Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,535 members, 7,827,001 topics. Date: Tuesday, 14 May 2024 at 03:43 AM

Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up - Culture (7) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up (59381 Views)

Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? / Some Interesting Nigerian Proverbs With Pictures / Proverbs From The Streets Of Warri (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply) (Go Down)

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 7:49pm On Oct 06, 2018
Divay22:
If goat know say salad dey he for no dey chop grass grin grin
Pesin way get big teeth make he still get big lip take cover am (I know one gorvenor that has both) grin

If you no fit climb na ground you take dey talk am

I NO KNOW na dey commot pesin from police wahala

Book way no gree enter head go follow enter exam hall grin
That must be my governor...the day wey the lips go fall..kpomo go cheap
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by odiinsgrace(m): 7:54pm On Oct 06, 2018
D title "PUSH AND STAND" no be for one legged man
I no follow,no be for Nigerian police station
Mad man say wetin him dey do,him know but wetin dey do am,him no knw
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by kingsclass: 8:03pm On Oct 06, 2018
Cow wey no get tail na god dey drive fly for am.
Monkey smart,monkey smart na when tree near tree.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Divay22(f): 8:36pm On Oct 06, 2018
morningstar55:
That must be my governor...the day wey the lips go fall..kpomo go cheap
Lol
Which state?
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Eastatlantaniqqa(m): 8:41pm On Oct 06, 2018
If trust dae
Then water no for dae cook fish

1 Like 1 Share

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 8:48pm On Oct 06, 2018
no matter how hard he goat frown him face e no fit make the owner fear to carry am going market or put am knife for neck when time reach
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 9:09pm On Oct 06, 2018
Divay22:

Lol
Which state?
Na my mouth you wan hear say nyash get centre parting abi?
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by mansoura(f): 9:22pm On Oct 06, 2018
To marry wife no hard, na money for soup be problem
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by ItzTigrex(f): 9:23pm On Oct 06, 2018
Monkey no fine but im mama like am, soup wey sweet na beta money kill am, gimme my cap gimme my cap naim dey make small pikin touch him elder head, d difference between "kpekere & bolle" na packaging.. no be ask snake long reach dem dey set fire follow am,.. wey two elephants dey fight na ground dey suffer am,.e sweet me e sweet u na wu go pay.,do me i do u god no go vex..man pass man no be to waka pass person 4 road..frog wey say all water na water make im try hot water..

2 Likes

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Divay22(f): 9:25pm On Oct 06, 2018
morningstar55:
Na my mouth you wan hear say nyash get centre parting abi?
Lol.. You dey fear
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by franvincoop: 9:35pm On Oct 06, 2018
the same shit wey man leave when e di travel, na that same shit e match carry go e house when e di return
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by ItzTigrex(f): 9:35pm On Oct 06, 2018
No matter d weight of an elephant, e no fit cause earthquake... fly wey no get adviser e dey follow coffin kpeme 4 inside grave... wetin old man see wey im sidon 4 ground small pikin no go fit see am even if he climb tree.. no matter wetin devil smoke he no fit b the MOST HIGH., wetin u dey find for sokoto dey 4 ur shokoto... no b my mouth u go hear say ogbono dey draw

1 Like

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by 99miles(m): 9:40pm On Oct 06, 2018
Rat wey go thief sardine 9 kno how e go take open o............
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by trendist: 10:23pm On Oct 06, 2018
Come chop, u dey wash hand reach shoulder
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by 88Gadas(m): 3:03am On Oct 07, 2018
Hujosi:
Nyash no get teeth but e dey cut shìt.

Person wey de sell egg, no dey start fight for market

Shame nor dey catch craze man, na him people shame dey catch..

Pikin wey play with him mama bress, no fit play with him papa blockos

This life na per head.

Farm for your farm.

Pregnant woman no fit pass under bench

Pikin wey wan chop party rice, no supposed to dey fear dance.

Lean on me no mean say make you push me enter wall

I no get patience no be when mosquito land on your scrotum

Hunger dey take long time but to belleful no dey take minutes

Woman wey dey find pikin,no dey wear pant sleep.



Add yours..




grin
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Kaysalas(m): 7:18am On Oct 07, 2018
Sleekfingers:
If meter dey for Toto,many men no go wan marry...

Honey sweet, but he no reach Toto own

Na slim girls Toto dey deep pass


Nobody go tell prick to salute when he see Toto wey swell up...

