Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,488 members, 7,812,512 topics. Date: Monday, 29 April 2024 at 02:35 PM

Proverbs From The Streets Of Warri - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Proverbs From The Streets Of Warri (43852 Views)

Some Interesting Nigerian Proverbs With Pictures / Masquerade Unmasks Himself, Pleads For Money On The Streets Of Owerri / Lovely New Look Of Hope, Boy Said To Be A Witch & Left To Die On Streets Of Eket (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (Reply) (Go Down)

Proverbs From The Streets Of Warri by Rapmoney(m): 11:19am On Dec 21, 2019
Make una use am dey spice una weekend. Na straight from the streets of Warri...053, area!!!

Dem nor dey tell small pikin make e nor grow big teeth but na to still grow big lips to take cover dem.

Man wey nor get money to buy drink for beer parlour dey quick contribute for other people matter.

Man wey dem give change over for shop no dey waka small small dey go house.

Pikin wey say na agbada em want take start guy go talk wetin e go wear when em old.

Snake wey say na tortoise back e wan bite get enough money to see dentist.

No matter how yansh make yanga reach, legs go still first am enter house.

Olosho die, private part rest.

The food nor sweet, the food nor sweet, nor be for Ukwuani weed.

Na say goat know say the waka waka for life plenty make am wear em own shoes come earth.

If money nor reach to take marry dem go use am play love.

Say blind man no fit see the sun no come mean say the sun no dey exist.

Dem say beauty is in the eyes of the beholder no mean say we go toast babe wey resemble monkey wey lick lime.

Na man wey no get power dey run go house go pull shirt when dem find em trouble for field.

Na too much groundnut oil make puff-puff shine pass buns.

Small pikin wey dey ask e papa every time why e no build house, e go soon reach em turn.

Feel free to add yours.

95 Likes 15 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Balaxx: 11:26am On Dec 21, 2019
Goat wen get mind follow lion go for fishing,weda Dem catch fish or not lion must chop grin

177 Likes 11 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Kestolove(m): 11:29am On Dec 21, 2019
All dry, very very dry

42 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Balaxx: 11:31am On Dec 21, 2019
Kestolove:
All dry
wet am nah

154 Likes 3 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Rapmoney(m): 11:33am On Dec 21, 2019
Kestolove:
All dry
OK. You can now swerve!!!

19 Likes 1 Share

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Rapmoney(m): 11:36am On Dec 21, 2019
Balaxx:
Goat wen get mind follow lion go for fishing,weda Dem catch fish or not lion must chop grin
My brother, na so e be.

17 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Davash222(m): 12:12pm On Dec 21, 2019
Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep for night.

179 Likes 4 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by paulsibility(m): 3:00pm On Dec 21, 2019
Person wey mad man kill him mama. If he see mechanic na run, e go dey run.

81 Likes 3 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Sweetheart666(f): 3:03pm On Dec 21, 2019
Lean on me,lean on me no mean say make u come press me die..
Na person wey better hungry never beat dey fine scissors wey he won use cut indomie Maggi.

123 Likes 4 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by ForeThinker: 3:55pm On Dec 21, 2019
Naxxxo

2 Likes 3 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by ImmaculateJOE(m): 3:56pm On Dec 21, 2019
Kpekus wey dem don fu*k no fit be unfu*ked.

14 Likes 2 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by osamz007: 3:56pm On Dec 21, 2019
Erigga influence

"Na feel at home dey make visitor spoil remote"
"Station wagon no be G wagon"
"Pursue money like say na pikin I wan beat"

102 Likes 5 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by jerrybakermillz(m): 3:56pm On Dec 21, 2019
Hmmm..
pikin wey say e head big pass e papa own na headache go kill am finally

Comot for my house no mean say comot for the world

Man wey job ashawo no dey like waka alone for night pass bothel

Pikin wey too like fry fish go put e mama for wahala inside market one day

Monkey wey dem buy for play if e too jump na inside pot e career dey end last last

Blockus wey say e too big na deep hole go humble last last

Man wey say zobo too sweet no get money to buy juices or coke

Man wey over dress go party go struggle for take away food wey e go carry go house

Chairman wey no dey do well na community cane go make am loyal

Mama wey dey look pikin smile for occasion dey reason the time wey e go take wake d pikin up for night with cane

Area we full ground ......finally kulikuli no be chocolate

84 Likes 3 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Nobody: 3:56pm On Dec 21, 2019
Akwuna die pussy rest

11 Likes 1 Share

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by ClintonNzedimma(m): 3:56pm On Dec 21, 2019
Real Warri matters

24 Likes 1 Share

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Nobody: 3:57pm On Dec 21, 2019
You sabi traffic rules no mean say you go follow Army drag road

Vanity upon vanity but na you dey first gateman reach office, na so you fear poverty??

33 Likes 1 Share

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Kestolove(m): 3:57pm On Dec 21, 2019
Sweetheart666:
Lean on me,lean on me no mean say make u come press me die..
as in press ur breazt abi wetin?

5 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Dozie32(m): 3:57pm On Dec 21, 2019
Warri!! Their fada!!!

5 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Nobody: 3:58pm On Dec 21, 2019
Sincerely, dem new to me o.

Warri guys, dem no dey make person hear words inside Hall for NYSC Camp. Dem go dey shout Warri,,,,Warri,,,,Warri,,,,, and their comedies dry pass deserttongue
Midjulss:
Who no Bleep toto no be human being
Which kind parable be this one

38 Likes 1 Share

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by ABCthingx: 3:58pm On Dec 21, 2019
Space bookers Everywhere.
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by CasNova: 3:59pm On Dec 21, 2019
Funny but instructive.

3 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by OMNIVIRUS(m): 3:59pm On Dec 21, 2019
Anybody wet talk say make your water no go boil, em own no go hot!

14 Likes 1 Share

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Malawian(m): 4:00pm On Dec 21, 2019
Na who never see problem dey use english pray grin grin

91 Likes 5 Shares

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Goldenheart(m): 4:01pm On Dec 21, 2019
grin
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Blitz888(m): 4:01pm On Dec 21, 2019
Eye wey dey cry still dey see.

10 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by KingGBsky(m): 4:01pm On Dec 21, 2019
Balaxx:
Goat wen get mind follow lion go for fishing,weda Dem catch fish or not lion must chop grin

Oh men I love this one

13 Likes 1 Share

(1) (2) (3) (4) (Reply)

Historical Pix; Picture Of Christmas Celebration In Badagry, 1923 / How Adamawa Governor Sat In Atiku's House (Photo) / How I Will Rule My Kingdom — 17 Yr Old Delta King

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 24
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.