Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,604 members, 7,809,195 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 04:27 AM

This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn (1087 Views)

Welcome To The Village Where They Drink The Same Water With Goats (PHOTO) / Is It Compulsory To Do Ones Traditional Wedding At The Village? / People Build Better Houses In The Village: Why? (2) (3) (4)

(1) (Go Down)

This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn by giftspex: 4:26pm On Sep 05, 2009
This na the village square, u sabi say to yarn free flowing oyinbo na war, make we begin yarn our own language.
U go fit start any kind of yarn for here, u fit even scatter yarn
If u get big grammar or sentence wey u don dey wonder how e go sound for pidgin bring am here make we scatter am for you here.
you go fit translate some sentence from obodo oyinbo yarn to our own yarn (English to pidgin)
The elders ready to sanction anybody wey form say e too sabi come dey yarn grammar

!!!!!!!UNA WELIKOM!!!!!

abeg make people scatter the words wey too black for here

i b one of the Elders of the village square
Re: This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn by zmurda(m): 4:49pm On Sep 05, 2009
ma guy, na the very idea be dis. i de gbadun as u talk ur mind say we wey no fit to de hammer plenty plenty gramma at least get voice to for de yarn.
my people, the thin wey oyibo de take person eye see pass red pepper for inside eye. e be like when busuru de pursue she goat.
as today be so, no be very good day for me. i de cry, ma eye de tear water as Oga Gani, the one and only person wey get poor people for mind die. no be small thing happen. na elephant wey fall for forest be this. tree don scatter. e no easy.
As person don talk im own mind finish, na to go chille. i de come, make i just waka small, we go jam for area!
Re: This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn by giftspex: 5:01pm On Sep 05, 2009
Guy u no lie na bigger tree fall for forest make baba Gode put am for better bed for yonda, as e take happun so na ova to u and me, aluta continua, as you don yarn so, i go tell elders say i don sii person wey suppose to dey chop for we elders table, ride on broda
Re: This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn by mamagee6(f): 6:58pm On Sep 05, 2009
I hate pidgin.
Re: This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn by Krayola2(m): 8:20pm On Sep 05, 2009
If u hate pidgin u fit go jump inside river. grin Na your wahala be dat. Wetin dey nah. . .?
Re: This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn by zmurda(m): 8:26pm On Sep 05, 2009
,mama-gee:

I hate pidgin.

Shuooo, I tire for you o. As ma broda for talk make u try jump inside warrer. pidgin na the ogbonge naija language. no for say na only oyibo. na pidgin all man for area undastan. driver o, president o, student, tisha, condo, pepper seller, all follow body speak am for we land
anybody wey no undastan the language don lost, how you take different from person wey come from somalia. mama gee abeg take your time o grin grin

anyhow ma people, na hailing i still follow finish this talk. bushrat wey go follow fire play, na bush meat e go become.
Re: This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn by luridguy(m): 11:21pm On Sep 05, 2009
na just start to dey yarn jare, yarn me better sometin fur pigin jare. if u no like am, no mean say we no go yarn
Re: This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn by chrisical(m): 2:45pm On Sep 06, 2009
Guys wetin de na.Make una leave that guy wey no sabi pidgin alone.Na him wahaala be that.
Re: This Na The Village Square: Na Pidgin B D Official Yarn by Nobody: 4:59pm On Oct 01, 2009
People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills
https://www.nairaland.com/nigeria/topic-109915.160.html

(1)

Easter Family Fun April 24th: Lagos State Water Regatta On The Way / Hollywood Apartheid / I Kneel Down To My Nigerian Husband Every Day

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.