Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,194,286 members, 7,954,134 topics. Date: Friday, 20 September 2024 at 12:52 PM

Naija For Life - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Naija For Life (798 Views)

Silly Question, Brilliant Answer. Naija For You! (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Naija For Life by bigmarvelous(m): 9:57pm On Aug 10, 2016
I LOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless Nigeria!!! 1. Na only 4 9ja U fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card. 2. Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship. 3. Then Airtel go com follow sey recharge N100 and win Benin Republic. 4. Glo,go just kuku say.. Recharge N500 and win Nigeria because their colour na Green. 5 Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE" 6. Na only 4 Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. 7. Na only 4 Nigeria PHCN dey sey:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a pity) 8. Na only 4 Naija pple dey horn for traffic light make e quickly change from Red to Green. 9. Na only 4 Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin,Puff puff and beer. Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world..Trust me. 10. Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC 4 Police station. 11. na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once. You be Bill Gates? Abi na you invent internet? 12. Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer. 13. Na only for Naija u go buy coke, dem go say make u no forget to return d bottle. 14. Na 4 only Naija, you go see madman dey control traffic,people wey their head correct dey obey... 15. Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money. 16. Na only 4 Naija u go wish somebody 'happy birthday', he go answer 'same to u 17. Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS RELOCATED" .. Add your own please!!!

(1) (Reply)

How To Hack Nairaland.com-pictures / Marriage Software Discovered / How I Make My Billions Of Dollars In One Day - Mark Zuckerberg

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.