Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,375 members, 7,826,477 topics. Date: Monday, 13 May 2024 at 02:53 PM

A Young Mother's Monologue (a Tribute To Nursing Mothers) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / A Young Mother's Monologue (a Tribute To Nursing Mothers) (465 Views)

SaharaTV Special: A Tribute To Chinua Achebe (Video) / SCARLET:A Monologue(constructive Criticisms Are Welcome) / A Tribute To My Grandfather. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

A Young Mother's Monologue (a Tribute To Nursing Mothers) by lagtim(m): 9:25am On Sep 12, 2016
1.
Belle dey worry me before.
To sleep sef, dat one na yawa
because say I wan born pikin;
now wey I don born,
pikin come dey worry me

2.
I tap my husband, make him wake up,
make him change Baby pampers,
make me sef close eye small,
he say that one na woman job,
when e dey sweet am,
him no talk that one o!

3.
See as this yeye man dey snore,
no be him give me belle ?
No be him pikin I carry ?
Shebi him talk say him go love me tire ?
Shebi he talk say he fit die for me ?

4.
No be now now night just fall?
I never close eye reach one hour
cock don crow already
Baby dey suck suck
Baby no gree me sleep

5
As Baby reach three weeks,
my yeye husband come again
he dey smile, dey rub my back;
e be like say I recover fast fast,
he tell me say I don dey fine again o,
he wan make e dey sweet am again !


Also available on this blog.
A big thanks to MrAjayi for publishing the poem on his blog

https://mrajayi./2016/09/06/tuesday-poema-young-mothers-monologue-by-timilehin-olagunju/
@lagunjutimi

(1) (Reply)

The Lone Child By Womanofrace / Fallen Hero / The Chain Series: Obsessions

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 6
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.