Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,755 members, 7,831,427 topics. Date: Friday, 17 May 2024 at 06:34 PM

Messi Vs Kaka - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Messi Vs Kaka (1106 Views)

Kaka Biography And Lifestyle. / Cristiano Ronaldo Vs Ronaldinho Vs Kaka Vs Thierry Henry, Who Is Better? / Did Kaka Truly Deserve A Red Card? (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Messi Vs Kaka by mafioso2(m): 10:52am On Jul 16, 2010
Messi: Bros how far na
KAKA: I dey o
Messi: e get as this world cup take be o
KAKA: walahi I no know,
Messi: una own better, Guy na 4-0 dem flog us ,I no score goal,me wey be world footballer
KAKA: Guy dem tear me Red card,I never collect Red before for my life. No be only u no Score,Rooney nko,even Torres.
Messi: Una lucky say no be Germany una meet. I no even see road dribble, when Gerrard tell me I think say na lie,
KAKA: Eh ya. Kpele. But dat 4-0 too much o. We laff for bus tire as we dey go airport. E sweet us die.
MESSI: make una dress. Una wey no fit head ball?
KAKA:make e be, but dem no disgrace us. last last Holland nor win cup
MESSI: Germany nor win too na. Chei, iniesta nor go let person hear word oh
KAKA: hehe,na una for barca go suffer am na. no be me
Messi: How u dey reason This season?
KAKA: Oboy no think am ooh Morhino don dey with us ooh
Messi: Shey na him go play the ball abi?
KAKA: Guy guy, Na later abeg i dey busy here
Messi: Later Bros, I greet u
Re: Messi Vs Kaka by Okijajuju1(m): 11:11am On Jul 16, 2010
Messi: Bros show first, which kind ball wey this africa peeple give us so??
Kaka: My brother, the matter tire me o!!
Messi: I think say I for kill person, that Naija boy wetin be that ehn name sef!!
Kaka: Veencent
Messi: Na him, ehn no just gree. Na so my bad luck just continue.
Kaka: Chey Ya!! Me the ball no give me mouth talk.
Messi: Even Cristi for portugal sef score, a whole me, world number 1, I no even see post knack talkless of score.
Kaka: Wetin pain me pass be say upon the dance wey I practice wey I go use gyrate my goal, instead na red card I see.
Messi: Sorry O!!
Kaka: Small thing, I vex no be small. If to say dem no hold me, I wan beat kaita plus referee join.
Messi: Easy O!! You sef thank God your own no too bad like that. You see that Naija boy wey miss goal for front of post!!
Kaka: Maicon just send am go my facebook, come tag Argentina, france and Italy.
Messi: I hear say Ehn country don deny am visa to return house.
Kaka: Anytime wey I reason ehn matter I go just laugh.
Messi: Guy later abeg, Drogba just upload the video of the miss, wait make I tag you.
Re: Messi Vs Kaka by mafioso2(m): 5:51pm On Jul 16, 2010
Messi: I just Tag you for my Facebook now check am out
kaka: LWKMD, Dem Suppose Ban this guy for life ooh
Messi: Say wetin happen?, no be him life
kaka: Nai all of una go take wey make them lash una 4-0 so
Messi: I no blame you, Na Uncle Maradonald i blame Pele no dey dope?
Kaka: But him no dey full himself like this na
Messi: brb pls,
Kaka: ok, i be wan even signout so my time don almost dey finish
Messi: Poor U
Kaka has signed out. (17/07/2010 00:53)

(1) (Reply)

F1 2012: Rules And Regulations Changes, And What They Mean / We Played Brazil Not Nigeria - Samassa (mali Goal Keeper) / First 31 Games Of David Moyes Vs Sir Alex Faguson

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.