Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,162,527 members, 7,850,795 topics. Date: Wednesday, 05 June 2024 at 09:14 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Jobs/Vacancies / Npower Batch C 2020 - How To Apply. (1012311 Views)
Npower Batch C 2020 Registration Updates For Graduates And Non Graduates (2) (3) (4)
(1) (2) (3) ... (301) (302) (303) (304) (305) (306) (307) ... (513) (Go Down)
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by giftygirl1(f): 1:51pm On Mar 09, 2022 |
FuckloveJnr:You're not even sounding like Fucklove I like the Indabosky Fucklove. Abeg make nobody quote me o,my head de pain me. 2 Likes |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by FuckloveJnr: 2:32pm On Mar 09, 2022 |
giftygirl1:if I dey use Street language relate, dem go think say I use my school fees chop puff puff. I wan tell them say I dey show woto Woto anyhow dem want am. But you sef na case. As I dey fight the battle of survival with that pastor, you no fit show me support, you no fit tell me say Fucklove carry on, I dey your back, you just dey for Oza room dey play luvyy luvyy with hubby, dey laugh and scroll nairaland how I dey dodge and throw missiles. Na now I know people wey like me, gifty your love na for mouth, no be true love walahi 2 Likes |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by FuckloveJnr: 2:33pm On Mar 09, 2022 |
I no fit fall in love again, na why I dey answer Fucklove 1 Like |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by FuckloveJnr: 2:34pm On Mar 09, 2022 |
The mumu moderators don unban my account, Junior go rest now make I login with senior 1 Like |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Fucklove(m): 2:35pm On Mar 09, 2022 |
Una good afternoon. I say make I pass this ghetto |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by shalomm: 3:00pm On Mar 09, 2022 |
Hi all, any update on January stipend? 2 Likes |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by peekay007: 4:42pm On Mar 09, 2022 |
Why them no go ban u,weah u come dey speak english like say the queen of england na ur aunty.......,yeye pikin....,i go call pastor 4 u now...... Fucklove: |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Fucklove(m): 4:59pm On Mar 09, 2022 |
peekay007:I don nearly scatter my phone as I wan headbutt you from my screen. You be green snake for green grass walahi. I dey suspect say that pastor na your uncle true true, the way you dey gum body for am 1 Like |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Fucklove(m): 5:01pm On Mar 09, 2022 |
shalomm:Na people wey get issues dem dey pay now. People wey their payment fail, them dey pay them now. But you sef na serious case, na when money finish you go begin search for update, if money land you go disappear like ghost. Una way no pure walahi 1 Like 1 Share |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by peekay007: 5:38pm On Mar 09, 2022 |
Hahahaha,no mention snake o....,lala no want take ear hear snake matter........u know wen otondo first enta camp,body go dey shark am....... e go want do every parade,na watin dey do pastor. Fucklove: |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Ekehwinz: 6:06pm On Mar 09, 2022 |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Fucklove(m): 6:28pm On Mar 09, 2022 |
Ekehwinz:Settlement kee their papa there. Na my own share of the world Bank Corona support wey naija government turn to loan I collect. Like this, I dey reason with my company make I dey recieve salary for hand before this people go do me shege 1 Like |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Fucklove(m): 6:29pm On Mar 09, 2022 |
peekay007:You be comrade with wisdom and understanding. You Sabi as the thing be true true 1 Like |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Ekehwinz: 7:09pm On Mar 09, 2022 |
Fucklove: I just hope dem no go tamper with person money for account |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Mayomat: 7:39pm On Mar 09, 2022 |
[quote author=waze63 post=110411077] I haven't been paid and when I checked my dashboard I saw a message "transfer not successfull" Pls what should I do? The same happened to me pls help us... Which step to take? |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Abdul4trust1(m): 8:20pm On Mar 09, 2022 |
Benyz:my brother score 75 he has not be selected. I know someone who score 50 and he was selected. Is there hope my brother can still be selected? |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by ibnlawal(m): 8:25pm On Mar 09, 2022 |
Abdul4trust1:Some even got shortlisted today, the person should check his portal. And of course there's hope |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Alamkir: 8:39pm On Mar 09, 2022 |
Fucklove: Lol..... Dem plenty wey dey do dat one..... Finally.... I dey smell stipend around d conner. After those newcomers bring woto woto come spoil the thread 1 Like |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by waze63(m): 9:08pm On Mar 09, 2022 |
[quote author=Mayomat post=110894308][/quote]bụ I called their customer service and explained to the lady that attended to me and she told me they tre working on resolving it. That lots of people were having the same issue 1 Like |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Abdul4trust1(m): 10:03pm On Mar 09, 2022 |
ibnlawal:okay, thank you |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by PastorFire: 10:13pm On Mar 09, 2022 |
FuckloveJnr:Yanga dey sleep, trouble won wake am |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by jamze: 11:52pm On Mar 09, 2022 |
Pastor is back, expect 2nd war |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Uniquisite: 9:02am On Mar 10, 2022 |
Pastor Fire = Fucklove |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by dwag: 11:27am On Mar 10, 2022 |
jamze:Russia vs ukraine WW2.......lolz |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by shalomm: 2:44pm On Mar 10, 2022 |
Fucklove: Bro, seems you have a problem right? |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Fucklove(m): 3:02pm On Mar 10, 2022 |
shalomm:You're very stupid for such a useless question. You want to start another round of distractions? |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by peekay007: 3:07pm On Mar 10, 2022 |
calm down na JJC, him nor know road Fucklove: |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by shalomm: 3:28pm On Mar 10, 2022 |
Fucklove:Take your frustration somewhere. Good day.
|
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by uthlaw: 4:05pm On Mar 10, 2022 |
shalomm:is there any big deal in what you post,you bring 2017 post of someone seeking for help,e be like say you de Jon's! 3 Likes 1 Share |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Fucklove(m): 4:29pm On Mar 10, 2022 |
shalomm:Shallow mind. Is that how low you can go? Post of 2017, when I was down and decided to seek help. Is that all you have against me? Useless thing 2 Likes |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by Fucklove(m): 4:30pm On Mar 10, 2022 |
uthlaw:As in eh. Post of 2017, I didn't even delete or hide it. From 2017 to 2022 is how many years for heavens sake? 2 Likes 1 Share |
Re: Npower Batch C 2020 - How To Apply. by jamze: 4:46pm On Mar 10, 2022 |
This thread funny oo dis guy don really offend ppl oo, See as Dem go dig person past like archaeologist... Now Pastor will see another avenue to fire.... |
(1) (2) (3) ... (301) (302) (303) (304) (305) (306) (307) ... (513)
List Of Fake Employment Companies. Stay Off Them. / NSCDC Recruitment 2019: How To Apply For Nigeria Civil Defence Corps / 2013 Nigeria Liquified Natural Gas (NLNG) Graduate Trainee
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 43 |