she
carry baby.
Even her pastor tell her say make she keep praying.
She go deliver in due time.
6 months later, her husband carry her to
hospital again when her belle don big
well well.
Doctor say the fibroid don big well well. And dem need to operate am or else, she
go die.
Her husband cum make arrangement
with doctor say dem dey come for the
operation but she nor gree.
Every day, na tears be her food. She dey pray to God to help her out of this
confusion.
Na when the husband dey provoke with
her about going to remove the fibroid and
if she nor gree, nai she dey tell am in
tears "I respect you as my husband.
But I honour God as my creator.
I am carrying a child.
Why is it hard for you to believe?
My spiritual father said I am with a child.
And the doctor said it is fibroid. Whose report will you believe?...
Whose?
God or man?"
TEARS!
TEARS!!
TEARS!!! Tears dey flow more by now
"I shall believe in the report of the Lord"
Where she for dey wan sidon cos eye don
dey turn her, nai she fall for ground.
Her husband cum rush her straight to
hospital. When dem reach there, she manage open
her eyes nai she say make dem call her
pastor come.
The husband cum call her pastor.
As the doctor wan roll her enter
Emergency ward, nai be water wey burst from her private part.
The doctor cum scream
"A child is coming"
As she manage push the baby out, na that
time her pastor come.
E rush dey outside the emergency ward with the husband dey pray.
Just in time, another baby pop e head out.
She push again.
Two baby boys.
As the babies dey cry, the husband dey in
surprise for outside. Once nai e run enter the ward even befor
dem hold am.
As e dey ask how come?, the third baby
dey come out. A baby girl.
My pipo, na so Peace take born triplets.
When dem discharge go house, the husband was so stupefied to the extent
say e cum dey sorry for himself.
E cum kneel down for e wife corner dey
beg make she forgive am.
Peace hold am for head nai she say make
e get up say e nor offender her. When she dey think all the humiliation
wey pipo don give her becos of
miscarriage wey she dey get, she cum
burst into songs
"Count your blessings name dem one by
one. Count your blessings see what God has
done.
Count your blessings
Name them one by one
And it will surprise you what the Lord has
done... With tears nai she dey raise the song.
Her younger sister cum carry am nai she
begin flow
"It's not by power
It's not by might
But by my spirit says the Lord.. Everybody wey dey the house wey cum
salute her for the blessing and miracle
birth, cum dey sing to the glory of God.
PRAYER
This year shall be our year of total
restoration. Anything wey we lose for 2015, God will
give it to us double in Jesus name.
Amen.
Re: My Year Of Restoration, A Very Touching Story - A Must Read. by doyinisaac(m): 3:38pm On Jan 08, 2016
Amen!!!!! thanks for the nollywood scripts you just shared with us...grin
Re: My Year Of Restoration, A Very Touching Story - A Must Read. by Nobody: 9:17am On Jan 10, 2016
doyinisaac:
Amen!!!!! thanks for the nollywood scripts you just shared with us...grin


na real nolllywood script.

(1) (Reply)

★ Angry Nigerian Finishes Vic O – See Tweet / Beef Stew Everywhere! Shizzi Drags Tunde Ednut & Masterkraft To Court For Theft. / Wizkid & Dammykrane’s Beef Goes Down And Ends Up With Broken Bottles

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 18
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.