Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,367 members, 7,829,938 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 01:57 PM

Proverbs From The Streets Of Warri - Culture (3) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Proverbs From The Streets Of Warri (44020 Views)

Some Interesting Nigerian Proverbs With Pictures / Masquerade Unmasks Himself, Pleads For Money On The Streets Of Owerri / Lovely New Look Of Hope, Boy Said To Be A Witch & Left To Die On Streets Of Eket (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (Reply) (Go Down)

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by bigiyaro(m): 5:34pm On Dec 21, 2019
nyash nor get teet but e dey cut shit.

1 Like

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Ejjis(m): 5:34pm On Dec 21, 2019
MAKE ASK UNA QUESTION....NA ONLY WARRI DEY SPEAK PIGIN ENGLISH FOR NAIJA

Goat wey plenty people get na hungry dey kill am...

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Funpeter: 5:39pm On Dec 21, 2019
Na has goat stand for market them dey price am

2 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Legendguru: 5:48pm On Dec 21, 2019
hmm
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by oluwaahmed: 5:49pm On Dec 21, 2019
Dem no dey use ginger kill mosquito wey hang for blockos.

1 Like

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Felalucky8(m): 5:59pm On Dec 21, 2019
Anywhere belle face na front
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Engrtimuche(m): 6:22pm On Dec 21, 2019
you wan suck breast na him you no get teeth
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Equity15(m): 6:31pm On Dec 21, 2019
1. because goat na your friend no mean say e no go chop your yam.(bestie)
2. na fence wey fall nai him make Goat climb ontop take selfie.
3. if dog bite you once, the dog dey mad. if the dog bite you twice, you dey mad.
4. lion wey no know book, na monkey he dey ask answer for exam hall.
5. say person die for accident no mean say we no go drive motor again.
6. say music go end no mean say we no go play am(love).
7. fire wey burn goat bear bear, na him face be the target.
8. person wey get plenty choice, na the same with person wey no get choice.
them plenty jawe...next time

3 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by noziz(m): 6:31pm On Dec 21, 2019
Wetin man sew na him e dey wear!
No be who read pass dey get first class
Ur belle big no mean sey u dey enjoy
U belleful today no mean sey u no go hungry tomorrow.

2 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by nabegibeg: 6:33pm On Dec 21, 2019
Rapmoney:
Make una use am dey spice una weekend. Na straight from the streets of Warri...053, area!!!

Dem nor dey tell small pikin make e nor grow big teeth but na to still grow big lips to take cover dem.

Man wey nor get money to buy drink for beer parlour dey quick contribute for other people matter.

Man wey dem give change over for shop no dey waka small small dey go house.

Pikin wey say na agbada em want take start guy go talk wetin e go wear when em old.

Snake wey say na tortoise back e wan bite get enough money to see dentist.

No matter how yansh make yanga reach, legs go still first am enter house.

Olosho die, private part rest.

The food nor sweet, the food nor sweet, nor be for Ukwuani weed.

Na say goat know say the waka waka for life plenty make am wear em own shoes come earth.

If money nor reach to take marry dem go use am play love.

Say blind man no fit see the sun no come mean say the sun no dey exist.

Dem say beauty is in the eyes of the beholder no mean say we go toast babe wey resemble monkey wey lick lime.

Na man wey no get power dey run go house go pull shirt when dem find em trouble for field.

Na too much groundnut oil make puff-puff shine pass buns.

Small pikin wey dey ask e papa every time why e no build house, e go soon reach em turn.

Feel free to add yours.

E dey clear pimples, e dey clear pimples na so bleaching take start grin

2 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by nabegibeg: 6:34pm On Dec 21, 2019
noziz:
Wetin man sew na him e dey wear!
No be who read pass dey get first class
Ur belle big no mean sey u dey enjoy
U belleful today no mean sey u no go hungry tomorrow.

Who dey hold landlord rentage no dey fry stew wey curry dey.

1 Like

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by nabegibeg: 6:38pm On Dec 21, 2019
Forget Trust grin If trust dey, Water nor for boil Fish.
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by BankyGee(m): 7:01pm On Dec 21, 2019
Monkey smart, monkey smart. Na because tree near tree grin
Toto water no plenty but e reach prick take baff undecided
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Mcuzy(m): 7:02pm On Dec 21, 2019
blackfish56:
E nr dae e nr dae Who naked nor dae put hand 4 pocket
na so he Just be

1 Like

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Edojoma(m): 7:06pm On Dec 21, 2019
Village when e b say d only barber na lion make all d goats ready train afro......

