Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,226 members, 7,829,380 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 05:47 AM

Messi And Kaka- Post World Cup Conversation - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Messi And Kaka- Post World Cup Conversation (886 Views)

Messi And Kaka Chat After World Cup / Messi Vs Kaka / Another Kaka And Messi Post Worldcup Conversation (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Messi And Kaka- Post World Cup Conversation by akonamone(m): 4:31pm On Jul 14, 2010
Messi: Bros how far na?

KAKA: I dey o

Messi: e get as this world cup take be o

KAKA: walahi I no know

Messi: una own better, guy na 4-0 dem flog us, I no score goal, me wey be world footballer

KAKA: Guy dem tear me red card, I never collect red before for my life. No be only u no score, Rooney nko?, even Torres

Messi: una lucky say no be Germany una meet. I no even see road dribble, when Gerrard tell me I think say na lie,

KAKA: eh ya. Pele, but dat 4-0 too much o. We laff for bus tire as we dey go airport. E sweet us die

MESSI: make una dress. Una wey no fit head ball?

KAKA: make e be, but dem no disgrace us. Last last Holland no win cup

MESSI: Germany no win too na. Chei, Iniesta no go let person hear word oh

KAKA: hehe, na una for Barca go suffer am na. Nobody go fit talk for our side as Raul no go World Cup. Who open mouth, im head go roll

MESSI: shey! no shaking sha, we go chat later. Me wan log out go play choosing for area so. Heinze dey here sef. E say make I hail u. E dey vex say dem nor choose am for area.

KAKA: make e gerrat, im too rough sef. Hail am sha. E go be. Make I enter church. Dis Mourinho, me no know whether I dey im plan. I dey fasting programme. Later

Messi: ok!
Re: Messi And Kaka- Post World Cup Conversation by jokingmary(m): 6:35pm On Jul 14, 2010
:d ;d
Re: Messi And Kaka- Post World Cup Conversation by rahd: 1:50am On Jul 15, 2010
NiceĀ  grin

(1) (Reply)

The Elevator / What Makes A Man Sick / Guys: Bunmioguns Or Booqee? Choose One:

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.