Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,519 members, 7,823,227 topics. Date: Friday, 10 May 2024 at 07:07 AM

Upcoming Music Artiste Threaten Sey Em Go Kill People If Anything Happen 2evans - Crime - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / Upcoming Music Artiste Threaten Sey Em Go Kill People If Anything Happen 2evans (351 Views)

Fulani Herdsmen Kill People Coming Back From Church In Jos (Graphic Photos) / Fulani Herdsmen Kill People Along Makurdi Naka Road (Graphic Photos) / Gunmen Kill People In Gwaska, Birnin-Gwair, Kaduna State (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Upcoming Music Artiste Threaten Sey Em Go Kill People If Anything Happen 2evans by Joyakosa(f): 6:11pm On Jun 23, 2017
Nigerians don condemn one Facebook user, T Shine Sisi Eko, wey talk say billionaire kidnapper, Chukwuduben Onwuamadike, (Evans) no do anything wrong.



He say Nigeria na very bad country for Igbo, and Evans na one person wey don get part of the bad experience. He say when Evans dey kidnap he help so many people.

T Shine na upcoming music artiste for the country.

See wetin em post here:

“Nigeria is never a good country. And we igbos are not qualify to be a country until we learn hw to defend our selves. Evan did nothing I mean nothing. After all he has helped some many souls with the kidnapping business,, u,, who u EPP” T Shine Sisi Eko asked in his much-reviled June 18 Facebook post.

“Is Evans more deadly than kabiru sokoto?or more a criminal than,Ameachi,thinubu,saraki,lai mohammed,buhari,other politicians,from all his confession did anybody had that he ve killied any one?they should free him jor! come to think of it,it’s the useless one sided govrment of zoo that turn him to a criminal over night by sizing his continer,”

So many Nigerians insult the guy ontop the threats so.
T Shine Gbege: ‘No be me make the threats, dem hack my account’ – TShine
Nigerian upcoming artiste wey threaten sey em go kill people if anything happen to Billionaire Kidnapper Evans don yarn sey no be em post the threat sey na person hack em account.

Later, Tshine, kon do interview say dem hack em account, kon take another account wey em name T Shine Gano post am.

He sey na person enter em account kon hack am kon start to dey use am post about Evans sey em no get hand for there.
T Shine Gbege: ‘No wonder God dey punish Naija with bad leaders’
Nigerian upcoming artiste and Facebook user, T Shine Sisi Eko, threaten sey em go kill people if anything happen to Billionaire kidnapper wey people know as Evans.

For T Shine Facebook post, he yarn sey Nigerian na bad country for Igbos and na wetin Evans dey experience.

He yarn sey wetin Evans do no reach wetin Nigerian leaders don do.

Later on, T Shine post one video with em other account T Shine Gano sey no be em post the threat sey na hack dem hack em account.

Ontop the video, one person comment with photo to show sey the guy wey interview T Shine no be journalist but na T Shine friend.



Ontop this matter so, the guy wey interview T Shine, with Facebook name, Itz Da Casanova, kon comment sey when em dey with T Shine nobody dey share their post but now wey dem hack em (T Shine) account dem kon dey share the post.

He kon talk say “No wonder God dey punish naija with bad l**ders so because even their supporters bad“

Re: Upcoming Music Artiste Threaten Sey Em Go Kill People If Anything Happen 2evans by adonbilivit: 6:32pm On Jun 23, 2017
For him mind him go blow now abi? Skiibii did fake his death and till date, he is still a mere E-money and kcee's champagne popper.

(1) (Reply)

Why It Was Hard For Police To Arrest Me – Evans / Man Stabs Wife To Death Over N2000 Housekeeping Allowance / Doctor Licks Patient's Sperm

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.