Leg wen swell up nor b rainboot

Okpolor nor b open eye

The way jealousy dey mostly come na I'm happy for u na dem b DAT oo run
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Edojoma(m): 7:11pm On Dec 21, 2019
blackfish56:
E nr dae e nr dae
Who naked nor dae put hand 4 pocket


Na pocket wen money nor dey hand dey stay inside tey pass
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Sorrento: 7:11pm On Dec 21, 2019
tonbratom:
Pikin wey dem carry for back say e match bottle..

Person wey never start business say gain wun kill am.

Ashawo mama die, in-law nur dey.

Na cooperation dey make rice full pot.

Rice wey dey buttom of cooler today go dey on top tomorrow.
That ur second 2 d last no be here oo.nawao

Toto water small normally, but prick must baff belleful.

Na i go do am later nai make fowl nur fly like other birds.
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Edojoma(m): 7:12pm On Dec 21, 2019
Equity15:
1. because goat na your friend no mean say e no go chop your yam.(bestie)
2. na fence wey fall nai him make Goat climb ontop take selfie.
3. if dog bite you once, the dog dey mad. if the dog bite you twice, you dey mad.
4. lion wey no know book, na monkey he dey ask answer for exam hall.
5. say person die for accident no mean say we no go drive motor again.
6. say music go end no mean say we no go play am(love).
7. fire wey burn goat bear bear, na him face be the target.
8. person wey get plenty choice, na the same with person wey no get choice.
them plenty jawe...next time



Who don faint b4 nor b stranger to death
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by chocboi78(m): 7:14pm On Dec 21, 2019
Pikin way follow Im papa drag bald hair,na headache go kill am
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Edojoma(m): 7:14pm On Dec 21, 2019
oluwaahmed:
Dem no dey use ginger kill mosquito wey hang for blockos.

Nor b by power dem take dey stand preek

2 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by OKorowanta: 7:26pm On Dec 21, 2019
Area!
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Ikembasunda1(m): 7:39pm On Dec 21, 2019
Person wey hit hand for chest saying e no go better for us go die of chest pain.
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Christaks(m): 7:47pm On Dec 21, 2019
Sweetheart666:
Lean on me,lean on me no mean say make u come press me die..
Na person wey better hungry never beat dey fine scissors wey he won use cut indomie Maggi.

Dis is better than what the OP wrote..
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Sureman707: 7:49pm On Dec 21, 2019
I love this one,.,..,

Dem say beauty is in the eyes of the beholder no mean say we go toast babe wey resemble monkey wey lick lime

1 Like

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Ericharlse: 8:03pm On Dec 21, 2019
Person we use elephant set trap na only am sabi wetin em wan catch.

1 Like

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by nairaman66(m): 8:07pm On Dec 21, 2019
SIR0:
Sincerely, dem new to me o.

Warri guys, dem no dey make person hear words inside Hall for NYSC Camp. Dem go dey shout Warri,,,,Warri,,,,Warri,,,,, and their comedies dry pass desert:PWhich kind parable be this one

Warri guys, dem no dey make person hear words inside Hall for NYSC Camp. Dem go dey shout Warri,,,,Warri,,,,Warri,,,,, and their comedies dry pass desert

Those guys are not from Warri!

3 Likes

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by gibsonwales(m): 8:12pm On Dec 21, 2019
Dem no deh use BLOKOSS (scrotum/epon) test cutlass medicine ��

1 Like

Re: Proverbs From The Streets Of Warri by Okugbe1(m): 8:34pm On Dec 21, 2019
Some small small piking wey no know sabi say p**sy na money and source of wealth nah e dey share am any how for people wey no value am
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by tck2000(m): 8:44pm On Dec 21, 2019
paulsibility:
Person wey mad man kill him mama. If he see mechanic na run, e go dey run.
Lol
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by tck2000(m): 8:45pm On Dec 21, 2019
Sweetheart666:
Lean on me,lean on me no mean say make u come press me die..
Na person wey better hungry never beat dey fine scissors wey he won use cut indomie Maggi.
lol
Re: Proverbs From The Streets Of Warri by PlaysNigeria: 8:53pm On Dec 21, 2019
Pikin wey say hin mama no go sleep, him seff no go rest.

Dem say Monkey no fine, but him mama like am.

(1) (2) (3) (4) (Reply)

Meet The Contenders To The Ooni Stool; How The New Ooni Will Emerge / Daughter Of The Ooni Of Ife, Princess Adeola Ogunwusi / Olu Of Warri's Crown Stolen, Police Declares Two Princes Wanted

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 31
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.