Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,085 members, 7,821,745 topics. Date: Wednesday, 08 May 2024 at 05:45 PM

*some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / *some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession (15023 Views)

Nigeria Pidgin Proverbs / Some Common Nigerian Pidgin Proverbs / Recession: Woman Locks Her Rice Warehouse With Many Padlocks (Photo) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

*some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession by ojdollars(m): 7:00pm On Sep 19, 2016
*SOME LAFFABLE WARRI PIDGIN PROVERBS!!!*
1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.
2. Woman wey never see problem... Na im
dey still hold breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear
pant sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later e go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black goat.
6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no
know say the journey far.
10. Person wey don faint before no be
stranger to death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.
12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if
nobody hail am!! é go hail hims
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.
17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
18. Na cricket tell him children say, No
matter how ground strong, Them no go sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.
20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.
21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.
22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS,BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say race don start.
25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.
26. Before you see monkey, monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again.
28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.
30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your
teeth cut am.
32. My thing and our thing no be the same
oh.
33. Na happiness dey make prick stand.
34. Na as goat stand for market dem dey
price am.
35. Craze no hard to form, na the trekking be wahala.
36. Its a small world!! No mean say you fit
trek from Naija go London.
37. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans.
38. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.
39. Today’s newspaper na tomorrow Suya
wrap.
40. Akara and moin moin get the same
parent, na wetin dem pass through make
dem different.
*ABEG WHICH IS THE FUNNIEST. . .*
Copied from WHATSAPP.

3 Likes

Re: *some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession by EnyojoAmos: 7:07pm On Sep 19, 2016
38

1 Like

Re: *some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession by Aregs(m): 7:08pm On Sep 19, 2016
Lol
Re: *some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession by Dezzx(m): 7:09pm On Sep 19, 2016
grin
Re: *some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession by Djicemob: 7:09pm On Sep 19, 2016
Woman wey dey find pikin no dey use pant sleep grin

1 Like

Re: *some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession by Flexherbal(m): 7:22pm On Sep 19, 2016
Djicemob:
Woman wey dey find pikin no dey use pant sleep grin
You gat it, Man.
Re: *some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession by Nobody: 8:13pm On Sep 19, 2016
23 na b awa inspiration for school those days. No b say we do expo o.
Re: *some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession by kuuljay(m): 6:50am On Sep 20, 2016
Them no dey use violence take kill mosquito wey kack for blokos grin
Re: *some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession by drstainlex: 8:59am On Sep 20, 2016
41 No be by power dem take dey raise preek

42 Yam wey mama give pickin nor go fit burn the pickin hand.

43 Who open eye cut shaki for pepper soup is scared of nothin'

44 Toet0e water small but e dey reach preek baff

45 Egg sweet, egg sweet but na fowl yanch dey suffer am

46 Theif wey theif from anoda theif nor fit go jail theif at all.

47 Every aboki with him kettle

1 Like

(1) (Reply)

Wikipedia Google Facebook Internet Electricity Joke / Ask Me Anything On Why The Chicken Crossed The Road. / Funny/dirty Words Used In Nigerian News Papers

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.