Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,081 members, 7,818,238 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 10:55 AM

King kObOkO's Version (KkV) 001 - Religion - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Religion / King kObOkO's Version (KkV) 001 (719 Views)

‘Na My Matter Go Kill You’ – Church Banner Spotted In Benin, Edo State. Photo / Pastor Prays Over Brooms In Church, Gives Members To Sweep Away Evil. Photos / "Oh God, Na Like This We God Dey?" Church Poster (2) (3) (4)

(1) (Reply)

King kObOkO's Version (KkV) 001 by kingkoboko: 7:31am On Aug 14, 2016
From my own observation...
Re: King kObOkO's Version (KkV) 001 by kingkoboko: 8:24pm On Apr 10, 2022
King kObOkO's Version (KkV) 001

1. E get one landlord like that wey suffer buy many plots of land, build four-storey for Naija. Him rent am out to some tenants, write him account number for wall, com relocate go America. 2. When time reach to collect rent, the landlord wait wait wait, him no see alert. 3. Him com send one of him boys to go ask him tenants how far. The tenants beat the boy, pursue am comot from the house. 4. The landlord send another of him boy, them beat am like thief am pursue am comot from the compound.
5. The landlord come send him strongest boy wey resemble bouncer but him tenants no fear. Them still panelbeat the guy pursue am comot from the whole area. 6. Na that time the landlord know sey the matter don pass play-play.
7. Him vex call him pikin tell am sey "Junior, those our tenants for Naija no gree pay their rent o! E be like sey na vawulence them want! I go give them real vawulence!" 8. Junior kneel down say "Baba mi, e never reach like that abeg. Make I go there by myself go reason with them. Them go pay us."
9. Na so Junior rush go Naija make him help him papa collect their money. 10. As him enter the area dey waka com him papa house, one tenant sight am from window, shout "Make una come o! No be Landlord pikin I dey see so?"
11. "Ye! Na Oga Landlord pikin o!" the other tenants put hand for head. "We don die today!"
12. "Who don die? Why una dey cap like jew-men? Na him go die today."
13. "Haaa!" one woman for there shock "Wetin you dey talk? You dey..."
14. "Shut up jor! Use your Number Six. Landlord dey abroad and him don old. If we delete this him pikin, this fine house & this big compound go become our own. Una dey feel me?"
15. Na so all the tenants nod their head, run go hide for different corners of the compound, dey wait for their landlord pikin to enter the house. 16. As him dey knock for one door, them hold am, tie him mouth, "Ole!" them slap am, "Thief!" them blow am, "Armed robber!" them naked am, drag am go backyard, put tire for him neck, pour fuel for him body, burn am.
17. Them turn their landlord pikin to burnt-offering for Naija that day.
18. Later, the tenants renovate the four-storey building name am Junior's Lodge. Later later, their children build other houses inside the compound name am Junior's Compound. 19. If na you be the landlord, na wetin you go do this tenants & their children?

© King kObOkO

https://yourkoboko./2022/04/10/king-kobokos-version-kkv-001/

(1) (Reply)

Must A Christian Be Circumcised? / Lost Christianity / Pastor James David Manning's Warning Of God's Plan For Gay People's Buttholes!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.