Na for woman lips, you go know how her Toto go be

Oil wey dey for Toto no fit fry egg

Woman wey Jerry curl Toto, na for easy entry for prick

The best food for Toto na prick

Na style style Toto dey take swallow big prick

Bros! Na wa for u O! U fit kill person with this ur proverbs O! Kai! Lwkmh

2 Likes

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by uvalued(m): 10:19am On Oct 07, 2018
thank you for pidgin english
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by smith666999(m): 12:37pm On Oct 07, 2018
Waffarianman:
Who Dey Shake Coconut Nai E Head E Dey Shake. Lol

Dog No Get Head Wen Take Dey Carry Load, Na Who Get Load Dey Carry E Load. Lol

Dog Wen Dey Shaze Elephant Na Emsef E Dey Worry. Lol

Na Who Dey Pursuit Foul Nai Dey Fall, all our enemies go fall behind us. Lol

Na Who Arranged wood nai go carry E wood. Lol


More Loading

you say? �
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Waffarianman(m): 7:56pm On Oct 08, 2018
ololade91:
undecided undecided



Afa lol.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Waffarianman(m): 7:57pm On Oct 08, 2018
smith666999:

you say? �


I say na who get load dey carri E load. Abi u won carri anoda person load lol
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by ezenwajunior(m): 7:10pm On Oct 09, 2018
Person wey use elephant set trap, na him know Wetin him wan catch....
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by kpoins: 7:42am On Oct 10, 2018
1, Person die, u say make ground nor hear, ok tell me were u go bury the person?

2, Pikin wey fine well well, he nor good say make he body dirty on market day.

3, Dem nor take power dey draw debt.

4, Wetin man go do, wetin man go do naim agbor men take join police force.

5,The sunday wey them go cook rice, na Saturday them dey know.

More rolling in
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by tobore4u(m): 10:02pm On Oct 14, 2018
feldido:
Monkey no fine but him mama like am
NA condition make crayfish bend
No be who first call police de win case
I no gree I no gree nai de tear shirt
Cow wey no get tail na God de drive fly for am
You are one of the most amazing person i've come across on nairaland. you left sport betting without looking back...Indeed u deserve some accolade. sir how did u do it?. help a friend please.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by feldido(m): 11:55am On Oct 15, 2018
tobore4u:
You are one of the most amazing person i've come across on nairaland. you left sport betting without looking back...Indeed u deserve some accolade. sir how did u do it?. help a friend please.

Actually is God and courage. Made up my mind as soon as I considered getting married.
I realized a Gambler can't have a happy home, so I cut all influences and remained focus.
And I don't regret doing that.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by tobore4u(m): 9:10pm On Oct 16, 2018
feldido:


Actually is God and courage. Made up my mind as soon as I considered getting married.
I realized a Gambler can't have a happy home, so I cut all influences and remained focus.
And I don't regret doing that.
Thanks for the tip sir.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by tobore4u(m): 10:09pm On Oct 16, 2018
feldido:


Actually is God and courage. Made up my mind as soon as I considered getting married.
I realized a Gambler can't have a happy home, so I cut all influences and remained focus.
And I don't regret doing that.
"I cut all influences". does that mean u no longer watch football matches, for instances u know nig played libya today, and u dont check livescores to know what is happening in the world of football?
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by feldido(m): 7:17am On Oct 17, 2018
tobore4u:
"I cut all influences". does that mean u no longer watch football matches, for instances u know nig played libya today, and u dont check livescores to know what is happening in the world of football?

Exactly, I stopped checking livescores and limit my watching of Football.
Infact I stopped anything that has links to sport betting.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by tobore4u(m): 11:03am On Oct 17, 2018
feldido:


Exactly, I stopped checking livescores and limit my watching of Football.
Infact I stopped anything that has links to sport betting.
God bless u sir for the tips. hopefully i will testify like u.

1 Like

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by flashyoba231(m): 2:20pm On Nov 10, 2018
Lol
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by ollah2: 7:49pm On Nov 15, 2018
ololade91:
undecided undecided


You decided not to reply my pm nor send one. Haba Lola!
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by maiunguwar: 10:50pm On Nov 15, 2018
soja wey go war come back na him be brave soja,the one wey die na unknown soja
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by KayceeBanks: 4:01pm On Nov 18, 2018
Na condition wey make Crayfish bend

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply)

Sanu Nku Jamaa [Hausa-speaking thread] / 'I Got Three Wives Through Flogging' - Fulani Man (photos) / Big Python Saved In My Village(pics)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 39
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.