Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,609 members, 7,816,509 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 12:21 PM

Dollar Kpalava - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Dollar Kpalava (447 Views)

Dollar Kpalava (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Dollar Kpalava by klassykute(m): 5:33pm On Mar 01, 2016
.. i hail una oo.. i noticec something that got me rest assured dat d rise in dollar has affected our bottling company in naija ... stright to d mata .... me na tiler i be ' as i ballin work today make u hustle get small tin to buy my text book for skool (uniben) na so sun sama me o .. d sun dry almost all water for my body .. na small remain mk e enter blood.. nia i say i cannot come and go and kill myself.. sharp sharp nia i enter one small store mk i quick swallow bread and high Pepsi .. as i hala d woman there .. mama gimmie bread and pepsi she say ok but pepsi na 90 card now o.. chia i put hand for head .. i say i no go buy o .. for wat.. dem dey import pepsi now? she boon me .. as i get up mk i move na so i remba say pesin fit die if i no chop o.. na so i strong face come back say oya gimmie nd one small bread .. she say okay but bread na 80naira now ooo.. chiaaaa i shout..... but man gats wack o.. na so i say bring am .. one minute e don land for table.. na so i dive bread begin tear am.. d bread dñ full my mouth na so i open my pepsi ..as i pour am for mouth.. e no taste well like b4.. i remove bread from mouth .. pour pepsi for mouth broda na water and colored dey my mouth.. shooooooo i shout na Onitsha dem make dis one ... d woman shout no na d new pepsi b dat na zero sugar...i still dey brewery dey wait to write complain now @lalasticlala come and see o

(1) (Reply)

Many Of Us Even See Them Get A Little Time On Steams Top 15 Sales List / Looking For A New Job / Video: A Friend Used My 1million Alabi Ticket As Tissue Paper And Ticket Won

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.