Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,583 members, 7,837,199 topics. Date: Wednesday, 22 May 2024 at 06:44 PM

Longer Throat No Go Kill Me (which Kind Wahala Be Dis) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Longer Throat No Go Kill Me (which Kind Wahala Be Dis) (491 Views)

Imagination Wan Kill Me / Fiction: How My Wicked Uncle Tried To Kill Me / Formal Education Is No Longer The Best Legacy (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Longer Throat No Go Kill Me (which Kind Wahala Be Dis) by kingot(m): 5:26pm On Aug 15, 2023
Me: Guy! See wetin I see for twitter just now!! Chicken Republic dey share rice for people wey dey come their branch for Surulere!!
Timothy: Now??
Me: Guy e dey happen as me and you dey talk now!!! See na! *Shows him pictures*...seenylon! See people wey carry food dey waka around!
Timothy: Ahhh!!! Guuuyyy!!! And Surulere far from there!!! We suppose go this thing!! We wey dey hungry for here since day before yesterday night!
Me: *smiles*... This God dey work in mysterious ways
Timothy: Wetin happen?? I dey talk say we no fit go Surulere to choo food, you dey talk God work in mysterious ways...shey God dey work for chicken republic??
Me: *smiles*...where Solomon dey?
Timothy: Which kain stupld question be that one?... Hin go work, wetin happen?
Me: Where he dey work?
Timothy: I know? He tell us?? E never reach one month wey he start the work.
Me: *smiles*... Na chicken republic our guy dey work. Chicken Republic for Surulere.
Timothy: ldlot, na me you wan do this rubbish for. FooI
Me: *laughs*...oya wait. *Dials Solomon's number*... Hello guy, hwfa
Solomon: Hello bro, thank God say you call...abeg come open door for me...our front gate.
Me: Okay..*goes outside and open door for him then he quickly enters with cooler of rice*
Timothy:
Me: When I dey tell you, you think say na joke?
Timothy: Omo!!
Solomon: *Enters kitchen and puts the cooler inside cupboard*...Abeg make una help me hold this food, I go come back for night. *Quickly leaves the house*
Me: *comes out of the kitchen with two spoons and the cooler*.... Oh solo don go??... You believe me now??
Timothy: Omo guuuyyy!! God works in mysterious ways!! *Collects one spoon*
Me: *eats rice*...when I talk am before, you ask me if God don dey work for chicken republic. *Eats another spoon of rice*
Timothy: *takes two spoons of rice at once*... Guy, Solo na Godsent!!! *Cleans tears of joy*
Me: I just like the guy...a true friend....*collect that chicken wing, give me the chest*.
{ Later at night, Solomon returns from work with 4 chicken Republic plates of rice}
Solomon: Take two plates, Timothy...Stevo, take your own two.
Timothy: Ahh!! Omo!! Solo if you do mistake stop this Chicken republic work, me and you fit no talk again for Iife.
Solomon: *laughs at loud*...werey
Me: *pressing phone while trying to open the first plate*... Today just be like birthday for me, see as I dey shed tears of joy dey chop back to back Jollof rice and chicken, spaghetti sef even dey this one...and chicken Republic still dey trend for twitter sef.
Solomon: Na our manager just decide to do am ooo...we happy say we put smiles for people face today.
Me: Omo see wetin dey trend for twitter again..Instablog just post am. "A 23year old girI was caught putting substance inside a rice she bought. After being arrested, she confessed she tried to polson her boyfriend because she found out he was cheatlng on her..the poison wouId have kiIIed the boyfriend in twelve hours according to the hound lady." Guuuyyyy!!!
Timothy: Omo wetin girIs want for this Iife Ahnahn, polson your man cos he dey cheat?? Ahh!!
Me: E weak me bro
Solomon: Funny thing be say, na for our side this nonsense happen o. Na me even catch am when she dey put the stuff after she buy the rice from us. Our manager con talk say make I pour the rice for cooler, carry am go back house, so people no go see the chicken republic plate. Na why I rush come back that afternoon with the food con keep am for cupboard. We wan use am as evidence for court tomorrow. Fear women!!
Me and Timo:

1 Like

Re: Longer Throat No Go Kill Me (which Kind Wahala Be Dis) by kingot(m): 5:29pm On Aug 15, 2023
Abeg aw dem take dey comot poison wey done enter stomach

1 Like

Re: Longer Throat No Go Kill Me (which Kind Wahala Be Dis) by Badmashii(m): 3:01pm On Aug 17, 2023
Omo laff wan kill me... grin grin

Bro don't stop dropping stuff like this abeg. E make sense die
Re: Longer Throat No Go Kill Me (which Kind Wahala Be Dis) by dankorode(m): 7:55pm On Aug 17, 2023
kingot:
Abeg aw dem take dey comot poison wey done enter stomach
for where!? make u na wait for twelve hours abeg
Re: Longer Throat No Go Kill Me (which Kind Wahala Be Dis) by kingot(m): 2:04pm On Aug 19, 2023
Badmashii:
Omo laff wan kill me... grin grin
Bro don't stop dropping stuff like this abeg. E make sense die
no wahala just dropped a topic check it out
Re: Longer Throat No Go Kill Me (which Kind Wahala Be Dis) by Blueace247(f): 10:09pm On Aug 20, 2023
Engaging!!

(1) (Reply)

A Positive Outlook To Life / Beware Of Nigerian Love / The More, The Merrier

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 18
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.